Skip to content
Saturday 22 August 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Dis Trump sef, na wa ooo!

The FrontierThe FrontierNovember 22, 2025 1273 Minutes read0

Since two week now, na so, so Trump dey for all Naija people mouth. You go to market, na Trump. Go to church or mosque, na Trump. Go to any school, na Trump. Waka for road or enter taxi, BRT, danfo, Keke Marwa or Okada, na Trump.

Di ting come get as e be since two Friday wey pass wen dat America Oyibo, Trump, warn our Oga Patapata say make e stop all di kill kill for Naija wey dey target Christian dem.

I hear say afraid come catch Oga Patapata and e promise Trump say e go make sure say di kill kill stop dat very day.

But di ting come be say, instead make di kill kill stop, na now dem come dey kill people pass for Naija. Every day now, if e no be school, na church. Dem go kill some, carry plenty inside bush. Tori Olorun!

Di kill kill don come make everybody confuse. Na everybody confuse now, no be only Oga Patapata. Nobody know di day and time Trump go enter Naija come begin fight to stop di kill kill, as Oga Patapata no fit stop am.

Dis morning, as I dey warm my guonguoro engine make I begin go our garage wey dey near Ikeja under bridge, na im Baba Braimoh, di landlord of di face-me-I-face-you house wey I dey live with my family for Abule Egba, waka come meet me.

I surprise say Baba Braimoh come meet me for dat kind early morning.

E greet me, “Baba Bisi e karo o”. I shock. I talk am for my mind say Baba Braimoh wey be say to greet tenant dey hard am, na so so shout e sabi shout for tenant head.

Me sef answer am say, “e karo o, Baba Braimoh”. I ask am hope no troublem. E say e get somtin wey e wan tell me. I say go on saun.

Baba Braimoh say e wan tell me say, dat my house rent wey e jus increase last month, make I forgot am, make I continue to pay wetin I dey pay teletele.

Baba Braimoh no even wait make I ask am why. Quick, quick e talk say everybody now dey talk am everywia say one oyibo dey come Naija to fight our Oga Patapata and everybody wey dey disturb Christian dem. E say dem talk say dat Oyibo no dey laugh at all, say if e bring im soja dem come, anybody wey dey make wahala don peme be dat.

Baba Braimoh say, as e be say di Oyibo no gree tell anybody di day and di time e go land for Naija, na im make e no wan enter di oyibo wahala becos of house rent.

I ask Baba Braimoh which oyibo e dey talk about, e say e hear say im name na Trump. Laugh nearly comot for my mouth.

I tell am say I don hear wetin e talk about my house rent. Baba Braimoh tank me well well, e wan dobale for me sef but I hold am. Na so e begin go back, as e still dey tank me.

My broda, as Baba Braimoh go, come see laugh. Di only ting wey comot for my mouth na, “Dis Trump sef, na wa ooo!” Only im name don dey fight for Naija. Shiooohhh!!!

Make we jam again next week.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

 

Tags
Oga MATTrump
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Why FG hasn’t prosecuted terrorism financiers – Minister
next post JUST IN: Nottingham Forest humiliate Liverpool 3-0, compound EPL champions’ woes
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Housekeeper wins $13 million court judgment against American music star Chris Brown

August 22, 20260
Gists

BBNaija Season 11: Cassi wins Arena Games for Week 4

August 22, 20260
Gossips

My wife filed for divorce without any quarrel – Popular Gospel singer Asu Ekiye

August 22, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Gists

Housekeeper wins $13 million court judgment against American music star Chris Brown

August 22, 20260
Gists

BBNaija Season 11: Cassi wins Arena Games for Week 4

August 22, 20260
Gossips

My wife filed for divorce without any quarrel – Popular Gospel singer Asu Ekiye

August 22, 20260
Matilda Showbiz

ROMANCE GONE SOUR: Her baby is too dark to be my son

August 22, 20260
Matilda Showbiz

Hot Lyrics: HEAVEN BABY, by Ayra Starr feat. ZAYN

August 22, 20260
Matilda Showbiz

Nigeria’s Top 10 Songs with ITTY OKIM •Week 34

August 22, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Housekeeper wins $13 million court judgment against American music star Chris Brown

August 22, 2026

BBNaija Season 11: Cassi wins Arena Games for Week 4

August 22, 2026

My wife filed for divorce without any quarrel – Popular Gospel singer Asu Ekiye

August 22, 2026

ROMANCE GONE SOUR: Her baby is too dark to be my son

August 22, 2026

Hot Lyrics: HEAVEN BABY, by Ayra Starr feat. ZAYN

August 22, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Housekeeper wins $13 million court judgment against American music star Chris Brown

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Tinubu’s Benue visit: Presidency not tailor shop – Former presidential campaign spokesman fires back at Peter Obi

June 20, 2025
3

Ogun APC spokesman, Tunde Oladunjoye is dead

April 5, 2025
4

Presidential jets gulp N26.38 billion in 18 months under Tinubu •Experts speak

August 6, 2025
5

French actor Depardieu ordered to stand trial for rape

September 2, 2025
6

Budget 2026: FG abandons N7 billion agric ministry building, sinks N11 billion on new site

January 17, 2026
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Senate to NNPCL: Refund ₦210 trillion unaccounted funds to Federation Account

November 12, 2025
3

Again, Tinubu extends tenure of Customs Comptroller General

June 20, 2026
4

AC Milan sack coach Paulo Fonseca after just 6 months

December 30, 2024
5

Ugandan activist arrested in Tanzania found tortured at border – Rights group

May 23, 2025
6

Enugu, Gov Mbah must remain PDP — Former Governor Jim Nwobodo

May 29, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Give full details of N8.05 billion budget for churches and mosques – Former Vice President Atiku tells FG

July 21, 2026

Nigerian Bar Association, Police to review suspended tinted car glass policy

October 17, 2025

Don’t ask a man with Ulcer to fast – Financial expert Rewane warns Nigeria against cutting spending

April 24, 2025

Aiming to stop carnage – Trump vows to talk with Putin, Zelensky

December 16, 2024
Top posts

Categories

  • News4928
  • Politics4592
  • Crime4411
  • International3043
  • Sports2460
  • Business & Economy2273
  • Headlines2223
  • Education1369
  • Matilda Showbiz991
  • Health878
  • Entertainment812
  • Africa578
  • Religion483
  • Environment365
  • Special277
  • Info Tech245
  • Arts & Culture240
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today204
  • Interview186
  • Opinion153
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade130
  • World Cup 202695
  • Advert34
  • Trends23
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact