Skip to content
Friday 18 September 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

No be only Prophet, na Alfa

The FrontierThe FrontierFebruary 7, 2026 1043 Minutes read0

Di kind tings wey dey shele for dis Lagos now, I confuse.

Man pikin go comot for house for early morning before everybody wake up, I go put my guonguoro for road, to go find wetin I go take give my family food, na so rat go come wake cat wey dey sleep up.

Di order day, one passenger like dat come meet me for our garage wey dey near Ikeja under bridge. E say make I go drop am for Isale Eko. I ask am wia gan gan for Isale Eko, e say Idumota market.

I look time, 2 O’clock pm in di afternoon don nack. I talk am for my mind say time still dey, patapata I use one hour go drop am and begin come back to Ikeja. But my broda, e no come be as I tink.

I comot for Idumota by 4 O’clock pm in di evening as I drop di passenger finish. I take IBB Bridge to begin come back, hmmm, I never see di kind Go-slow wey dey dat evening since I begin do dis my taxi driver work for Lagos. I hear nwi dat day. I dey inside Go-slow for 5 hours. Tori Olorun!

I look time wen I reach Alausa, I see say time don go well well, na im I begin drive dey go our house wey dey for Abule Egba.

As I reach house, I never come down from my guonguoro wen my second woman pikin, Funke, run come meet me, e say im sister dey cry since afternoon. Ehn? My first woman pikin, Bisi, dey cry since afternoon? Wetin happen?

I no even remember weda or wedan’t I close di door of my guonguoro as I jump out and begin run enter house dat night.

True true, I see Bisi siddon for chair for parlour dey cry. I ask am wetin happen. I ask am who give am belle? I nearly give am dirty slap sef. Na dat time im Mama, my wife Bose, tell me say no be belle, say na our landlord, Baba Braimoh man pikin, be wahala.

Bose come talk say, as Braimoh come visit im Papa and Mama dat afternoon, e come our room and parlour to greet us, but na only Bisi dey for house dat time.

E say as Braimoh jus see Bisi, e say shiooor, na dis girl don grow like dis? Di next ting be say, e begin touch Bisi pawpaw for chest and nyansh, carry Bisi dress up and try to put im finger for my pikin kini. Wen Bisi no gree, e slap Bisi for eye pppuuuooorrr! Na so Bisi eye swell up. And Bisi begin shout, cry and people come full di compound. E say dem jus dey come back from hospital. Olorun Oba o!

See Braimoh wey talk say e don stop to dey smoke wee wee o, say now e be prophet for one church like dat for Mushin o! Na dis fake prophet wan rape my pikin for inside my house o! See me, see troublem o!

Na im I march go Baba Braimoh room go begin knock im door po, po, po! Di old man open door, begin shout for my head say why I hit im door like dat dis night. I tell am say I dey find Braimoh. E ask me why I dey find im pikin. I ask am weda dat one na JAMB question? I ask am weda e no hear wetin Braimoh do my first woman pikin Bisi?

Baba Braimoh ask me wetin be dat, na im I call Bisi make e come tell Baba Braimoh wetin im pikin do.

Wen Bisi talk finish, Baba Braimoh hiss, den ask weda me and my pikin get any evidence of say im son, Prophet Braimoh, do am dat kind ting. Ewo!

I tell am say prophet ko, Alfa ni. I ask am weda im kolos son speciality na prophet for woman nyansh.

I come tell am say if you Chris my pikin, I go Doris am. Chikena!

Na di matter of evidence we still dey till today.

No worry, I go nack una di tori of how we waka anoda day.

Make we jam again next Saturday.

Tank you,

Tank you very much,

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigerian media, since 1994.

Tags
AlfaOga MATprophet
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: MY HEALER, by Seyi Vibez and Omah Lay
next post ROMANCE GONE SOUR: My wife inspects my private parts because she suspects I’m cheating on her
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Matilda Showbiz

Vacancy: Part-time wife wanted. Na urgent!

September 12, 20260
Matilda Showbiz

ROMANCE GONE SOUR: A co-landlord confessed to me that he had been sleeping with my wife who had told him I was dead

September 12, 20260
Gists

Sensuous American singer and actress Lady Gaga welcomes first child with fiancé

September 12, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
International

Brother of late Princess Diana makes new explosive claims against King Charles III

September 18, 20260
Crime

Eight suspects docked over disappearance of baby from church premises

September 18, 20260
News

Wear APC cap or face consequences — LG chairman threatens commercial drivers

September 18, 20260
International

Can Nigerians join US, UK armies? •Requirements explained

September 18, 20260
Headlines

EXPOSED: Dying moment of 37 suspected miners in Civil Defence custody arrested after ‘refusing to pay bribe’ — Survivor narrates

September 18, 20260
Politics

Disband INEC now over Appeal Court judgment on Electoral Act, says presidential hopeful Gbenga Hashim

September 18, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Brother of late Princess Diana makes new explosive claims against King Charles III

September 18, 2026

Eight suspects docked over disappearance of baby from church premises

September 18, 2026

Wear APC cap or face consequences — LG chairman threatens commercial drivers

September 18, 2026

Can Nigerians join US, UK armies? •Requirements explained

September 18, 2026

EXPOSED: Dying moment of 37 suspected miners in Civil Defence custody arrested after ‘refusing to pay bribe’ — Survivor narrates

September 18, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Brother of late Princess Diana makes new explosive claims against King Charles III

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Fake graduates: FG orders varsities to submit admission lists

August 19, 2024
3

Inside bandits’ hideouts: A journalist’s expedition through notorious camps •PHOTO

January 11, 2025
4

MTN begs Nigerians over 200% data bundle hike, says ‘Forgive and forget’

February 13, 2025
5

1,000 kidnapped Nigerians: Families beg as abductors go silent •We’ve converted our captives to Islam – Terrorist

April 18, 2026
6

Angry protesters destroy ex-Governor Wike’s billboards in Rivers •PHOTOS

March 16, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

‘Nothing dey rise for this country’ – Nigerians lament as national grid collapses again

December 12, 2023
3

Nigeria asks ECOWAS to drag South Africa before African Union

July 20, 2026
4

Former President Obasanjo criticises Tinubu’s leadership, describes Nigeria as failing state

November 17, 2024
5

2027 Presidency: Coalition demands Atiku, Peter Obi’s full membership

September 26, 2025
6

Tinubu to attend Arab-Africa Summit in Saudi Arabia

November 6, 2023

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

There’s ample evidence of genocide in Nigeria — Legal expert raises alarm, urges urgent action

December 20, 2025

Nigeria’s current taxation policy will deepen hardship, says Peter Obi

January 2, 2026

Lawyer urges Ndigbo to rise against killings in South-East

July 30, 2025

Petrol price to rise more as naira-for-crude talks wobble

March 31, 2025
Top posts

Categories

  • News5038
  • Politics4728
  • Crime4522
  • International3130
  • Sports2533
  • Business & Economy2330
  • Headlines2248
  • Education1416
  • Matilda Showbiz1016
  • Health910
  • Entertainment843
  • Africa602
  • Religion488
  • Environment377
  • Special278
  • Info Tech251
  • Arts & Culture240
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today216
  • Interview192
  • Opinion154
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade134
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends23
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge3

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact