Skip to content
Wednesday 28 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Shiooo! Sikiratu don become emergency star for TikTok

The FrontierThe FrontierAugust 8, 2026 1023 Minutes read0

Replay

Wahala no dey finish for dis our Naija. Tell me, how wahala go finish wen be say, everyday, all dis Lagos sisi dem go dey bring out sometin wey dem go take catch man.

Now na for phone e dey happen. Sisi dem go take photo, do video and post for TikTok wey dey inside phone. And di kind photo and video wey dem dey post, hmmm, na di type wey be say, if any bobo see am, e must to swallow saliva. Dem fit use am catch pastor, imam or even babalawo sef.

SDP Poster Layout

Me, wetin concern me. Na my taxi driver work I dey face. Wen I comot for our house for Abule Egba for early morning, go reach our garage wey dey near Ikeja Under Bridge, I go park my guonguoro, siddon dey wait for passenger wey I go carry for Drop or for Chatter. Na only call I dey receive with my torchlight chinko phone – no photo, no video. Wetin concern agbero with overload?

If no be say yesterday as I dey wait for passenger to come, our union member, Akpan, run come show me sometin wey e see for im iPhone.

As Akpan run dey come wia I siddon for di bench wey dey our garage, na so e dey shout, “Oga MAT! Oga MAT!! Come see your babe, e don become star for TikTok o!!!

Na so all our union member dem wey dey for garage dat morning, rush come to look wetin Akpan wan show me.

And true, true, when we look Akpan phone, come see as Sikiratu dey dance for TikTok video.

No be only dance o, na so Sikiratu dey dance dey bring out tongue like say e wan lick sometin. E go dey shake im nyansh, dey carry leg up make everybody see di yellow dross wey e wear for under di short skirt wey e wear. And na so e go dey shake di two ripe pawpaw wey dey for im chest. Tori Olorun!

As Sikiratu dey dance for di TikTok video, I use style dey look all our union member dia face.

Na so all of dem just dey swallow saliva. E be dem like say make dem break Akpan phone, open am and bring out Sikiratu and chop am

raw. Olorun Oba o!

Come see as all di bobo dem for di hole world Like, Love and Comment, as Sikiratu dey dance for di video, small remain make e dance naked.

Some of dem comment say, “Sweet Babe, I love you”, “Will you marry me?”, “Where do you live? I want to come and pay your bride price”, “Can I have you my darling in my bed this weekend?”.

I come talk am for my mind say, see girl wey dey wash plate and serve customer dem for Madam Shine Buka o. Now, e go tink say all dis bobo dem wey dey comment, love am.

No wonder Sikiratu no dey pick my call again since wen e don dey dance naked for TikTok. E tink say e don become star be dat. E tink say e don arrive so e don trowey me for gutter. Oh, my Siki Babe!

No troublem sha. But make Sikiratu make mistake go meet any of di bobo dem, na dat time e go know say khaki no be leather. E go hear nwi for dia hand. Dem go show am pepper for dia house as dat oga show dat nurse, abi doctor or na fisi…fisio…fisiote…

Abeg make una helep me complete am make I no come bite my tongue.

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
emergency starOga MATSikiratuTikTok
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post ROMANCE GONE SOUR: My husband is a drug addict, confessed he was expelled from school for cultism
next post REVEALED: Real reason Nigeria’s sensuous singer Ayra Starr was denied South African visa — Envoy
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Abuja Afrojazz Festival targets global opportunities for Nigerian musicians

October 24, 20260
Gists

Fela lives on in Kwara as state celebrates his life, legacies

October 24, 20260
Gists

BBNaija should take a break, re-strategise — Reality TV star Tacha

October 24, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

ARISE Projects Impact

February 9, 20250
Info Tech

Poor network: Reps threaten arrest warrants for telecom CEOs

October 28, 20260
Politics

NDC alleges harassment, destruction of campaign materials in Edo

October 28, 20260
Politics

APC releases supplementary list for Tinubu’s 2027 campaign council

October 28, 20260
Politics

We’ll rig those who rig 2027 elections – Peter Obi

October 28, 20260
News

Work on Lagos-Calabar Coastal Highway grounded as 600 workers go on strike

October 28, 20260
Education

University admission: House of Reps seeks more time for candidates as deadline nears

October 28, 20260
Load more

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

Poor network: Reps threaten arrest warrants for telecom CEOs

October 28, 2026

NDC alleges harassment, destruction of campaign materials in Edo

October 28, 2026

APC releases supplementary list for Tinubu’s 2027 campaign council

October 28, 2026

We’ll rig those who rig 2027 elections – Peter Obi

October 28, 2026

Work on Lagos-Calabar Coastal Highway grounded as 600 workers go on strike

October 28, 2026

ARISE Projects Impact

0 Comments

Poor network: Reps threaten arrest warrants for telecom CEOs

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

Lagos primary elections: APC stakeholders reject alleged imposition of Alimosho Rep candidate

June 6, 2026
3

How God humbled me in 2020 – Popular singer Asake

March 19, 2026
4

BREAKING: One killed in fresh Plateau attack hours after Tinubu’s visit

April 3, 2026
5

Vice President Shettima off to US as Nigerians await Tinubu’s return

May 6, 2024
6

BREAKING! Naira abuse: Cubana Chief Priest pleads not guilty, granted ₦10m bail

April 17, 2024
Popular
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

Why I wear my wife’s dress to drive passengers — Viral Ibadan Micra driver

August 27, 2024
3

Don’t bathe babies with cold water – Paediatricians tell parents

July 19, 2026
4

Lagos Ohanaeze crisis: Ogbonna dismisses Igbude group

February 26, 2026
5

2027: Olubadan cautions politicians against exploiting religion for elections

March 21, 2026
6

House of Reps intervenes in Dangote, oil workers face-off

September 29, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

REVEALED: Real reason I rejected El-Rufai as my successor – Former President Obasanjo

October 25, 2025

Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM

October 12, 2024

Donald Trump, Ukraine’s Zelensky clash in US Oval Office shouting match •VIDEO

March 1, 2025

Beyond the noise: Godswill Akpabio and the Architecture of Stability, By Eseme Eyiboh

February 17, 2026
Top posts

Categories

  • News5198
  • Politics4925
  • Crime4671
  • International3262
  • Sports2622
  • Business & Economy2394
  • Headlines2301
  • Education1459
  • Matilda Showbiz1062
  • Health975
  • Entertainment898
  • Africa623
  • Religion504
  • Environment408
  • Special279
  • Info Tech270
  • Arts & Culture245
  • Inside Akwa Ibom Today239
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview200
  • Opinion159
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade139
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact