When I dey grow up for our village for Ogbomoso dat time, na im I hear people dey talk about America Wonder a.k.a. Abracadabra. But as I run comot for my village come Lagos in 1965, becos say Arike Papa wan use African Insurance finish me say na me give im pikin belle, jus becos […]
Yesterday wey be Good Friday, I carry husband and wife for morning go church wey dey inside Omole Estate for Ojodu Berger side. As I jus drop dem, come out for di main road wey I go begin drive go back to our garage wey dey near Ikeja under bridge, two bobo and two sisi […]

