Skip to content
Thursday 10 September 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Iran war don bring new sense come our garage

The FrontierThe FrontierMay 2, 2026 1223 Minutes read0

Replay

If dis our Naija no kill man pikin, man pikin go kill Naija.

Everyting don turn upside down for our contry. Light no dey as national grid dey collapse per second, per second. Money no dey, food no dey. And di one wey worry me pass now na petrol. To buy petrol now na like gold.

Today, dem go say Dangote don reduce petrol price, tomorrow dem go say Dangote don increase petrol price.

And now, dem don kukuma put di hole petrol matter for Iran war head. Dem say na Strait of Hormuz or wetin dem call am sef, no allow petrol reach Naija again. See me, see troublem o, wetin concern Iran and America with Naija?

And without petrol, na im be say we taxi driver no get work again be dat. Shey, na pure water we go dey use drive our taxi?

Everyday, na so we go siddon for our garage wey dey near Ikeja Under Bridge, from morning till night, no passenger go show face. People no get money to enter taxi again. Tori Olorun!

Na so I siddon yesterday for garage dey tink ti-ti-ti-ti. 12 O’clock pm in di afternoon don nack, no passenger. 1 O’clock, 2 O’clock, di same ting. Kilode?

I talk am for my mind say, if I close for evening begin go our house for Abule Egba, wetin my family go chop? And na weekend we dey.

Na im I quick, quick, use my head do arithmetic. I enter my guonguoro, drive am go di order side of di under bridge wey danfo dem dey load passenger go Maryland. Na so I stop, come out, open all my door down. Agbero dem for bus stop come dey hail me, “Oga MAT wetin happen o! Why you comot for taxi park come join danfo dem for bus stop? Twale!!!”

I ask dem weda dem no see as Naija be now. I say passenger dem no dey near our garage again from morning till night. I tell di agbero dem to begin load my guonguoro, di same money wey danfo dey collect to Maryland. I give di four both of dem N1000.

Before I open eye sef, my guonguoro don full – two passenger for front, five for backseat. Dem even ask weda make dem put passenger for inside boot or on top of my guonguoro roof. Olorun Oba o!

I don carry my passenger dem dey go be dat.

One passenger drop for Police College, one drop for Ikeja Country Club junction, two drop for Abule bus stop, one drop for Leventis. And as dem dey drop, na so I dey carry anoder passenger, like danfo.

Everybody come down for Maryland. Na so I turn my guonguoro face Ikeja, begin call passenger dem again.

My broda, as I reach our garage, my pocket don full. I jus use style begin go Madam Shine buka to take My Usual before I go house.

Man pikin no go come peme for dis Naija becos of petrol say or petrol no say. Iran war don bring new sense. Cunny man peme, cunny man bury am.

I know say if I tell our union member dem dis new sense, all of dem go begin dey do di same ting. But no be now I go tell dem, make dem no takeover di new sense from me.

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
Iran warnew senseour garage
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: AMEN, by Asake
next post ROMANCE GONE SOUR: My husband married a woman much older than him, threw me and our children out
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

REVEALED: Why my mother never saw me perform on stage before her death – Music star Mr. Eazi

September 5, 20260
Gists

BBNaija star Tacha breaks silence after arrest over alleged N5 million fraud

September 5, 20260
Matilda Showbiz

I don tire, I dey go back to my village

September 5, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Sports

EPL: Premier League releases 2026/27 Yuletide fixtures

September 10, 20260
Crime

TERRORISM: US delivers fresh military equipment to Nigeria

September 10, 20260
Crime

Man cuts off own finger over N80 million occultic deal

September 10, 20260
Business & Economy

Group queries Nigeria’s reported 4.43% GDP growth amid deep economic failures

September 10, 20260
Crime

Family demands fresh investigation into death of final-year nursing student

September 10, 20260
Health

North-West governors to shut down unlicensed private health schools

September 10, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

EPL: Premier League releases 2026/27 Yuletide fixtures

September 10, 2026

TERRORISM: US delivers fresh military equipment to Nigeria

September 10, 2026

Man cuts off own finger over N80 million occultic deal

September 10, 2026

Group queries Nigeria’s reported 4.43% GDP growth amid deep economic failures

September 10, 2026

Family demands fresh investigation into death of final-year nursing student

September 10, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

EPL: Premier League releases 2026/27 Yuletide fixtures

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Lagos international airport terminal fire may affect aviation reforms – Board chairman, Ganduje

February 26, 2026
3

Japa: Step-by-step guide on how to get Russian work visa

November 26, 2024
4

State of emergency: Tinubu has worsened Rivers scenario – Activist Nnimmo Bassey

March 18, 2025
5

Gov Soludo reconciles with Obi of Onitsha, reinstates suspended monarch

January 24, 2024
6

Afenifere raises the alarm over ‘worst security crisis since independence’

November 23, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Ebola deaths hit 100 in Congo amid armed groups violence

June 9, 2026
3

Hunger protest: Former military officers, ex-envoys worry as Nigerian protesters wave Russian flag

August 4, 2024
4

Angry pastor rebukes members over ‘small’ donations

March 7, 2026
5

Akwa Ibom budget: Governor Eno allocates lion share to infrastructure

November 27, 2024
6

Russia, Ukraine exchange 84 prisoners each

August 15, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

CBN appoints 16 new directors in major leadership overhaul •FULL LIST

March 5, 2025

Trump appoints Bill McGinley as White House counsel

November 13, 2024

ADC presidential primary: Former Vice President Atiku takes early lead

May 26, 2026

Ondo governorship election a sham – PDP

November 18, 2024
Top posts

Categories

  • News5013
  • Politics4678
  • Crime4484
  • International3107
  • Sports2510
  • Business & Economy2309
  • Headlines2241
  • Education1397
  • Matilda Showbiz1007
  • Health901
  • Entertainment833
  • Africa595
  • Religion486
  • Environment376
  • Special278
  • Info Tech249
  • Arts & Culture240
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today211
  • Interview188
  • Opinion154
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade133
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends23
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge2

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact