Skip to content
Friday 9 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Bose don give me permit to marry anoda wife

The FrontierThe FrontierFebruary 14, 2026 1452 Minutes read0

Di kind cold wey dey since dis week show face, hmm, if all dis sisi and bobo dem no take time, Naija go reach 2 billion people after nine months.

No be sisi and bobo dem alone, even husband and wife dem dey inside.

Now, to stand up for bed for morning, put my guonguoro for road, na wahala. To baf cold water sef, dat one na no go area. Di kind hot water wey I dey take baf now go even comot feather for fowl body patapata.

SDP Poster Layout

For night, wen I close for our garage, I go branch for Madam Shine buka, take My Usual, plus Point-and-Kill, before I begin go our house wey dey for Abule Egba.

Di cold for night na im even wicked pass morning own. E dey be like say person dey for obodo oyibo, wen be say ordinary Cotonu sef man never cross enter before.

Na so cold nearly finish me for night yesterday wen I reach house. I see say everybody don sleep, cover dia body patapata.

My wife Bose dey for bed inside room. My two woman pikin dem – Bisi and Funke – sleep for parlour as usual.

Na so I jump enter bed. I touch Bose small, I see say e don sleep go. And di kind cold wey hammer me dat night na helele.

Bose face wall, I shift my body near am, na so my kini jus tanda like Standard Bank. Tori Olorun!

I touch Bose again, e no shake body. I talk am for my mind say today na today. I touch am again, Bose move body small. I touch am again, na dat time e ask me wetin dey happen, and na with sleep eye e take ask me o.

I tell my wife say cold dey catch me, say I wan make e cover me. Bose ask me weda na im be blanket. E say if cold dey catch me, make I go find wrapper cover my body. My broda, I weak.

I come shake Bose well well, I tell am say e must cover me, say na im be di only wife wey I get.

Bose tell me say abeg make I no disturb am again, make I let am sleep or e go comot for bed go lie down for ground. Olorun Oba o!

And true true, wen I touch Bose again, na so e jump comot go carry mat, put for ground and lie down.

I talk am for my mind say so, my wife no wan make we do bend-bend sleep again. Okay nah!

(To be continued)

Make we jam again next Saturday.

Tank you,

Tank you very much,

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
BosemarryOga MATpermitwife
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post ROMANCE GONE SOUR: My husband accuses me of infidelity, beats me after hawking goods to feed him, our children
next post My Valentine’s Day gift comes too early, says star actress Destiny Etiko
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Life beyond cameras: Yusuf, Bells and Chimsom reflect on growth, truth and survival in the BBNaija house

October 3, 20260
Gists

How we went into trance while filming — Actress Yetunde Barnabas

October 3, 20260
Gists

Meet Top 10 richest women in the world

October 3, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Education

Meet Nigeria’s overall best school teacher

October 9, 20260
Crime

Kidnapped local govt councillor dies after days in terrorists den

October 9, 20260
Politics

Truck driver borrows N3.5 million online loan to campaign for Tinubu

October 9, 20260
Education

Benue govt shuts schools forcing parents to buy textbooks

October 9, 20260
Crime

Human rights writers urge EFCC to conclude former governors Okowa, Bello investigations

October 9, 20260
Health

Nigeria accounts for 29% of global maternal deaths

October 9, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Meet Nigeria’s overall best school teacher

October 9, 2026

Kidnapped local govt councillor dies after days in terrorists den

October 9, 2026

Truck driver borrows N3.5 million online loan to campaign for Tinubu

October 9, 2026

Benue govt shuts schools forcing parents to buy textbooks

October 9, 2026

Human rights writers urge EFCC to conclude former governors Okowa, Bello investigations

October 9, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Meet Nigeria’s overall best school teacher

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Jnr Pope: US-based film producer slams AGN for suspending Adanma

April 20, 2024
3

Nigeria’s Chiefs of Army Staff who died in office •FULL LIST

November 6, 2024
4

2027: Former justice minister Malami picks Kebbi ADC governorship form

May 10, 2026
5

Alleged humiliation: El-Rufai prepares to fight Tinubu in 2 courts

April 6, 2024
6

EASTER: Defend yourselves – Christian Association of Nigeria tells members

April 4, 2026
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Nigerian migrant who failed UK driving tests kills pensioner in car crash

April 10, 2026
3

Climbing a staircase is not exercise — Expert debunks common fitness myths

March 15, 2026
4

Organised Labour, CSOs join forces with presidential hopeful Gbenga Hashim as Movement for Democratic Renewal takes off

June 10, 2026
5

Rainy season: FRSC issues safety warning to motorists

July 13, 2025
6

Trump defends block on foreign students at Harvard

May 26, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Group condemns flogging of 3-year-old pupil in Enugu, seeks stricter regulation of private schools

October 13, 2025

Obasanjo Library demands ₦3.5 billion damages from EFCC over invasion •Gives 7-day ultimatum

August 14, 2025

Florida struggles to recover as Hurricane Milton brings trail of destruction

October 10, 2024

Lionel Messi signs new Inter Miami contract

October 23, 2025
Top posts

Categories

  • News5121
  • Politics4825
  • Crime4594
  • International3201
  • Sports2576
  • Business & Economy2364
  • Headlines2280
  • Education1444
  • Matilda Showbiz1040
  • Health933
  • Entertainment876
  • Africa615
  • Religion496
  • Environment395
  • Special279
  • Info Tech259
  • Arts & Culture243
  • Inside Akwa Ibom Today230
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview195
  • Opinion158
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade136
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact