Skip to content
Monday 12 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Keresimasi don come, all Lagos sisi dem don dey show face

The FrontierThe FrontierDecember 9, 2023 5993 Minutes read0

Every year by dis time, na so so Lagos sisi dem man pikin go dey see left, right and center. And all of dem wan make you do Keresimasi for dem.

Even all dose sisi dem wey no dey greet me for our street for Abule Egba, now if dem see me, dem go first smile, den dobale, and begin greet me, “Daddy Bisi, good morning sir. Well don sir. Shey work dey go on fine sir? Happy Keresimasi and merry New Year in advance sir.” Olorun Oba o!

I don tire for all dis kind greeting sef every day. Dis na sisi dem wey no dey look my side rarara before o.

SDP Poster Layout

Di order day, Abosede come, di mobile buka girl wey dey carry Ewa Agoyin for head waka come sell for our garage wey dey near Ikeja under bridge. I tink say na market e come sell, I no know say e come tell me make I no forgot am dis Keresimasi.

Na so Jumoke, wey dey bring Monkeytail come sell for our union member dem like Mutiu, come ask me for di ting wey I go give am dis Keresimasi. Aisha wey dey come sell hot Agbo for our garage, also do di same ting yesterday. I say shiooo! Shey, na me dem born for Keresimasi?

Di one wey shock me pass na yesterday wen I don go drop my passenger for Idumota around 12 O’clock pm in di afternoon, come back say make I rest small for garage, na im one woman waka enter garage.

Wen I look di woman ti-ti-ti-ti, I see say na Madam Shine, di woman wey get di joint wey Sikiratu dey work and wey I dey go take My Usual for evening after work. But since last week wey Sikiratu travel go village for dis odun, I no go dia. Na anoder joint I dey go nack My Usual before I begin go house.

I ask Madam Shine wetin happen wey make am come our garage for di first time. Di woman say e jus say make e come greet me.

Madam Shine begin ask me why e no see me since last week. I tell am say na work. E say na lie. E say na becos Sikiratu travel go see im one-eye mama for village.

E say make I dey come, say as e be say na im get di joint, e go treat me well. E say e go take care of me till January wey Sikiratu go come back.

I ask am wen I come, shebi na me go still pay for everyting I drink and chop, like point-and-kill. E say yes, plus including wetin im sef go drink and chop, like Cowtail peppersoup. Tori Olorun!

See Madam Shine wey dey finish like 6 Shine Shine Bobo, e no go even be am like say e drink anyting o!

I come ask am say, wen I come, wetin im sef go give me. E say we go jus siddon dey nack tori like broda and sister, drink and chop. Dat’s all. I ask am wetin again. E say noting, say e don swear teletele say e no go ever do kini with im customer. But we fit jus siddon togeder dey nack tori, drink and chop, den wen time reach, I go my house go meet my family.

Na dat time I tell Madam Shine say I hear, say I go dey come everyday even as my Siki Babe don travel.

Na so Madam Shine tank me well well, and begin dey go.

I come talk am for my mind say, so dis old cargo don see mumu. Me? Me sef don swear teletele say I no fit be ATM for any woman laye, especially for dis our Emilokan time.

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT is the longest running Pidgin column in Nigerian media, since 1994

Tags
comedonKeresimasiMATOga
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: PRETTY GIRL, by Ice Spice and Rema
next post My wife inspects my private parts because she suspects I’m cheating on her
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gossips

My wife knew I dated actresses, yet didn’t fight them – Yoruba actor Yinka Quadri

October 10, 20260
Gists

Fame hasn’t changed my sense of humour — Nigeria’s songbird Ugoccie

October 10, 20260
Gists

Felabration 2026: Former Femi Kuti backup singer and dancer Emee Freda returns to Shrine with new artistic identity

October 10, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Sports

Man City beat Liverpool 3-0 in first game after guilty verdict, top table

October 12, 20260
Info Tech

Unregulated AI could spark increase in cyberattacks — Bill Gates warns

October 12, 20260
EyeCare with Dr Priscilia Imade

EyeCare with Dr Priscilia Imade: Love your eyes

October 12, 20260
Interview

I feared for my life after police arrested me over WhatsApp post — Varsity lecturer

October 11, 20260
Entertainment

Nollywood actress Regina Daniels celebrates 25th birthday in wheelchair, reveals heart-wrenching story of health challenges •PHOTOS

October 11, 20260
Politics

Presidential Campaign Council: NDC concedes DG position to Obi/Kwankwaso

October 11, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Man City beat Liverpool 3-0 in first game after guilty verdict, top table

October 12, 2026

Unregulated AI could spark increase in cyberattacks — Bill Gates warns

October 12, 2026

EyeCare with Dr Priscilia Imade: Love your eyes

October 12, 2026

I feared for my life after police arrested me over WhatsApp post — Varsity lecturer

October 11, 2026

Nollywood actress Regina Daniels celebrates 25th birthday in wheelchair, reveals heart-wrenching story of health challenges •PHOTOS

October 11, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Man City beat Liverpool 3-0 in first game after guilty verdict, top table

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

SERAP to Tinubu: Order Police to stop threatening Amnesty International

January 14, 2025
3

TRAGEDY: 5 dead, others rescued in River Niger boat mishap

January 7, 2024
4

Governors Sanwo-Olu, Makinde mourn Ondo SSG

January 5, 2025
5

JUST IN: We are heading to Appeal Court – Nnamdi Kanu’s lawyer vows to challenge life sentence

November 20, 2025
6

UK launches dark web portal to recruit foreign spies

September 19, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

HYPREP awards 300 Ogoni indigenes postgraduate scholarships

January 31, 2025
3

Over ₦10 million raised in 4 days to relocate boy who faced Peter Obi’s convoy — Lawyer

April 21, 2025
4

I’m in pains – Ibom Air passenger cries out after release

August 13, 2025
5

Nigeria’s health workers threaten nationwide strike over salary arrears

May 14, 2025
6

Gunmen burn down monarch’s palace in Anambra

January 12, 2024

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

JUST IN: All Nigerian workers union executives to accompany Ajaero to Police interview tomorrow

August 28, 2024

Varsity suspends 200 – 600 level medical students

October 31, 2023

US Embassy begins screening Nigerian students’ social media accounts

July 8, 2025

US-Isreal war: Nigerians in Iran safe, says Envoy

March 6, 2026
Top posts

Categories

  • News5127
  • Politics4833
  • Crime4596
  • International3204
  • Sports2582
  • Business & Economy2367
  • Headlines2280
  • Education1444
  • Matilda Showbiz1047
  • Health936
  • Entertainment878
  • Africa615
  • Religion496
  • Environment395
  • Special279
  • Info Tech260
  • Arts & Culture243
  • Inside Akwa Ibom Today230
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview196
  • Opinion158
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade137
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact