Skip to content
Tuesday 21 July 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

You rob my back, I rob your back

The FrontierThe FrontierMarch 22, 2025 2552 Minutes read0

Na only for Naija wey sisi dem don turn to kalokalo. Just tell any Lagos sisi say I like you, you don enter im trap be dat.

First, di sisi go tell you say “Honey, I dey hungry, I never chop since morning”.

Wen you settle dat one, di next ting na, “Sweetie, my mama dey sick for village, I wan send money to am as I no get t/fare”.

After dat one, you go hear, “My love, I wan do my hair”, or “Sugar, I wan buy G-string dross”.

And na so you go spend till your pocket leak finish like person put water for basket. Dat one na introduction. No be say una don do kini yet o, and if you come do kini nko, na im be say you don carry babanla gbese for your head be dat. Tori Olorun!

Yesterday morning, na so I siddon for house, I no go our garage wey dey near Ikeja under bridge, as I no see petrol buy to take do my work. If taxi driver no get petrol, shey na water e go use drive im taxi?

Small time, I dey for inside my parlour see two Soja motor drive enter our compound wey I dey live with my family for Abule Egba. Five Soja wey carry gun jump down, come near and begin ask person for outside, “Na here Oga MAT dey live?” Di person say yes, and point for my door.

I talk am for my mind say my own don finish today. Na so hot piss begin worry me, I nearly piss for inside my shokoto trouser but I manage hold am.

Di next ting be say, two Soja dem come knock for my door. And na only me dey house dat time. My wife Bose and my two woman pikin dem – Bisi and Funke – don go dia church for morning service.

I first tink weda make I run hide for under my bed for inside bedroom, and na so all my body come begin shake like Shakespeare. But I talk am for my mind say one day man must peme, and sometin must kill a man. I use bold face take open front door.

One Soja ask me weda na me be Oga MAT. I say yes, na di name everybody dey call me, but my real name na Olufemi Olukayode Olugbemiro.

Di Soja dem say make I follow dem outside.

(To be continued)

Make we jam again next week.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
I rob your backOga MATYou rob my back
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Suspension of Governor Fubara tarnishes Nigeria’s image – Former President Jonathan
next post Hot Lyrics: TRENCHES LUV, by T.I Blaze
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

My dream collaboration is with Rihanna – Afrobeats star Davido

July 18, 20260
Gists

Madonna, Cruise lead A-list stars at World Cup final tomorrow

July 18, 20260
Gists

Tems becomes first African female artiste to clinch Diamond single in US

July 18, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Crime

ICPC questions Tinubu’s chief of staff Gbajabiamila over ‘fake’ Presidential Council scandal

July 20, 20260
World Cup 2026

Top 10 youngest players to win the FIFA World Cup

July 20, 20260
Education

Governor Otti pledges to support JAMB top scorer’s education

July 20, 20260
World Cup 2026

Garcia to step down as Belgium coach after World Cup quarter-final run

July 20, 20260
Headlines

Nigerian Army dismisses fake recruitment advert, warns Nigerians against fraudsters

July 20, 20260
International

Mexican drug lord ‘El Mayo’ sentenced to life in prison in New York

July 20, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

ICPC questions Tinubu’s chief of staff Gbajabiamila over ‘fake’ Presidential Council scandal

July 20, 2026

Top 10 youngest players to win the FIFA World Cup

July 20, 2026

Governor Otti pledges to support JAMB top scorer’s education

July 20, 2026

Garcia to step down as Belgium coach after World Cup quarter-final run

July 20, 2026

Nigerian Army dismisses fake recruitment advert, warns Nigerians against fraudsters

July 20, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

ICPC questions Tinubu’s chief of staff Gbajabiamila over ‘fake’ Presidential Council scandal

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Again, Trump fined $10,000 for violating gag order

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Eid-El-Fitri: Sultan declares Friday as first day of Shawwal

March 19, 2026
3

Hoteliers cry out over worsening power supply

April 3, 2024
4

Court grants #EndBadGovernance protesters bail variation of N5 million each

October 7, 2024
5

Turkey arrests 99 suspected Islamic State jihadist group members

August 2, 2024
6

UN urges Burkina Faso junta to reverse political party ban

February 5, 2026
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Nigeria drops to 38th, Argentina maintains top spot in FIFA rankings •FULL LIST

June 20, 2024
3

Canada to impose retaliatory tariffs on US

March 4, 2025
4

Germany’s Merz elected chancellor after surprise setback

May 7, 2025
5

Former President Buhari’s death: Tinubu’s second- term under threat – Analysts

July 20, 2025
6

2027: It will be Tinubu/APC vs Nigerians – Atiku

February 27, 2026

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Nigerians must take back their country – Speakers say at Big Thumb Network parley

May 30, 2025

Man kills grandfather, uncle for money ritual

September 9, 2024

Economic hardship: Lawmakers willing to downsize their salaries if necessary — Deputy Speaker

February 27, 2024

Sallah meat! Sallah meat!! I don tire

June 22, 2024
Top posts

Categories

  • News4785
  • Politics4405
  • Crime4247
  • International2934
  • Sports2372
  • Business & Economy2219
  • Headlines2161
  • Education1332
  • Matilda Showbiz959
  • Health848
  • Entertainment777
  • Africa551
  • Religion471
  • Environment355
  • Special269
  • Info Tech236
  • Arts & Culture233
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today194
  • Interview183
  • Opinion150
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade126
  • World Cup 202691
  • Advert31
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Trends19
  • Local News5

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact