Skip to content
Tuesday 12 May 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

I don tire, I dey go back to my village

The FrontierThe FrontierMarch 8, 2025 2113 Minutes read0

Di way dis our Naija be nah, everybody don get sense by force. Since wen Babablu carry price of petrol hang for up, we wey dey do taxi driver work don hear nwi.

If na only petrol, e for good small sef, but spare parts nko? Even to service motor na helele.

Na im make I dey always hold my guonguoro like egg make e no just drop for ground. If di ting spoil, dat one mecho dem go take you do ntanta.

I tank Eledumare for di passenger wey I carry yesterday. Di bobo come our garage wey dey near Ikeja under bridge, e say make I carry am for drop go Apapa Wharf. I tell am my price, e say no troublem, say make I just carry am dey go kia kia, say e dey for hurry.

Na so we begin dey go. As we dey go, di bobo dey make call, dey tell person say make e no comot for Wharf, say e dey road and e go reach Wharf in 10 minutes.

Dat time we never even pass Police College for Ikeja o. Tori Olorun!

I talk am for my mind say shioooor, some people sabi lie no be small. I say dis man name go be Linus. Even if na aeroplane e take, how e go reach Apapa Wharf in 10 minutes wen e never comot for Ikeja?

Na as we dey go for road, di man come talk say e dey rush go meet somebody wey dey wait for am for inside Apapa Wharf to sell empty container for am, say di man don dey wait for am tipe tipe and di man say e no fit wait again as time don dey go.

E say e no wan miss dat empty container, say e wan use am do house becos im landlord give am quit notice make e comot dis month end. E say e don tire to pay house rent to Lagos landlord dem, so e wan use di empty container do house wey e go stay with im family.

I ask am weda dem dey use empty container do house. Di bobo say make I siddon dia, say wen e finish to design di empty container turn am to flat, nobody go know say na empty container e take do house.

As we reach Wharf, di bobo pay me and begin run inside Wharf.

I revise my guonguoro, begin dey go back.

I come begin dey tink wetin dat my passenger talk. If I fit use empty container do flat, why I still dey pay house rent for Baba Braimoh face-me-I-face-you house wey I dey live with my family for Abule Egba? And na every year Baba Braimoh dey increase di rent money.

If I tell una di kind money wey I dey pay Baba Braimoh for di small room and parlour wey we dey stay, you no go believe lai lai.

Na im I come talk say, I don tire to pay all dis Lagos landlord dem money for house rent wey dem dey increase anytime dem turn body. If I buy empty container carry go my village for Ogbomoso, go design am and turn am to flat like dat my passenger, sebi I don get my own house be dat. And I go dey for dia with my family dey do my taxi driver work.

How you see am?

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
I dey go backI don tiremy villageOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Former Governor Dickson leads opposition senators on visit to suspended Natasha
next post Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM •Week 10
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gossips

Adekunle Gold, Seyi Vibez clash over ‘Fuji Moto’ controversy •Fans react

May 9, 20260
Gists

BBNaija star Ilebaye in hospital, father arrested for assault – Police

May 9, 20260
Gists

Real reason I don’t like listening to Burna Boy’s songs – Nigerian singer Mr. Eazi

May 9, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Sports

Flick extends contract with Barcelona

May 12, 20260
Health

Egg freezing is not a guarantee of pregnancy — Aproko Doctor

May 12, 20260
Education

Kidnapped varsity students regain freedom

May 12, 20260
Health

Lagos health sector suffers 33,000 doctors shortfall – Commissioner

May 12, 20260
News

JUST IN: Nigeria’s School of Eloquence smashes Guinness World Record in speech marathon

May 12, 20260
Education

JAMB: 29 less competitive courses in Nigeria in 2026 and their cut-off marks •FULL LIST

May 12, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Flick extends contract with Barcelona

May 12, 2026

Egg freezing is not a guarantee of pregnancy — Aproko Doctor

May 12, 2026

Kidnapped varsity students regain freedom

May 12, 2026

Lagos health sector suffers 33,000 doctors shortfall – Commissioner

May 12, 2026

JUST IN: Nigeria’s School of Eloquence smashes Guinness World Record in speech marathon

May 12, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Flick extends contract with Barcelona

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Again, Trump fined $10,000 for violating gag order

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Weather forecast: Expect 3 days thunderstorms, heavy rain – NiMet

August 22, 2025
3

Atletico have big opportunity against Real Madrid – Coach Simeone

March 3, 2025
4

Why I hate Mohbad more in death – Naira Marley’s associate

April 27, 2024
5

Betta Edu: EFCC recovers N30 billion, probes 50 bank accounts

April 9, 2024
6

Governor Uzodimma, Oba Akiolu, others storm Lagos, honour founding fathers at Eyo Festival

December 28, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Alleged defamation: Senate President Akpabio’s wife slams N350 billion suit against Senator Natasha

March 1, 2025
3

G20 leaders inaugurate global alliance to end hunger

November 19, 2024
4

Panic as fire burns down sections of Kano Hospital

December 13, 2025
5

Okada rider stabbed to death in Abuja

October 17, 2025
6

Sponsors of planned protests don’t love Nigeria, have alternative passports – Tinubu

July 26, 2024

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Allow independent marketers to lift petrol – Reps charge NNPC, Dangote refinery

September 26, 2024

South Africa’s ex-parliament speaker arrested in graft probe

April 4, 2024

International Women’s Day: Time to move beyond promises in women empowerment – Commissioner

March 7, 2025

Hantavirus cases rise to 8, including 3 deaths •WHO issues advisory

May 9, 2026
Top posts

Categories

  • News4528
  • Politics4025
  • Crime3861
  • International2716
  • Sports2236
  • Business & Economy2107
  • Headlines2065
  • Education1245
  • Matilda Showbiz884
  • Health792
  • Entertainment724
  • Africa453
  • Religion446
  • Environment318
  • Special261
  • Arts & Culture226
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Info Tech218
  • Interview176
  • Inside Akwa Ibom Today172
  • Opinion145
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade116
  • Advert30
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Trends16
  • Local News4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact