Skip to content
Wednesday 4 November 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Cat sleep, rat go bite im tail…

The FrontierThe FrontierOctober 17, 2026 754 Minutes read0

Di kind tings wey dey shele for dis Lagos now, I confuse.

Man pikin go comot for house for early morning before everybody wake up, I go put my guonguoro for road, to go find wetin I go take give my family food, na so rat go bite cat wey dey sleep tail. No be palava dat rat dey find?

Di order day, one passenger like dat come meet me for our garage wey dey near Ikeja Under Bridge. E say make I go drop am for Isale Eko. I ask am wia gan gan for Isale Eko, e say Idumota market.

SDP Poster Layout

I look time, 2 O’clock pm in di afternoon don nack. I talk am for my mind say time still dey, patapata I use one hour go drop am and begin come back to Ikeja. But my broda, e no come be as I tink.

I comot for Idumota by 4 O’clock pm in di evening as I drop di passenger finish. I take IBB Bridge to begin come back, hmmm, I never see di kind Go-slow wey dey dat evening since I begin do dis my taxi driver work for Lagos. I hear nwi dat day. I dey inside Go-slow for 5 hours. Tori Olorun!

I look time wen I reach Alausa, I see say time don go well well, na im I begin drive dey go our house wey dey for Abule Egba.

As I reach house, I never come down from my guonguoro wen my second woman pikin, Funke, run come meet me, e say im sister dey cry since afternoon. Ehn? My first woman pikin, Bisi, dey cry since afternoon? Wetin happen?

I no even remember weda or wedan’t I close di door of my guonguoro as I jump out and begin run enter house dat night.

True true, I see Bisi siddon for chair for parlour dey cry. I ask am wetin happen. I ask am who give am belle? I nearly give am dirty slap sef. Na dat time im Mama, my wife Bose, tell me say no be belle, say na our landlord, Baba Braimoh man pikin, be wahala.

Bose come talk say, as Braimoh come visit im Papa and Mama dat afternoon, e come our room and parlour to greet us, but na only Bisi dey for house dat time.

E say as Braimoh jus see Bisi, e shout shiooorr, na dis girl don grow like dis? Di next ting be say, e begin touch everwia for Bisi body, plus including nyansh.

E say Braimoh even carry Bisi dress up and try to put im finger for my pikin kini. Wen Bisi no gree, e slap Bisi for eye pppuuuooorrr! Na so Bisi eye swell up. And Bisi begin shout, cry and people come full di compound. E say dem jus dey come back from hospital. Olorun Oba o!

See Braimoh wey talk say e don stop to dey smoke Kolos o, say now e be prophet for one church like dat for Mushin o! Na dis fake prophet wan rape my pikin for inside my house o! See me, see troublem o!

Na im I march go Baba Braimoh room go begin knock im door po, po, po! Di old man open door, begin shout for my head say why I hit im door like dat for dis night. I tell am say I dey find Braimoh. E ask me why I dey find im pikin. I ask am weda dat one na JAMB question? I ask am weda e no hear wetin im useless man pikin Braimoh do my first woman pikin Bisi?

Baba Braimoh ask me wetin be dat, na im I call Bisi make e come tell Baba Braimoh wetin im pikin do.

Wen Bisi talk finish, Baba Braimoh hiss, den ask weda me and my pikin get any evidence of say im son, Braimoh, do am dat kind ting. E warn me say make I no ever call im son useless again, say Braimoh life don change, say now im son na Prophet wey dey do deliverance for people. Ewo!!!

I tell am say prophet ko. I ask am weda im son deliverance na for woman nyansh.

I tell am make e warn dat im son well well, say any day e cross im boundary again, e go know say me na correct Ogbomosho man, no be all of dem wey dey claim Lagos.

I tell am say, just becos me and my family dey live for dis im face-me-I-face-you house, no mean say im son go come dey harass my two woman pikin dem anyhow.

