Skip to content
Tuesday 1 September 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Shiooo! Sikiratu don become emergency star for TikTok

The FrontierThe FrontierAugust 8, 2026 713 Minutes read0

Replay

Wahala no dey finish for dis our Naija. Tell me, how wahala go finish wen be say, everyday, all dis Lagos sisi dem go dey bring out sometin wey dem go take catch man.

Now na for phone e dey happen. Sisi dem go take photo, do video and post for TikTok wey dey inside phone. And di kind photo and video wey dem dey post, hmmm, na di type wey be say, if any bobo see am, e must to swallow saliva. Dem fit use am catch pastor, imam or even babalawo sef.

Me, wetin concern me. Na my taxi driver work I dey face. Wen I comot for our house for Abule Egba for early morning, go reach our garage wey dey near Ikeja Under Bridge, I go park my guonguoro, siddon dey wait for passenger wey I go carry for Drop or for Chatter. Na only call I dey receive with my torchlight chinko phone – no photo, no video. Wetin concern agbero with overload?

If no be say yesterday as I dey wait for passenger to come, our union member, Akpan, run come show me sometin wey e see for im iPhone.

As Akpan run dey come wia I siddon for di bench wey dey our garage, na so e dey shout, “Oga MAT! Oga MAT!! Come see your babe, e don become star for TikTok o!!!

Na so all our union member dem wey dey for garage dat morning, rush come to look wetin Akpan wan show me.

And true, true, when we look Akpan phone, come see as Sikiratu dey dance for TikTok video.

No be only dance o, na so Sikiratu dey dance dey bring out tongue like say e wan lick sometin. E go dey shake im nyansh, dey carry leg up make everybody see di yellow dross wey e wear for under di short skirt wey e wear. And na so e go dey shake di two ripe pawpaw wey dey for im chest. Tori Olorun!

As Sikiratu dey dance for di TikTok video, I use style dey look all our union member dia face.

Na so all of dem just dey swallow saliva. E be dem like say make dem break Akpan phone, open am and bring out Sikiratu and chop am

raw. Olorun Oba o!

Come see as all di bobo dem for di hole world Like, Love and Comment, as Sikiratu dey dance for di video, small remain make e dance naked.

Some of dem comment say, “Sweet Babe, I love you”, “Will you marry me?”, “Where do you live? I want to come and pay your bride price”, “Can I have you my darling in my bed this weekend?”.

I come talk am for my mind say, see girl wey dey wash plate and serve customer dem for Madam Shine Buka o. Now, e go tink say all dis bobo dem wey dey comment, love am.

No wonder Sikiratu no dey pick my call again since wen e don dey dance naked for TikTok. E tink say e don become star be dat. E tink say e don arrive so e don trowey me for gutter. Oh, my Siki Babe!

No troublem sha. But make Sikiratu make mistake go meet any of di bobo dem, na dat time e go know say khaki no be leather. E go hear nwi for dia hand. Dem go show am pepper for dia house as dat oga show dat nurse, abi doctor or na fisi…fisio…fisiote…

Abeg make una helep me complete am make I no come bite my tongue.

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
emergency starOga MATSikiratuTikTok
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post ROMANCE GONE SOUR: My husband is a drug addict, confessed he was expelled from school for cultism
next post REVEALED: Real reason Nigeria’s sensuous singer Ayra Starr was denied South African visa — Envoy
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Interview

I’ll live forever through my music — Prolific singer and producer Pheelz

August 29, 20260
Gists

Funke Akindele is kind, generous despite strict nature – Nollywood actress Ronke Oshodi-Oke

August 29, 20260
Gists

BBNaija Season 11: Your peace call not convincing – Nomy tells Tram

August 29, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
International

Bank of America Vice President stabbed to death by knife-wielding woman, suspect shot dead by Police •VIDEO

September 1, 20260
Education

JUST IN: JAMB, WAEC end multiple O’Level verification charges, fix one-off fee

September 1, 20260
Sports

BREAKING: Nigeria’s Super Eagles to face Madagascar, Guinea-Bissau this month in 2027 Africa Cup of Nations qualifiers

September 1, 20260
Crime

Man in police net over plot to kill Okada rider, steal his motorcycle

September 1, 20260
Headlines

Petrol price hits N1,350 as Dangote, marketers fight deepens

September 1, 20260
Environment

Calabar landslide: Quacks put lives at risk — Nigerian engineers warn

September 1, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Bank of America Vice President stabbed to death by knife-wielding woman, suspect shot dead by Police •VIDEO

September 1, 2026

JUST IN: JAMB, WAEC end multiple O’Level verification charges, fix one-off fee

September 1, 2026

BREAKING: Nigeria’s Super Eagles to face Madagascar, Guinea-Bissau this month in 2027 Africa Cup of Nations qualifiers

September 1, 2026

Man in police net over plot to kill Okada rider, steal his motorcycle

September 1, 2026

Petrol price hits N1,350 as Dangote, marketers fight deepens

September 1, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Bank of America Vice President stabbed to death by knife-wielding woman, suspect shot dead by Police •VIDEO

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Tinubu hails Oyebamiji’s emergence as Osun APC governorship candidate

December 14, 2025
3

REVEALED: Ondo APC governorship aspirants besiege Abuja for Tinubu’s endorsement

April 2, 2024
4

Food scarcity: South East youths blame open grazing, banditry

June 24, 2024
5

UN security summit: IGP Disu advocates technology-driven policing, global partnerships

July 10, 2026
6

How life abroad humbled me — Nollywood diva Omotola Jalade-Ekeinde

November 15, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Anti-corruption fight has derailed into full-blown political witch-hunt — Former Vice President Atiku

December 12, 2025
3

6 dead, 5 injured in ghastly motor accident in Anambra

November 29, 2025
4

Emefiele’s trial: I was forced to give $600,000 bribe for contract payment – Witness

May 10, 2024
5

Ibadan Electricity Distribution Company confirms kidnap of 2 staff in Ogun

May 4, 2026
6

ROMANCE GONE SOUR: My wife told me only 1 out of our 3 children is mine

April 13, 2024

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Lawyers with Disabilities urge banks to provide sign language, walkways

May 2, 2026

House rents will not reduce despite VAT removal – Stakeholders

February 17, 2026

Methodist Prelate to Tinubu: Hunger, inflation fuelling Nigeria’s insecurity

July 3, 2025

US diplomat Rubio meets Pope in bid to ease tensions

May 7, 2026
Top posts

Categories

  • News4976
  • Politics4637
  • Crime4450
  • International3076
  • Sports2487
  • Business & Economy2287
  • Headlines2234
  • Education1385
  • Matilda Showbiz999
  • Health888
  • Entertainment822
  • Africa587
  • Religion486
  • Environment374
  • Special277
  • Info Tech247
  • Arts & Culture240
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today206
  • Interview188
  • Opinion154
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade132
  • World Cup 202695
  • Advert34
  • Trends23
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge1

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact