Skip to content
Wednesday 9 September 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

I no dey for Keresimesi day, I don travel

The FrontierThe FrontierDecember 21, 2024 2832 Minutes read0

Dem dey talk am say body no be wood. And na true talk.

You sef check am nah. Everyday di son of man dey for Lagos road 24/7, dey carry passenger dem upadan.

And na orisirisi tings I dey see for road – di good, di bad, and di OBJ (sorry, abeg no vex. I been wan say “…and di ugly”, but my tongue come sleep. If na lie I talk, make I baf naked for bafroom. Make una helep me wake up dis my tongue before e land me for wahala).

As I been dey talk am tele tele before my tongue sleep, I dey see orisirisi tings for Lagos road in di curse (Olorunmaje) of dis my taxi driver work.

Shey na amu robber dem we go talk, abi na all dis Lagos sisi dem wey go enter my guonguoro for night but begin dey find anoder ting becos dem no wan pay? Dem go tell you say dem wan pay in kind instead of cash. And dem ready to do anyting for you to park for roadside and do dem kini inside di guonguoro. Tori Olorun!

Gbomo gbomo and Area Boy dem nko?

All di orisirisi uniform people sef dey dia o, and dem kukuma plenty – Soja o, Olopa o, Road Safety o, Maja Maja o, LASMA o, Council o – all of dem dey lay ambush for road.

Even VIO dem dey dia. Dose one na wintch, dem no dey leave person. If you like, make eveyting complete for your motor, dem must still find somtin to take catch you. No be wintch be dat?

My broda, e no easy at all, at all. Na im make I dey always tank Eledumare any time I reach house every day.

Dat’s why I don decide say, for Keresimesi day gan gan, I no go jus show face for our garage wey dey near Ikeja under bridge. And I no go dey for my house for Abule Egba. No ask me wia I go dey.

Di only ting I fit tell you small for now be say, Sikiratu don already call me from im village wey e travel go see im Mama. E say e must land Lagos tomorrow. E say e don already book online di short time wia di two both of us go dey for Keresimesi day.

But dis ting wey I tell you so na secret o, na confidential matter between me and you. No let my wife Bose, and my two woman pikin dem – Bisi and Funke – hear am o.

I go still tell una how me and Sikiratu take waka.

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
Keresimesi dayOga MATtravel
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM
next post ROMANCE GONE SOUR: I no longer love my husband
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

REVEALED: Why my mother never saw me perform on stage before her death – Music star Mr. Eazi

September 5, 20260
Gists

BBNaija star Tacha breaks silence after arrest over alleged N5 million fraud

September 5, 20260
Matilda Showbiz

I don tire, I dey go back to my village

September 5, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Education

Certificate fraud: FG, NYSC move to link education records

September 9, 20260
News

Kara Bridge repairs cripple Lagos-Ibadan Expressway

September 9, 20260
Politics

Atiku, Tinubu’s loyalists bicker over govt policies, criminal records

September 9, 20260
News

Aviation Authority threatens to sanction airlines over non-compliance with rules

September 9, 20260
Entertainment

Top Nigerian comedians Seyi Law, Ambassador Waahala, others to dazzle fans at “The Pensioner” show in Abuja

September 9, 20260
Politics

2027: Staple food will be abundant if Nigerians elect me president – SDP presidential candidate Adebayo •VIDEO

September 9, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Certificate fraud: FG, NYSC move to link education records

September 9, 2026

Kara Bridge repairs cripple Lagos-Ibadan Expressway

September 9, 2026

Atiku, Tinubu’s loyalists bicker over govt policies, criminal records

September 9, 2026

Aviation Authority threatens to sanction airlines over non-compliance with rules

September 9, 2026

Top Nigerian comedians Seyi Law, Ambassador Waahala, others to dazzle fans at “The Pensioner” show in Abuja

September 9, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Certificate fraud: FG, NYSC move to link education records

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

N4.6billion security fund shared to organise prayers against insecurity – EFCC witness

January 31, 2024
3

Haaland a doubt for Man City showdown with Liverpool

February 21, 2025
4

Manchester United beaten by former boss Amorim’s AC Milan in friendly finale

August 16, 2026
5

Unpaid entitlements: 183 ex-Niger Delta militants sue FG, PAP

March 18, 2024
6

Woman who tore husband’s passport at airport finally opens up

August 12, 2024
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

EU agrees to implement US trade pact after Trump threats

May 20, 2026
3

Chief Judge saga: Benue Assembly slams 3 months suspension on 13 lawmakers •FULL LIST

February 20, 2025
4

We’re hungry, end protests – Street beggars in Kano cry out

August 8, 2024
5

BREAKING: Supreme Court nullifies Rivers LG elections

February 28, 2025
6

Tinubu meets with Prince Harry in UK

March 18, 2026

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Osun 2026: APC governorship aspirant Omisore makes U-turn, embraces Oyebamiji as consensus candidate

December 11, 2025

Microsoft develops AI reasoning models to rival open AI

March 12, 2025

Court declines ex-CBN Governor Emefiele’s request for UK medical trip

July 16, 2024

BREAKING: Court orders interim forfeiture of 57 property belonging to former justice minister Malami

January 7, 2026
Top posts

Categories

  • News5007
  • Politics4673
  • Crime4470
  • International3100
  • Sports2506
  • Business & Economy2305
  • Headlines2239
  • Education1393
  • Matilda Showbiz1007
  • Health895
  • Entertainment831
  • Africa595
  • Religion486
  • Environment376
  • Special278
  • Info Tech247
  • Arts & Culture240
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today211
  • Interview188
  • Opinion154
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade133
  • World Cup 202695
  • Advert35
  • Trends23
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge2

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact