Skip to content
Wednesday 1 July 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Papa, Mama, hold una man-pikin well o (2)

The FrontierThe FrontierFebruary 3, 2024 3941 Minutes read0

Continued from last Saturday…

I rush di last bottle of My Usual and Point-and-Kill, den tell Madam Shine make e give me my bill.

Madam Shine tell di salesgirl make e give me my bill, I say no, na you Madam Shine, go give me bill, and make e do quick, say time don too go, or I go jus begin dey go my house.

Wen e see say my eye don red, na im Madam Shine come meet me.

E talk am small for my ear say why I wan spoil business for am? E say dat bobo wey I see so, promise am say if e gree give am kini, di bobo go give am 200k. E say na im make e no wan make di bobo see am siddon with me. E say na im new catch be dat. E say di bobo dey even dey call am for midnight for video make dem dey do kini for phone. I ask Madam Shine weda im husband no dey house. E say im husband and dia five pikin dem neva come back since dem go village for Keresimasi.

Madam Shine give me bill, put everyting wey me and im drink and chop – My Usual (2 bottles) and Point-and-Kill, for me; Odekun (5 bottles) and Nkwobi for Madam Shine. Hmmm, my broda, by di time I pay finish, na so all di money wey I work dat yesterday, from morning till night, jus go. Sope otilo.

Na im make I warn all Papa and Mama say, if una man-pikin say e wan marry any sisi or woman wey dey work for beer parlour, take am go di place wey dem go do deliverance for dat your man-pikin, make im eye clear. Beer parlour madam and dia salesgirl dem, na di same ten and ten pence.

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigerian media, since 1994.

 

Tags
HoldMamaman-pikinOga MATPapauna
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: OMO OLOGO, by Zlatan
next post ROMANCE GONE SOUR: She still claims to be my wife after she left me, got married to 2 other men
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Matilda Showbiz

Nigeria’s Top 10 Songs with ITTY OKIM •Week 26

June 27, 20260
Gists

Food, music, as Jollof Fest returns to Lagos with new addition

June 27, 20260
Gists

Afrobeats star Rema sets Mawazine Festival stage on fire after World Cup opening ceremony moment

June 27, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
World Cup 2026

England face DR Congo test as USA prepare for World Cup moment

July 1, 20260
World Cup 2026

Two dead in World Cup celebrations in Mexico City

July 1, 20260
Crime

Borno school attack: 37 children still missing — Parents

July 1, 20260
Trends

Nigeria delivery ecosystem sees return of bicycle courier

July 1, 20260
Politics

2027 elections: Publish academic certificates, credentials submitted by every candidate – Peter Obi challenges INEC

July 1, 20260
Environment

Coastal states in panic mode as floods disrupt Lagos economy amid disease fears •More rains coming today – NiMet

July 1, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

England face DR Congo test as USA prepare for World Cup moment

July 1, 2026

Two dead in World Cup celebrations in Mexico City

July 1, 2026

Borno school attack: 37 children still missing — Parents

July 1, 2026

Nigeria delivery ecosystem sees return of bicycle courier

July 1, 2026

2027 elections: Publish academic certificates, credentials submitted by every candidate – Peter Obi challenges INEC

July 1, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

England face DR Congo test as USA prepare for World Cup moment

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Again, Trump fined $10,000 for violating gag order

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Alleged humiliation: El-Rufai prepares to fight Tinubu in 2 courts

April 6, 2024
3

Fingerprint to replace mammogram for breast cancer detection

January 4, 2024
4

UPDATED: Deputy police commissioner kills self

April 2, 2024
5

INSIDE AKWA IBOM TODAY: Governor Eno commits to building strong educational future for Akwa Ibom children

March 23, 2025
6

Tinubu appoints Bishop Kukah Pro-Chancellor University of Applied Sciences Kachia

March 18, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

BBNAIJA 10: Six new housemates join nine others

July 27, 2025
3

6 airlines cancel Venezuela flights after US warning

November 24, 2025
4

Chelsea held by relegation-battling Burnley in blow to Champions League hopes

February 22, 2026
5

Iraq urges OPEC to raise its oil production quota

June 25, 2026
6

TRAGEDY: 7 dead, one injured as another petrol tanker explodes

March 8, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Troops kill mastermind of NDA attack, abduction of Kebbi school girls

February 22, 2024

Terrorists den: 360 freed Borno captives recount 3 months heartbreaking experiences

June 9, 2026

12 trafficking victims en route to Saudi Arabia rescued in Kano

September 1, 2025

UNICAL Vice Chancellor pledges to resolve Dentistry students crisis

July 16, 2025
Top posts

Categories

  • News4701
  • Politics4342
  • Crime4122
  • International2863
  • Sports2357
  • Business & Economy2192
  • Headlines2130
  • Education1310
  • Matilda Showbiz936
  • Health831
  • Entertainment771
  • Africa526
  • Religion469
  • Environment340
  • Special267
  • Info Tech231
  • Arts & Culture228
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today187
  • Interview180
  • Opinion150
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade123
  • Advert31
  • World Cup 202631
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Trends18
  • Local News5

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact