Skip to content
Saturday 27 June 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

You rob my back, I rob your back

The FrontierThe FrontierMarch 22, 2025 2432 Minutes read0

Na only for Naija wey sisi dem don turn to kalokalo. Just tell any Lagos sisi say I like you, you don enter im trap be dat.

First, di sisi go tell you say “Honey, I dey hungry, I never chop since morning”.

Wen you settle dat one, di next ting na, “Sweetie, my mama dey sick for village, I wan send money to am as I no get t/fare”.

After dat one, you go hear, “My love, I wan do my hair”, or “Sugar, I wan buy G-string dross”.

And na so you go spend till your pocket leak finish like person put water for basket. Dat one na introduction. No be say una don do kini yet o, and if you come do kini nko, na im be say you don carry babanla gbese for your head be dat. Tori Olorun!

Yesterday morning, na so I siddon for house, I no go our garage wey dey near Ikeja under bridge, as I no see petrol buy to take do my work. If taxi driver no get petrol, shey na water e go use drive im taxi?

Small time, I dey for inside my parlour see two Soja motor drive enter our compound wey I dey live with my family for Abule Egba. Five Soja wey carry gun jump down, come near and begin ask person for outside, “Na here Oga MAT dey live?” Di person say yes, and point for my door.

I talk am for my mind say my own don finish today. Na so hot piss begin worry me, I nearly piss for inside my shokoto trouser but I manage hold am.

Di next ting be say, two Soja dem come knock for my door. And na only me dey house dat time. My wife Bose and my two woman pikin dem – Bisi and Funke – don go dia church for morning service.

I first tink weda make I run hide for under my bed for inside bedroom, and na so all my body come begin shake like Shakespeare. But I talk am for my mind say one day man must peme, and sometin must kill a man. I use bold face take open front door.

One Soja ask me weda na me be Oga MAT. I say yes, na di name everybody dey call me, but my real name na Olufemi Olukayode Olugbemiro.

Di Soja dem say make I follow dem outside.

(To be continued)

Make we jam again next week.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
I rob your backOga MATYou rob my back
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Suspension of Governor Fubara tarnishes Nigeria’s image – Former President Jonathan
next post Hot Lyrics: TRENCHES LUV, by T.I Blaze
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Popular Ghanaian actor Van Vicker bags First Class Law degree

June 20, 20260
Gists

Mistreated wives will show you ‘shege’ in old age – Veteran actor Chiwetalu Agu warns men

June 20, 20260
Gists

I would be unemployed without music, says Afrobeats singer Ayra Starr

June 20, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Entertainment

Top Nollywood actor joins US Army

June 26, 20260
Politics

Tinubu govt doing everything to ensure I do not contest in 2027 — Peter Obi

June 26, 20260
Crime

Pastor arrested for allegedly flogging teenage girl to death

June 26, 20260
News

Lagos, other cities thrown into darkness as electricity transmission lines explode

June 26, 20260
Politics

Court ruling against NDC registration: Obi/Kwankwaso Movement vows to fight back

June 26, 20260
Headlines

Lagos residents stranded as floods cut off Ajah, Mafoluku, other areas

June 26, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Top Nollywood actor joins US Army

June 26, 2026

Tinubu govt doing everything to ensure I do not contest in 2027 — Peter Obi

June 26, 2026

Pastor arrested for allegedly flogging teenage girl to death

June 26, 2026

Lagos, other cities thrown into darkness as electricity transmission lines explode

June 26, 2026

Court ruling against NDC registration: Obi/Kwankwaso Movement vows to fight back

June 26, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Top Nollywood actor joins US Army

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Again, Trump fined $10,000 for violating gag order

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

State police will lead to chaos – APC chieftain warns

November 26, 2025
3

Spurs stun Man Utd to win Europa League, end 40-year Continental trophy drought

May 22, 2025
4

10th House of Representatives should not be a rubber stamp – Political analyst

October 2, 2025
5

Disquiet in Osun community as crown of monarch jailed in US goes missing

September 6, 2025
6

Perish plans to declare state of emergency in Osun – PDP chieftain warns FG

February 20, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Crisis rocks APC in Edo over LG Council chairmanship position

October 10, 2025
3

DHQ confirms rescue of Kaduna school children

March 24, 2024
4

JUST IN: Explosion kills 5 in Rivers

April 27, 2025
5

ROMANCE GONE SOUR: My husband is a drunkard, deserts me, our children after collecting salary

August 31, 2024
6

Why Burna Boy, Cubana Chief Priest are trending on X in Nigeria

January 4, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Papa, Mama, hold una man-pikin well o!

January 24, 2026

BREAKING: 9 soldiers killed as bomb explosion rocks Borno

January 5, 2026

FG revokes 924 dormant mining licences

April 24, 2024

JAMB don jam JAMB

May 24, 2025
Top posts

Categories

  • News4693
  • Politics4323
  • Crime4102
  • International2848
  • Sports2356
  • Business & Economy2186
  • Headlines2129
  • Education1303
  • Matilda Showbiz929
  • Health828
  • Entertainment768
  • Africa520
  • Religion469
  • Environment334
  • Special267
  • Info Tech230
  • Arts & Culture227
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today185
  • Interview179
  • Opinion150
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade122
  • Advert30
  • Epistles of Anthony Kila19
  • World Cup 202618
  • Trends17
  • Local News5

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact