Skip to content
Saturday 17 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

I don tire, I dey go back to my village

The FrontierThe FrontierSeptember 5, 2026 973 Minutes read0

Di way dis our Naija be now, everybody don get sense by force. Since wen Emilokan carry price of petrol hang for up, we wey dey do taxi driver work don hear nwi.

If na only petrol, e for good small sef, but spare parts nko? Even to service motor na helele.

Na im make I dey always hold my guonguoro like egg make e no just drop for ground. If di ting spoil, dat one mecho dem go take me do ntanta.

SDP Poster Layout

I tank Eledumare for di passenger wey I carry yesterday. Di bobo come our garage wey dey near Ikeja under bridge, e say make I carry am for drop go Apapa Wharf. I tell am my price, e say no troublem, say make I just carry am dey go kia kia, say e dey for hurry.

Na so we begin dey go. As we dey go, di bobo dey make call, dey tell person say make e no comot for Wharf, say e dey road and e go reach Wharf in 10 minutes.

Dat time we never even pass Police College for Ikeja o. Tori Olorun!

I talk am for my mind say shioooor, some people sabi lie no be small. I say dis man name go be Linus or Lai sombori. Even if na aeroplane e take, how e go reach Apapa Wharf in 10 minutes wen e never comot for Ikeja? Olorun Oba ooo!

Na as we dey go for road, di man come talk say e dey rush go meet somebody wey dey wait for am for inside Apapa Wharf to sell empty container for am, say di man don dey wait for am tipe tipe and di man say e no fit wait again as time don dey go.

E say e no wan miss dat empty container, say e wan use am do house becos im landlord give am quit notice make e comot dis month end. E say e don tire to pay house rent to Lagos landlord dem, so e wan use di empty container do house wey e go stay with im family.

E also talk am say di water wey e dey buy for Aboki hand everyday don even pass di house rent becos im landlord no dey gree pump water for borehole, even wen e dey collect money from all di tenant dem every month to take pump water.

I ask am weda dem dey use empty container do house. Di bobo say make I siddon dia, say wen e finish to design di empty container turn am to flat, nobody go know say na empty container e take do house.

As we reach Wharf, di bobo pay me and begin run inside Wharf. I revise my guonguoro, begin dey go back.

I come begin dey tink wetin dat my passenger talk. If I fit use empty container do flat, why I still dey pay house rent for Baba Braimoh face-me-I-face-you house wey I dey live with my family for Abule Egba? And na every year Baba Braimoh dey increase di rent money.

If I tell una di kind money wey I dey pay Baba Braimoh for di small room and parlour wey we dey stay, you no go believe lai lai.

Na im I come talk say, I don tire to pay all dis Lagos landlord dem money for house rent wey dem dey increase anytime dem turn body. If I buy empty container carry go my village for Ogbomoso, go design am and turn am to flat like dat my passenger, sebi I don get my own house be dat. And I go dey for dia with my family dey do my taxi driver work, as landlord, abi na containerlord.

Anyway sha, weda na landlord or na containerlord, lord na lord.

Abi, how you see am?

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
my villageOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Arsenal loanee Nwaneri helps Dortmund to comeback win on Bundesliga debut
next post BBNaija star Tacha breaks silence after arrest over alleged N5 million fraud
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Matilda Showbiz

Hot Lyrics: TREAT U RIGHT, by FOLA & Ayra Starr

October 17, 20260
Matilda Showbiz

Nigeria’s Top 10 Songs with ITTY OKIM •Week 38

October 17, 20260
Gossips

My wife knew I dated actresses, yet didn’t fight them – Yoruba actor Yinka Quadri

October 10, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Matilda Showbiz

Hot Lyrics: TREAT U RIGHT, by FOLA & Ayra Starr

October 17, 20260
Matilda Showbiz

Nigeria’s Top 10 Songs with ITTY OKIM •Week 38

October 17, 20260
Sports

Super Eagles forward Iheanacho reacts after making history in Turkey

October 17, 20260
Interview

How I regained sight 27 years after — Man who went blind at age 3 narrates

October 17, 20260
Opinion

Coalition of Parastatals CEOs: A masterstroke for Tinubu’s re-election, By Omonu Nelson

October 17, 20260
Sports

Former Nigeria’s Super Eagles coach Westerhof hospitalised, diagnosed with cancer

October 17, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Hot Lyrics: TREAT U RIGHT, by FOLA & Ayra Starr

October 17, 2026

Nigeria’s Top 10 Songs with ITTY OKIM •Week 38

October 17, 2026

Super Eagles forward Iheanacho reacts after making history in Turkey

October 17, 2026

How I regained sight 27 years after — Man who went blind at age 3 narrates

October 17, 2026

Coalition of Parastatals CEOs: A masterstroke for Tinubu’s re-election, By Omonu Nelson

October 17, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Hot Lyrics: TREAT U RIGHT, by FOLA & Ayra Starr

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Ebonyi land dispute: Hoodlums burn excavator used for boundary demarcation

May 23, 2025
3

Eko Hotel chefs unveil Africa’s largest Christmas cake

December 26, 2023
4

Shock as National Population Commission chairman dies eight months after assuming office

August 28, 2026
5

Russia ready for talks with Trump on Ukraine – President Putin

January 24, 2025
6

Fully loaded truck falls off Lagos bridge, crashes on bus station

October 26, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

AFCON: Ivory Coast were better than us – Nigeria’s coach, Peseiro

February 12, 2024
3

Today’s elections test for APC, ADC, NNPP, 15 other parties in Abuja, Kano, Rivers

February 21, 2026
4

Rivers crisis: PDP NWC calls for calm, begins resolution

October 31, 2023
5

UK Prime Minister Starmer shakes up top team after deputy Rayner quits

September 6, 2025
6

Polytechnic shutdown after students’ protest

January 20, 2026

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Bandits invade school, kidnap principal, NECO supervisor, students writing exam

July 15, 2026

UN designates African slave trade as gravest crime against humanity

March 26, 2026

US Embassy begins screening Nigerian students’ social media accounts

July 8, 2025

Why love alone is too small to keep relationship — Nollywood actress Oyindamola Sanni

February 15, 2026
Top posts

Categories

  • News5155
  • Politics4866
  • Crime4621
  • International3227
  • Sports2595
  • Business & Economy2378
  • Headlines2288
  • Education1450
  • Matilda Showbiz1049
  • Health944
  • Entertainment887
  • Africa616
  • Religion500
  • Environment403
  • Special279
  • Info Tech265
  • Arts & Culture244
  • Inside Akwa Ibom Today233
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview198
  • Opinion159
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade137
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact