Skip to content
Tuesday 3 March 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda Showbiz

Re: Wahala everywia, me sef wan go vacation

The FrontierThe FrontierOctober 19, 2024 1973 Minutes read0

(Response from readers)

My people, since I begin nack una di tori above, di son of man no rest again. Na so readers dey bombard me left, right and center, sote, di battery of dis my torchlight chinko phone don nearly peme becos of plenty message.

And e come be di time wey our national grid jus dey faint, wake up, faint, wake up, faint, wake up. Tank Eledumare say person dey for standby wey dey pour di national grid water for head wen e faint, if no be so, e for don faint, e no go wake up again lai lai.

Petrol now na gold, I no fit talk say make I go buy petrol put for my I-beta-pass-my-nebor gen take charge phone. Dat one na no go area, wen be say di petrol no dey reach my guonguoro sef to take do my taxi driver work.

Na di ting wey bring plenty message from readers, becos of di tori wey I nack say, “Wahala everywia, me sef wan go vacation”.

Make una follow me read wetin readers talk:

Dear Oga MAT,

Dis one wey you don use two weeks dey tell us say you wan go on vacation becos of too much wahala for your house, shey no be say you and Sikiratu get plan so? How you wan abandon your wife Bose and your two woman pikin dem – Bisi and Funke, jus becos small wahala dey house? I no blame you. Na our Oga patapata wey im, plus including im second, don run go enjoy for oyibo land and lef us for Naija make hungry finish us. Na dem I blame. Na dem teach you bad ting.

– Bukky Ayobami 

Surulere, Lagos

Dear Oga MAT,

I don dey pray long time ago make you give small chance make man fit enter your house go check out your two woman pikin dem – Bisi and Funke. I wan do dem dat ting wey you dey do dat buka girl, Sikiratu. After all, anyting wey good for di goose, is good for di gooser. Abi no be so? Biko, go on dat your vacation and remain for dia. We no go miss you at all, at all.

– Chibuike Uzodinma,

Owerri,

Imo State.

Dear Oga MAT,

Which day you and Bose go know say una don old? How di two both of you go dey disturb una pikin dem for midnight, every day, sake of say one person wan do kini di order person no wan do? Make you and your wife try respect una self for dat Baba Briamoh face-me-I-face-you 

house wey una dey live for Abule Egba. Shege banza!

– Abdullahi Adamu

Maiduguri,

Borno State 

Dear Oga MAT,

Di ting wey I go tell you now be say, if your wife Bose no dey gree give you dat ting again, lef am. Me, I dey kampe. Abeg, come my house come do vacation. I go give you everyting wey you wan. Wetin you wan take dat old mama do sef wen sisi wey everyting for body stand paparapa like Standard Bank dey wait for you here? I go send my house address to you after later.

– Osareti Odion

Benin City,

Edo State 

Dear Oga MAT,

You tell us for di tori wey you nack us for last two weeks say you wan go vacation becos say wahala full everywia. Why nah? I beg you, no go anywia becos your tori too dey sweet me, mbok. No tell me say wen you go for vacation you go dey work from anywia you dey. I know say dat one na big lie. Na so Baba and im second tell us but see, everyting for Naija don scata finish, sote national grid don collapse 4 times now inside one week. But you o, I go do everyting to make sure say you no go anywia. You wan try?

– Akon Etim

Uyo,

Akwa Ibom State.

My people, shey una see wetin I mean? Na di ones wey I fit show una be dat o. Di message plenty too much. Tori Olorun!

Now, I confuse. I no know weda or wedan’t to go on vacation.

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
everywiaOga MATRe: Wahalavacation
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Manchester United the only problem in my life – Popular Nigerian singer, Adekunle Gold laments
next post Davido, Wizkid snub each other at London nightclub
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Matilda Showbiz

ROMANCE GONE SOUR: My husband married a woman much older than him, threw me and our children out

February 28, 20260
Matilda Showbiz

Set-piece power fires Liverpool past West Ham as Haaland-less City face Leeds test

February 28, 20260
Gists

Censors Board honours filmmaker Funke Akindele as Nollywood box office champion

February 28, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Business & Economy

House of Reps moves to recover $7 billion from foreign airlines

March 3, 20260
Crime

Two men sentenced to death for killing groom

March 3, 20260
Crime

Alleged N80.2 billion fraud: Former Governor Yahaya Bello kicks as EFCC seeks to tender more evidence

March 3, 20260
Education

Varsity threatens to seize stray animals, sanction owners

March 3, 20260
International

JUST IN: Another round of Israel, US strikes hit building of assembly to elect new Iran supreme leader

March 3, 20260
Health

Alcohol ban on small pack sizes will curb underage drinking – NAFDAC

March 3, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

House of Reps moves to recover $7 billion from foreign airlines

March 3, 2026

Two men sentenced to death for killing groom

March 3, 2026

Alleged N80.2 billion fraud: Former Governor Yahaya Bello kicks as EFCC seeks to tender more evidence

March 3, 2026

Varsity threatens to seize stray animals, sanction owners

March 3, 2026

JUST IN: Another round of Israel, US strikes hit building of assembly to elect new Iran supreme leader

March 3, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

House of Reps moves to recover $7 billion from foreign airlines

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Again, Trump fined $10,000 for violating gag order

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Forgery of tax law treason against Nigerians – Former Vice President Atiku

December 24, 2025
3

School shut down in Ogun over student’s death

October 29, 2024
4

Hajj: Nigerian pilgrim dies in Saudi Arabia

June 3, 2025
5

220 oil blocks abandoned amid debt, crude crises

August 4, 2025
6

BOMBSHELL: UK minister resigns over Rwanda immigration bill

December 7, 2023
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

I’ll swear in 8 judges-designate in Edo if elected gov – Agbomhere

February 3, 2024
3

Nigerian business community thrown into panic mode over Duty increase, spot FX rate

February 5, 2024
4

Heavy security at National Assembly over fear of suspended Senator Natasha’s return

September 16, 2025
5

2027: APC warns Tinubu of South-East risks as El-Rufai seeks alliances to ‘rescue’ Nigeria

February 24, 2025
6

UPDATED: Crashed helicopter had NNPCL personnel onboard

October 24, 2024

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Military has no excuse not to secure Nigeria — Air Chief

January 14, 2024

JUST IN: EFCC in night operation at Kogi Govt Lodge to arrest wanted ex-Governor Yahaya Bello

September 18, 2024

Eye care intervention: NNPCL to restore 6,000 people sights in 2025

January 29, 2025

I was called imbecile because of cerebral palsy – TikTok dancer Chineye Okeke

September 20, 2025
Top posts

Categories

  • News4297
  • Politics3684
  • Crime3583
  • International2455
  • Sports2062
  • Headlines1979
  • Business & Economy1974
  • Education1150
  • Matilda Showbiz826
  • Health733
  • Entertainment676
  • Africa412
  • Religion400
  • Environment301
  • Special250
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Arts & Culture214
  • Info Tech198
  • Interview164
  • Inside Akwa Ibom Today151
  • Opinion142
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade106
  • Advert30
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Trends16
  • Local News4

© 2025 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact