When I dey grow up for our village for Ogbomoso dat time, na im I hear people dey talk about America Wonder a.k.a. Abracadabra. But as I run comot for my village come Lagos in 1965, becos say Arike Papa wan use African Insurance finish me say na me give im pikin belle, jus becos […]

