Di kind orisirisi tings wey man pikin dey see for dis our taxi driver work, person no fit talk am finish. Di order day, trailer nearly push me, my guonguoro and my passenger inside Lagos Lagoon. Helep me say Olorun maje! Na so I carry one madam like dat for drop go Balogun market. We […]
Dis cold wey dey for Naija now get as e be. Di tin carry weight, no be small. Even di cold wey dem dey talk say e dey for Oyibo contry, na small pikin for dis Naija cold wey dey now. I know say na di heavy rain wey dey fall every day katikati and […]
E no good make agbalagba like me wey don marry tipe tipe come begin live alone like bobo wey never marry teletele. Na dat one oyibo dem dey call married bachelor. Tori Olorun! My wife Bose travel go dia village for Ondo since last week. E say e wan go see im Mama, say e […]
Shey una still remember di tori wey I nack una di order day wey I say “Part-time wife wanted. Na urgent”? My broda, I tink say wen I chop finish, I go clean mouth and nobody go know wetin happen. Na im make I no tell una say di tori get part 2. But I […]
Replay As tings come dey now, everybody must take im destiny for im own hand, if no be so, person go jus peme for noting. Say Olorunmaje! Now I don decide say, anyting wey happen, instead make I jus siddon dey tink from morning till night, I go find how I go do make dat […]
Di way dis our Naija be now, everybody don get sense by force. Since wen Emilokan carry price of petrol hang for up, we wey dey do taxi driver work don hear nwi. If na only petrol, e for good small sef, but spare parts nko? Even to service motor na helele. Na im make […]
…Continued from last Saturday episode As my wife Bose, jump comot for bed, go lie down for ground for dat kind cold night, I no come sabi wetin I go do again. And sleep no wan catch me. How sleep go catch me wen my kini still tanda paparapa like Standard Bank and my body […]
Di kind cold wey dey since dis week show face, hmm, if all dis sisi and bobo dem no take time, Naija go reach 2 billion people after nine months. No be sisi and bobo dem alone, even husband and wife dem dey inside. Now, to stand up for bed for morning, put my guonguoro […]
Replay I dey always talk am say, na Funke tear eye pass di two woman pikin dem wey my wife Bose born for me. Di senior sister Bisi na gentle pikin but im sister Funke na inwi. Im gragra two much. Na so Funke begin dey follow one Fulani herdsman like dat wey dey carry […]
Replay Wahala no dey finish for dis our Naija. Tell me, how wahala go finish wen be say, everyday, all dis Lagos sisi dem go dey bring out sometin wey dem go take catch man. Now na for phone e dey happen. Sisi dem go take photo, do video and post for TikTok wey dey […]

