E no good make agbalagba like me wey don marry tipe tipe come begin live alone like bobo wey never marry teletele. Na dat one oyibo dem dey call married bachelor. Abi no be so? My wife Bose travel go dia village for Ondo since last week. E say e wan go see im Mama, […]

