Skip to content
Wednesday 28 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Di kind cold wey come with dis everyday rain na wa o!

The FrontierThe FrontierOctober 3, 2026 713 Minutes read0

Dis cold wey dey for Naija now get as e be. Di tin carry weight, no be small. Even di cold wey dem dey talk say e dey for Oyibo contry, na small pikin for dis Naija cold wey dey now.

I know say na di heavy rain wey dey fall every day katikati and cause flood upandan for Naija, na im bring dis cold.

Di rain dey fall for Lagos ti-ti-ti-ti, sote all di road turn to emergency lagoon, and so do cold dey catch even as I I dey nack una dis tori so. Tori Olorun!

SDP Poster Layout

Di order day, I hear one Agege market woman talk say dis cold na wintch bring am. I say na wa for Naija people o. Everyting wey happen na wintch cause am. But if na for Oyiboland, dem for find one fine woman name give di cold. Dem fit call am Katrina or Elizabeth.

Anyway sha, na we Lagos taxi driver suffer dis cold matter pass. Di cold dey show us di Good, di Bad and di OBJ…sorry, na ‘and di Ugly’ I wan talk o before my tongue come sleep. Make dis my sleeping tongue no put me for wahala one day. Helep me say Amin!

Di good ting about di cold be say, now, me and my wife Bose don dey like 5 and 6.

Wen I don close work for night, go reach our house wey dey for Abule Egba, wen I chop finish, enter bed, Bose go use style abandon our two woman pikin dem – Bisi and Funke – for parlour, come meet me for bedroom. Na so Bose go fold im body like say e dey inside ice water. E go tell me say cold don finish am. I go lock door, draw am enter bed, use heavy blanket cover di too both of us. Na so me and Bose go gum body – bie bie to bie bie – under di blanket. Before you say Jack, we don start bend-bend sleep be dat.

Dat time I go talk am for my mind say, see my wife wey no dey let me near am for bed teletele o.

To say we never dagba, Bose for don carry belle and born pikin by next year, and I for name di pikin Tutu. But sha, miracle pikin fit still happen.

Na im make I talk say dis cold na Good ting for me, and na im make I no wan make di cold go.

I no dey branch for Madam Shine buka again wen I close work for evening since wen dis cold start. After all, wetin dey for Sokoto dey for shokoto trouser.

But di Bad and di Ugly side be say, na we wey dey do taxi driver work dey suffer for dis cold pass.

Una kukuma know say people no dey baf again. If you see anybody wear suit and heavy clothe waka for road, check am well well, you go discover say di person jus wear di big clothe make cold no enter im body.

Na so inside my guonguoro dey choke now becos passenger dem no dey baf, na so so perfume dem dey pour for body – from head to toe – and na so di inside of my guonguoro go come choke gan.

Di order day, two passenger dem – one sisi and one bobo like dat – come meet me for our garage wey dey near Ikeja under bridge. Di two both of dem wear heavy suit plus tie take cover body make people tink say na one big meeting like dat dem dey go for. Dem say make I carry dem for drop go Mafoluku. I tell dem my price, dem gree. I say make dem enter. I open ignition, start engine, put am for gear one and move.

We no even climb dat flyover for railway line near Ikeja Council wen I begin cough like pussy cat. I cough sote I nearly drive go jam electric pole. Olorun maje!

Na di kind wicked perfume wey dis bobo and sisi pour for dia body as dem no baf dat morning becos of cold, na im been wan finish me so o.

Tank Eledumare say, I still manage drive dem go reach Mafoluku and collect my money. Olorun Oba o!

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994. 

Tags
coldeveryday rainOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: IKEBE, by Blaqbonez feat. Asake
next post ROMANCE GONE SOUR: My wife drank snipper, attempted suicide after I became broke and couldn’t afford her expensive lifestyle
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Abuja Afrojazz Festival targets global opportunities for Nigerian musicians

October 24, 20260
Gists

Fela lives on in Kwara as state celebrates his life, legacies

October 24, 20260
Gists

BBNaija should take a break, re-strategise — Reality TV star Tacha

October 24, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

ARISE Projects Impact

February 9, 20250
Politics

JUST IN: Court dismisses actor Emeka Ike’s N10 billion suit against FCT minister’s media aide Lere Olayinka, INEC

October 28, 20260
Sports

Seven-time Grand Slam champion Venus Williams suffers 16th straight defeat

October 28, 20260
News

FG receives 180 Nigerian returnees from Libya

October 28, 20260
International

TRAGEDY: 10 dead, many injured as two trains on high speed collide

October 28, 20260
Crime

₦1billion fundamental rights: Court fixes date for judgement in El-Rufai’s suit against ICPC, two others

October 28, 20260
Education

Over 80% students discharged, state govt investigating cause of Bilharzia drug reactions — Health commissioner

October 28, 20260
Load more

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

JUST IN: Court dismisses actor Emeka Ike’s N10 billion suit against FCT minister’s media aide Lere Olayinka, INEC

October 28, 2026

Seven-time Grand Slam champion Venus Williams suffers 16th straight defeat

October 28, 2026

FG receives 180 Nigerian returnees from Libya

October 28, 2026

TRAGEDY: 10 dead, many injured as two trains on high speed collide

October 28, 2026

₦1billion fundamental rights: Court fixes date for judgement in El-Rufai’s suit against ICPC, two others

October 28, 2026

ARISE Projects Impact

0 Comments

JUST IN: Court dismisses actor Emeka Ike’s N10 billion suit against FCT minister’s media aide Lere Olayinka, INEC

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

BREAKING: Kano Assembly passes State Police bill

October 27, 2026
3

REVEALED: Real reason US court ordered release of Tinubu drug trafficking probe report

April 14, 2025
4

Rivers crisis: 3 SDP Assembly candidates, supporters defect to APC

January 11, 2024
5

800 Ebonyi indigenes trapped in Lagos return home

March 17, 2025
6

Borrowing: 34% interest rate stifling investments, food production – Senator Lawan laments

December 30, 2024
Popular
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

Customs officers kick against plan to halt implementation of new promotion scheme

October 29, 2023
3

British independent school in Lagos, Charterhouse opens new hostel for pupils

September 18, 2025
4

Refineries not created to reduce petrol price – Kyari tells Senate

December 8, 2023
5

Ibadan meeting: Atiku, Peter Obi, Kwankwaso still have opportunity for grand alliance — ADC chieftai Ologbondiyan

August 9, 2026
6

Oil output rise falls short of Nigeria’s 2026 budget target

October 27, 2026

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

Army passes out over 3,000 recruits to boost national security

July 8, 2026

Samsung office building collapses in Abuja

December 3, 2024

Ondo Assembly passes State Police bill

October 26, 2026

Punish politicians in early election campaigns – SERAP tells INEC

September 15, 2025
Top posts

Categories

  • News5195
  • Politics4919
  • Crime4671
  • International3260
  • Sports2622
  • Business & Economy2394
  • Headlines2300
  • Education1458
  • Matilda Showbiz1062
  • Health975
  • Entertainment897
  • Africa623
  • Religion504
  • Environment407
  • Special279
  • Info Tech269
  • Arts & Culture245
  • Inside Akwa Ibom Today239
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview200
  • Opinion159
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade139
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact