Skip to content
Friday 4 September 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Lagos sisi dem don bring anoder banger (2)

The FrontierThe FrontierJuly 19, 2025 1522 Minutes read0

…Continued from last Saturday

As di two sisi dem wey siddon for di backseat of my guonguoro dey nack dia tori, me, I jus dey do like say I too concentrate for steering, like say I no hear anyting wey dem dey talk.

Di yellow sisi say e been dey carry hot Agbo for head dey waka everywia dey sell teletele, but one day, e come siddon dey tink weda na Agbo e go dey sell all im life. E say weda na di chechere money wey e dey get e go take do beta ting for life. E say na im e come stop to dey sell Agbo. E say now, everyday, e go jus buy recharge card, take call all di bobo dem wey im know. E go tell dem say e dey hungry, e never chop since morning. E go do like say di hungry dey worry am well well.

If e call like 10 bobo, no how no how, dem go wire 5k to im account each. Dat na 50k for one day o. Anoder day e go call anoder 10, and so on and so on. Check how much e dey make every month.

Di second sisi come dey talk im own. E say im own trap for bobo dem na banger. E say na everyday im Mama dey die – Mama wey don peme since wen di sisi be 2 year old o.

E come talk say, everyday, e go call bobo dem one by one, begin cry and tell dem say e receive message from village say im Mama jus peme and e wan travel.

E say na di bobo dem go dey beg am make e no cry, dem go begin wire money to am. Some go wire 20k, some 50k, some 100k sef. Dat one na only for one day o.

Anoder day e go call anoder set of bobo dem. Check di money e dey make every month.

And wen two months don pass, e go begin call dem again say burial don reach. Na so money go dey drop again like rain.

Wen we reach Balogun market, dem come down for car park. I look time, 10 O’clock am in di morning don nack. Na so I wait ti-ti-ti-ti until 2 O’clock pm in di afternoon nack wen Aboki dem carry all di tings wey di two sisi buy for market come.

My broder, if you see di orisirisi tings wey dis two sisi buy, governor wife sef no fit buy am. Dis na sisi dem wey no dey do any work o, only to set trap for bobo dem.

I open my guonguoro boot, dem put all di load. Di load wey no fit enter boot, dem put am for seat inside.

As I dey drive dem back to Ikeja, I jus dey talk am for mind say make Eledumare save man pikin dem for dis Lagos.

Helep me say Amin!

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
(2)bangerLagosOga MATsisi
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Two women, three men shot dead in South Africa bar
next post Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM •Week 29
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Interview

I’ll live forever through my music — Prolific singer and producer Pheelz

August 29, 20260
Gists

Funke Akindele is kind, generous despite strict nature – Nollywood actress Ronke Oshodi-Oke

August 29, 20260
Gists

BBNaija Season 11: Your peace call not convincing – Nomy tells Tram

August 29, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Politics

2027: Peter Obi, Falana, ADC, others raise alarm over electoral credibility

September 4, 20260
News

TRAGEDY: Bride-to-be, housemate killed in midnight building collapse

September 4, 20260
Entertainment

Art gallery opens exhibition in Lagos

September 4, 20260
Crime

‘Fake’ Presidential Council scandal: Court declines Adeyemi’s bail, medical attention request

September 4, 20260
Entertainment

Why I still turn down roles today — Popular comedian Bovi

September 4, 20260
Crime

Defence minister to governors: Stop giving motorcycles as palliatives

September 4, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

2027: Peter Obi, Falana, ADC, others raise alarm over electoral credibility

September 4, 2026

TRAGEDY: Bride-to-be, housemate killed in midnight building collapse

September 4, 2026

Art gallery opens exhibition in Lagos

September 4, 2026

‘Fake’ Presidential Council scandal: Court declines Adeyemi’s bail, medical attention request

September 4, 2026

Why I still turn down roles today — Popular comedian Bovi

September 4, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

2027: Peter Obi, Falana, ADC, others raise alarm over electoral credibility

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Osun governorship election: INEC seeks media support against vote buying

June 30, 2026
3

Latest on Labour Party crisis: Abure lied, didn’t remit ‘N1,000 challenge’ donations – Aisha Yesufu

September 10, 2024
4

Lagos govt sanctions 580 nightclubs, restaurants over indoor smoking

May 22, 2025
5

Gov Makinde, Ladoja break silence on controversies surrounding nomination of Olubadan-designate

April 10, 2024
6

6-day farewell, funeral service for ex-US President Jimmy Carter begins today

January 4, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Rat grounds national airline for 3 days, sparks concerns

February 27, 2024
3

18-year-old boy allegedly kills cousin for ritual

November 9, 2025
4

Nigeria’s equities market slumps, sheds N73 billion

June 12, 2026
5

10 common mistakes Muslims make during Ramadan

March 11, 2024
6

UK Prime Minister Starmer unveils plan to ease hospital backlogs

January 6, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

We’re awaiting Akeredolu’s family for briefing on burial — Gov Aiyedatiwa

January 21, 2024

Councillorship by-elections in three wards conducted across Lagos

June 24, 2026

Afriq System boss sent to prison over alleged $854.4m, N590m fraud

June 10, 2025

RUNWAY NIGHTMARES: What happened to billions spent on Enugu Airport in 16 years?

April 26, 2025
Top posts

Categories

  • News4985
  • Politics4649
  • Crime4457
  • International3082
  • Sports2489
  • Business & Economy2291
  • Headlines2237
  • Education1387
  • Matilda Showbiz999
  • Health889
  • Entertainment826
  • Africa588
  • Religion486
  • Environment375
  • Special277
  • Info Tech247
  • Arts & Culture240
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today208
  • Interview188
  • Opinion154
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade132
  • World Cup 202695
  • Advert34
  • Trends23
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge1

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact