Replay Di kind orisirisi tings wey man pikin dey see for dis our taxi driver work, person no fit talk am finish. Di order day, trailer nearly push me, my guonguoro and my passenger inside Lagos Lagoon. Helep me say Olorun maje! Na so I carry one madam like dat for drop go Balogun market. […]
…(Continued from last week’s episode) Di two Soja dem wey come knock my door carry me go di two truck wey dem bring come. Dem bring 10 jerry can down. Dem say na petrol and na me get am. Na so dem drive comot, begin dey go. I jus tanda for outside dia, everytin come […]
Na only for Naija wey sisi dem don turn to kalokalo. Just tell any Lagos sisi say I like you, you don enter im trap be dat. First, di sisi go tell you say “Honey, I dey hungry, I never chop since morning”. Wen you settle dat one, di next ting na, “Sweetie, my mama […]
Replay Di way dis our Naija be nah, everybody don get sense by force. Since wen Babablu carry price of petrol hang for up, we wey dey do taxi driver work don hear nwi. If na only petrol, e for good small sef, but spare parts nko? Even to service motor na helele. Na im […]
Di way dis our Naija be nah, everybody don get sense by force. Since wen Babablu carry price of petrol hang for up, we wey dey do taxi driver work don hear nwi. If na only petrol, e for good small sef, but spare parts nko? Even to service motor na helele. Na im make […]
…Continued from last Saturday I rush di last bottle of My Usual and Point-and-Kill, den tell Madam Shine make e give me my bill. Madam Shine tell di salesgirl make e give me my bill, I say no, na you Madam Shine, go give me bill, and make e do quick, say time don too […]
Noting wey di son of man no dey see for dis our taxi driver work. Na im make my wife Bose dey talk am say taxi driver work na Ashewo work. And wen e talk like dat, I go tell am, “Go to court”. Na so di two both of us go come laugh. But […]
As tings come be now, na im be say all of us wey dey for Naija no know wia we dey go again. Na so I carry one bobo like dat dis week go drop for Gbagada Estate. As we comot for our garage wey dey near Ikeja under bridge, we no even reach Alausa […]
Shey una still remember di tori wey I nack una two Saturday ago wey I say “Part-time wife wanted. Apply kia kia!”? My broda, I tink say wen I chop finish, I go clean mouth and nobody go know wetin happen. Na im make I no tell una say di tori get part 2. But […]
I no know wetin dis our union chairman, Jimoh, tink say im be sef. Imagine di likeness! Kilode? Since wen me and all our union member dem begin use dat our garage wey dey for Ikeja under bridge, long time ago, every time we wan do election, Jimoh go say na im go be chairman. […]