Deliverance my nyansh. Mtchewwwwww.

Make we jam again next Saturday.

Tank you,

Tank you very much,

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigerian media, since 1994. 

Tags
CatOga MATRattail
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: TREAT U RIGHT, by FOLA & Ayra Starr
next post ROMANCE GONE SOUR: My husband secretly transferred money from my bank account, deleted notifications from my phone
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Abuja Afrojazz Festival targets global opportunities for Nigerian musicians

October 24, 20260
Gists

Fela lives on in Kwara as state celebrates his life, legacies

October 24, 20260
Gists

BBNaija should take a break, re-strategise — Reality TV star Tacha

October 24, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

ARISE Projects Impact

February 9, 20250
Sports

Football icons Diouf, Adebayor, Appiah, Zokora, Song, others storm Lagos for African legends encounter

November 3, 20260
Crime

DSS frees 4 cleared of IPOB membership, pays N20 million compensation

November 3, 20260
Headlines

BREAKING: Many rushed to hospital as multiple vehicles crash in Lagos, traffic at standstill •VIDEO

November 3, 20260
Crime

EFCC uncovers illegal oil refinery run by Chinese nationals in Ogun

November 3, 20260
News

Drone operators seek stronger regulatory engagement, collaboration

November 3, 20260
News

Katsina road attack: SDP presidential candidate Adebayo commiserates with Nigeria Police over death of officers

November 3, 20260
Load more

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

Football icons Diouf, Adebayor, Appiah, Zokora, Song, others storm Lagos for African legends encounter

November 3, 2026

DSS frees 4 cleared of IPOB membership, pays N20 million compensation

November 3, 2026

BREAKING: Many rushed to hospital as multiple vehicles crash in Lagos, traffic at standstill •VIDEO

November 3, 2026

EFCC uncovers illegal oil refinery run by Chinese nationals in Ogun

November 3, 2026

Drone operators seek stronger regulatory engagement, collaboration

November 3, 2026

ARISE Projects Impact

0 Comments

Football icons Diouf, Adebayor, Appiah, Zokora, Song, others storm Lagos for African legends encounter

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

Court fixes date to hear ex-CBN Governor Emefiele’s application challenging jurisdiction

December 10, 2024
3

Workers issue deadline to FG over 3-month unpaid wages

February 25, 2026
4

Niger Delta Games: Edo emerges overall champion

February 27, 2026
5

Nigerians united by hunger under Tinubu – Peter Obi

February 26, 2024
6

Hot Lyrics: BENIN BOYS, by Rema ft. Shallipopi

July 13, 2024
Popular
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

Coup attempt: Army officers taken hostage in Benin Republic released

December 8, 2025
3

JUST IN: Aviation workers set to shutdown airports nationwide over assault by customs officer

March 24, 2025
4

Supreme Court judgement: Lawyers vow to drag PDP spokesperson to Legal Practitioners’ Disciplinary Committee

March 24, 2025
5

Truck falls off Lagos Bridge, lands on 2 buses

April 27, 2025
6

CBN headquarters currently overpopulated – Cardoso

February 5, 2024

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

Bandits camped 2 kilometers away from where I marked my last birthday – Governor Makinde cries out

January 7, 2025

Factory explosion kills 3, injures 7 in Spain

November 27, 2024

BREAKING: INEC recognises David Mark-led ADC leadership

September 10, 2025

Governor Zulum, minister, others in Chad to repatriate 7,790 refugees

February 6, 2025
Top posts

Categories

  • News5215
  • Politics4967
  • Crime4689
  • International3287
  • Sports2639
  • Business & Economy2404
  • Headlines2305
  • Education1463
  • Matilda Showbiz1062
  • Health981
  • Entertainment902
  • Africa627
  • Religion508
  • Environment411
  • Special279
  • Info Tech271
  • Arts & Culture246
  • Inside Akwa Ibom Today243
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview202
  • Opinion161
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade140
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact