Skip to content
Wednesday 8 July 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Guonguoro for sale

The FrontierThe FrontierApril 13, 2024 2962 Minutes read0

Next month go be one year wey everyting for Naija don turn upside down. Man go go right, noting. Go left, noting. Passenger full everywia but no money for pocket to use enter taxi. Shey person wey no see money buy food chop go begin enter taxi?

Now, dem dey tell us say make we get small patience, say price of everyting go soon come down. I know say dat one na tori. Lori iro! Shey, dis our contry wey you know, anyting wey go up don ever come down?

Una go don see say I don vex well well. Why I no go vex? Since last year, to buy petrol put for my guonguoro take work na wahala becos price jus jump up one time like frog. Dem dey tell us subsidy dis, subsidy dat. Subsidy ko, palliative ni.

Ordinary engine oil wey I dey buy take top my engine don become gold. Spare part nko? Dat one na no go area. See my guonguoro wey I dey maintain like baby teletele since wen I start dis my taxi driver work, now di ting look like one kind old mama like dat. Tori Olorun!

Shey, na like dis I go take give my family food? Na like dis I go take pay house rent for Baba Braimoh face-me-I-face-you house wey I dey live with my family for Abule Egba? Na like dis I go take send my two woman pikin – Bisi and Funke – go uniservity?

Yesterday evening, I go drop one passenger like dat for Onigbongbo near Maryland, before I come back for our garage wey dey near Ikeja under bridge, night don show face. Na im I say make I jus branch Madam Shine buka near Airport hotel, go take My Usual calm down small.

As I take My Usual, na so so tink I dey tink. I no even follow anybody talk, even Sikiratu sef. Na wen I take bottle number 4, I look time, I come see say 10 O’clock pm in di night don nearly nack. Na so I pay money kia kia, jump inside my guonguoro and begin drive dey go my house.

Wen I reach house sef, na so I off engine, lock all di door, enter house. I no even baf sef, I no eat, I no comot my clothe, I jus jump inside bed straight.

But to see sleep, for wia. Na so, so tink I dey tink sote I no know wen my wife Bose come lie down with me. As I no gree answer am, Bose sleep lef me.

Di ting wey I don decide as I tink troughout di night be say, I go write “For sale”, add my phone number, and paste am for di body of my guonguoro. If I get lucky and person pay me beta money, I go use di money take start anoder business.

But which kind business I wan do apart from taxi driver work as I don dagba finish so? I no know. And who wan buy dis my guonguoro? I no know.

Sha, Eledumare dey.

Make we jam again next Saturday.

Tank you,

Tank you very much,

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigerian media, since 1994.

Tags
guonguoroOga MATsale
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM
next post Hot Lyrics: TAYA, By D’banj, Zlatan & Timaya
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Matilda Showbiz

Weda or wedan’t dem like am, na my turn be dis

July 4, 20260
Matilda Showbiz

Players with most goals at 2026 World Cup so far •FULL LIST

July 4, 20260
Gists

I enjoy watching Rema, Burna Boy perform, says US Envoy Keith Heffern

July 4, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Politics

Senator dumps ADC for APM, cites internal crisis

July 7, 20260
Crime

ICPC accuses former Governor El-Rufai of breaching medical visit, arrests personal doctor

July 7, 20260
News

JUST IN: House of Reps issues final summons to Accountant-General over snub, threatens sanctions

July 7, 20260
News

Regulatory Commission has transferred power sector oversight to 16 states — Chairman

July 7, 20260
Africa

African Energy Week 2026: Wale Tinubu, Nosa Omorodion and Nigeria’s expanding influence in Africa’s energy future

July 7, 20260
Africa

Xenophobic attacks: Senate rejects tough retaliatory measures against South Africa

July 7, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Senator dumps ADC for APM, cites internal crisis

July 7, 2026

ICPC accuses former Governor El-Rufai of breaching medical visit, arrests personal doctor

July 7, 2026

JUST IN: House of Reps issues final summons to Accountant-General over snub, threatens sanctions

July 7, 2026

Regulatory Commission has transferred power sector oversight to 16 states — Chairman

July 7, 2026

African Energy Week 2026: Wale Tinubu, Nosa Omorodion and Nigeria’s expanding influence in Africa’s energy future

July 7, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Senator dumps ADC for APM, cites internal crisis

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Again, Trump fined $10,000 for violating gag order

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Governor Fintiri okays N70,000 minimum wage for Adamawa workers

August 19, 2024
3

JUST IN: Rivers House of Assembly complex demolished •Gov Fubara presents budget at Govt House

December 13, 2023
4

Women find men with larger penis size more attractive – Scientists discover

March 31, 2026
5

Osimhen scores as Galatasaray win Turkish League, second trophy in 5 days

May 19, 2025
6

INSIDE AKWA IBOM TODAY: Health minister, Ali Pate commissions Gov Eno’s healthcare projects

March 2, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Court bars Police, FRSC from fining motorists over insurance

April 24, 2026
3

INEC rejects Abure as Labour Party’s national chairman

September 18, 2024
4

FG deploys troops to Benin Republic in regional anti-terror push

May 19, 2026
5

2 killed, wedding guests kidnapped as bandits launch attack in Katsina

January 12, 2026
6

The 411 Nigerians killed scooping fuel in 2024

September 2, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Nigeria to force hospitals to treat gunshot victims, says health ministry

February 7, 2024

Atiku to Tinubu: Explain NNPCL $3.3billion loan

January 26, 2024

Lies, deceit, corruption, can’t improve citizens’ welfare — Nigerians tell Tinubu

January 6, 2026

How police rescued me after 30 minutes gun duel in Abuja – Victim

September 19, 2025
Top posts

Categories

  • News4726
  • Politics4364
  • Crime4153
  • International2886
  • Sports2361
  • Business & Economy2202
  • Headlines2137
  • Education1319
  • Matilda Showbiz944
  • Health838
  • Entertainment774
  • Africa537
  • Religion470
  • Environment346
  • Special267
  • Info Tech233
  • Arts & Culture230
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today191
  • Interview181
  • Opinion150
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade124
  • World Cup 202651
  • Advert31
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Trends19
  • Local News5

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact