Skip to content
Sunday 18 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Di kind cold wey come with dis everyday rain na wa o!

The FrontierThe FrontierOctober 3, 2026 583 Minutes read0

Dis cold wey dey for Naija now get as e be. Di tin carry weight, no be small. Even di cold wey dem dey talk say e dey for Oyibo contry, na small pikin for dis Naija cold wey dey now.

I know say na di heavy rain wey dey fall every day katikati and cause flood upandan for Naija, na im bring dis cold.

Di rain dey fall for Lagos ti-ti-ti-ti, sote all di road turn to emergency lagoon, and so do cold dey catch even as I I dey nack una dis tori so. Tori Olorun!

SDP Poster Layout

Di order day, I hear one Agege market woman talk say dis cold na wintch bring am. I say na wa for Naija people o. Everyting wey happen na wintch cause am. But if na for Oyiboland, dem for find one fine woman name give di cold. Dem fit call am Katrina or Elizabeth.

Anyway sha, na we Lagos taxi driver suffer dis cold matter pass. Di cold dey show us di Good, di Bad and di OBJ…sorry, na ‘and di Ugly’ I wan talk o before my tongue come sleep. Make dis my sleeping tongue no put me for wahala one day. Helep me say Amin!

Di good ting about di cold be say, now, me and my wife Bose don dey like 5 and 6.

Wen I don close work for night, go reach our house wey dey for Abule Egba, wen I chop finish, enter bed, Bose go use style abandon our two woman pikin dem – Bisi and Funke – for parlour, come meet me for bedroom. Na so Bose go fold im body like say e dey inside ice water. E go tell me say cold don finish am. I go lock door, draw am enter bed, use heavy blanket cover di too both of us. Na so me and Bose go gum body – bie bie to bie bie – under di blanket. Before you say Jack, we don start bend-bend sleep be dat.

Dat time I go talk am for my mind say, see my wife wey no dey let me near am for bed teletele o.

To say we never dagba, Bose for don carry belle and born pikin by next year, and I for name di pikin Tutu. But sha, miracle pikin fit still happen.

Na im make I talk say dis cold na Good ting for me, and na im make I no wan make di cold go.

I no dey branch for Madam Shine buka again wen I close work for evening since wen dis cold start. After all, wetin dey for Sokoto dey for shokoto trouser.

But di Bad and di Ugly side be say, na we wey dey do taxi driver work dey suffer for dis cold pass.

Una kukuma know say people no dey baf again. If you see anybody wear suit and heavy clothe waka for road, check am well well, you go discover say di person jus wear di big clothe make cold no enter im body.

Na so inside my guonguoro dey choke now becos passenger dem no dey baf, na so so perfume dem dey pour for body – from head to toe – and na so di inside of my guonguoro go come choke gan.

Di order day, two passenger dem – one sisi and one bobo like dat – come meet me for our garage wey dey near Ikeja under bridge. Di two both of dem wear heavy suit plus tie take cover body make people tink say na one big meeting like dat dem dey go for. Dem say make I carry dem for drop go Mafoluku. I tell dem my price, dem gree. I say make dem enter. I open ignition, start engine, put am for gear one and move.

We no even climb dat flyover for railway line near Ikeja Council wen I begin cough like pussy cat. I cough sote I nearly drive go jam electric pole. Olorun maje!

Na di kind wicked perfume wey dis bobo and sisi pour for dia body as dem no baf dat morning becos of cold, na im been wan finish me so o.

Tank Eledumare say, I still manage drive dem go reach Mafoluku and collect my money. Olorun Oba o!

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994. 

Tags
coldeveryday rainOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: IKEBE, by Blaqbonez feat. Asake
next post ROMANCE GONE SOUR: My wife drank snipper, attempted suicide after I became broke and couldn’t afford her expensive lifestyle
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

REVEALED: Two movie roles that pushed me out of my comfort zone — Actress Etinosa

October 17, 20260
Matilda Showbiz

Neto double gives Chelsea win over Everton; marred by Martinez injury

October 17, 20260
Gists

Walk away if marriage isn’t working — Nollywood actress Uche Ogbodo

October 17, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Crime

Hunters kill kidnappers who came for ₦10 million ransom

October 18, 20260
Crime

Mother sells one-month-old baby for N2 million

October 18, 20260
Health

Why husbands should be in labour rooms with wives — Gynaecologists

October 18, 20260
News

Army chief visits Borno as parents lament children’s 155 days in kidnappers’ den

October 18, 20260
Headlines

REVEALED: How I received threats, my mother kidnapped over $2.4 billion fuel subsidy fraud probe — Ngozi Okonjo-Iweala recounts

October 18, 20260
Politics

EXPOSED: I never purchased nomination form for 2027 governorship election, says purported Ogun PDP aspirant

October 18, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Hunters kill kidnappers who came for ₦10 million ransom

October 18, 2026

Mother sells one-month-old baby for N2 million

October 18, 2026

Why husbands should be in labour rooms with wives — Gynaecologists

October 18, 2026

Army chief visits Borno as parents lament children’s 155 days in kidnappers’ den

October 18, 2026

REVEALED: How I received threats, my mother kidnapped over $2.4 billion fuel subsidy fraud probe — Ngozi Okonjo-Iweala recounts

October 18, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Hunters kill kidnappers who came for ₦10 million ransom

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Terrorism: 5 Papiri Catholic Church attack masterminds bag 25-year jail term

June 12, 2026
3

President Putin vows retribution against those trying to divide Russia

July 25, 2024
4

Nigeria risks losing youth generation to drug abuse, mental health crisis

May 6, 2025
5

Rescue our children – Parents of stranded Zamfara students in Cyprus beg Governor Lawal

November 11, 2024
6

Company MD arraigned for alleged visa scam

November 15, 2024
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

TRAGIC: Woman burns sister-in-law’s private part over witchcraft claims

September 18, 2025
3

We’re under attack by saboteurs – NNPC Ltd management cries out

June 27, 2025
4

Court convicts Blogger for cyberbullying MFM founder, Olukoya

May 1, 2025
5

UCL: Osimhen on target as Galatasaray dump Juventus to reach Round of 16

February 26, 2026
6

JUST IN: Building collapses in Abuja, rescue operations ongoing

September 8, 2026

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

BDC operator allegedly defrauds Nigerian-based Indian

April 19, 2024

BREAKING: At last, Tinubu opens up on controversial petrol price hike

September 6, 2024

RED ALERT: Jebba Dam is currently spilling excess water – FG warns Nigerians on flood

October 8, 2024

Again, UK Conservative Party leader Kemi Badenoch slams VP Shettima, says “I’m Yoruba; I’ve nothing in common with Northern Nigeria”

December 13, 2024
Top posts

Categories

  • News5156
  • Politics4867
  • Crime4626
  • International3229
  • Sports2596
  • Business & Economy2378
  • Headlines2289
  • Education1450
  • Matilda Showbiz1054
  • Health945
  • Entertainment887
  • Africa616
  • Religion500
  • Environment403
  • Special279
  • Info Tech265
  • Arts & Culture244
  • Inside Akwa Ibom Today234
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview198
  • Opinion159
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade137
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact