Skip to content
Thursday 29 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda Showbiz

Re: Wahala everywia, me sef wan go vacation

The FrontierThe FrontierOctober 19, 2024 2963 Minutes read0

(Response from readers)

My people, since I begin nack una di tori above, di son of man no rest again. Na so readers dey bombard me left, right and center, sote, di battery of dis my torchlight chinko phone don nearly peme becos of plenty message.

And e come be di time wey our national grid jus dey faint, wake up, faint, wake up, faint, wake up. Tank Eledumare say person dey for standby wey dey pour di national grid water for head wen e faint, if no be so, e for don faint, e no go wake up again lai lai.

SDP Poster Layout

Petrol now na gold, I no fit talk say make I go buy petrol put for my I-beta-pass-my-nebor gen take charge phone. Dat one na no go area, wen be say di petrol no dey reach my guonguoro sef to take do my taxi driver work.

Na di ting wey bring plenty message from readers, becos of di tori wey I nack say, “Wahala everywia, me sef wan go vacation”.

Make una follow me read wetin readers talk:

Dear Oga MAT,

Dis one wey you don use two weeks dey tell us say you wan go on vacation becos of too much wahala for your house, shey no be say you and Sikiratu get plan so? How you wan abandon your wife Bose and your two woman pikin dem – Bisi and Funke, jus becos small wahala dey house? I no blame you. Na our Oga patapata wey im, plus including im second, don run go enjoy for oyibo land and lef us for Naija make hungry finish us. Na dem I blame. Na dem teach you bad ting.

– Bukky Ayobami 

Surulere, Lagos

Dear Oga MAT,

I don dey pray long time ago make you give small chance make man fit enter your house go check out your two woman pikin dem – Bisi and Funke. I wan do dem dat ting wey you dey do dat buka girl, Sikiratu. After all, anyting wey good for di goose, is good for di gooser. Abi no be so? Biko, go on dat your vacation and remain for dia. We no go miss you at all, at all.

– Chibuike Uzodinma,

Owerri,

Imo State.

Dear Oga MAT,

Which day you and Bose go know say una don old? How di two both of you go dey disturb una pikin dem for midnight, every day, sake of say one person wan do kini di order person no wan do? Make you and your wife try respect una self for dat Baba Briamoh face-me-I-face-you 

house wey una dey live for Abule Egba. Shege banza!

– Abdullahi Adamu

Maiduguri,

Borno State 

Dear Oga MAT,

Di ting wey I go tell you now be say, if your wife Bose no dey gree give you dat ting again, lef am. Me, I dey kampe. Abeg, come my house come do vacation. I go give you everyting wey you wan. Wetin you wan take dat old mama do sef wen sisi wey everyting for body stand paparapa like Standard Bank dey wait for you here? I go send my house address to you after later.

– Osareti Odion

Benin City,

Edo State 

Dear Oga MAT,

You tell us for di tori wey you nack us for last two weeks say you wan go vacation becos say wahala full everywia. Why nah? I beg you, no go anywia becos your tori too dey sweet me, mbok. No tell me say wen you go for vacation you go dey work from anywia you dey. I know say dat one na big lie. Na so Baba and im second tell us but see, everyting for Naija don scata finish, sote national grid don collapse 4 times now inside one week. But you o, I go do everyting to make sure say you no go anywia. You wan try?

– Akon Etim

Uyo,

Akwa Ibom State.

My people, shey una see wetin I mean? Na di ones wey I fit show una be dat o. Di message plenty too much. Tori Olorun!

Now, I confuse. I no know weda or wedan’t to go on vacation.

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
everywiaOga MATRe: Wahalavacation
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Manchester United the only problem in my life – Popular Nigerian singer, Adekunle Gold laments
next post Davido, Wizkid snub each other at London nightclub
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Abuja Afrojazz Festival targets global opportunities for Nigerian musicians

October 24, 20260
Gists

Fela lives on in Kwara as state celebrates his life, legacies

October 24, 20260
Gists

BBNaija should take a break, re-strategise — Reality TV star Tacha

October 24, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

ARISE Projects Impact

February 9, 20250
Politics

Show Nigerians daily videos, photos as proof of Tinubu’s trip to pray for the nation in Makkah — Former Vice President Atiku tells Presidency

October 29, 20260
Sports

Liverpool overcome Chelsea in tense penalty shootout

October 29, 20260
Sports

Chelsea win as Bayern, Madrid share points in Women’s Champions League

October 29, 20260
News

FG to spend $45.8 million on biosecurity upgrade at Lagos, Abuja, three other international airports

October 29, 20260
News

Tinubu jets out to Saudi Arabia to pray for Nigeria

October 29, 20260
Politics

Your 70,000 Naira transport intervention for Nigerian workers is vote buying by trick – SDP Presidential Candidate Adebayo tackles Tinubu

October 29, 20260
Load more

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

Show Nigerians daily videos, photos as proof of Tinubu’s trip to pray for the nation in Makkah — Former Vice President Atiku tells Presidency

October 29, 2026

Liverpool overcome Chelsea in tense penalty shootout

October 29, 2026

Chelsea win as Bayern, Madrid share points in Women’s Champions League

October 29, 2026

FG to spend $45.8 million on biosecurity upgrade at Lagos, Abuja, three other international airports

October 29, 2026

Tinubu jets out to Saudi Arabia to pray for Nigeria

October 29, 2026

ARISE Projects Impact

0 Comments

Show Nigerians daily videos, photos as proof of Tinubu’s trip to pray for the nation in Makkah — Former Vice President Atiku tells Presidency

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

CBN unveils 2026 monetary policy agenda

March 26, 2026
3

Rivers Assembly holds sitting, insists on challenging Appeal Court decision

July 5, 2024
4

Hardship: Pure water may be sold for N100 per sachet — Producers

February 29, 2024
5

107 victims of Benue attack still hospitalised – SEMA

July 15, 2025
6

Insecurity: State Assemblies move to debate state police

December 1, 2025
Popular
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

REVEALED: Buhari’s govt was unhappy when Reps blocked loan excluding South-East – Chief of Staff to President, Gbajabiamila

February 10, 2026
3

2027: Former Governor Amaechi’s presidential campaign posters flood Katsina

May 22, 2026
4

Oil workers strike continues as depots remain shut, operators to hike fuel prices

September 9, 2025
5

Peter Obi, ADC, Akpata slam APC govt after attack by gunmen in Edo

February 25, 2026
6

Lewandowski suffers hamstring injury, may miss Barca’s season opener

August 8, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

Tinubu announces creation of disaster relief fund for flood victims

September 17, 2024

UPDATED: 14-year-old British-Nigerian boy identified as victim of London daytime sword killing

May 2, 2024

Floods: Heavy rainfall wreaks havoc, kills 3, destroys houses, farmlands in Bauchi

August 13, 2024

Senate denies ban on commercial vehicles preaching in FRSC Act Amendment

July 28, 2026
Top posts

Categories

  • News5200
  • Politics4927
  • Crime4671
  • International3262
  • Sports2624
  • Business & Economy2394
  • Headlines2301
  • Education1459
  • Matilda Showbiz1062
  • Health975
  • Entertainment898
  • Africa623
  • Religion504
  • Environment408
  • Special279
  • Info Tech270
  • Arts & Culture245
  • Inside Akwa Ibom Today239
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview200
  • Opinion159
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade139
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact