Skip to content
Friday 30 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Lagos sisi dem don bring anoder banger (2)

The FrontierThe FrontierJuly 19, 2025 1772 Minutes read0

…Continued from last Saturday

As di two sisi dem wey siddon for di backseat of my guonguoro dey nack dia tori, me, I jus dey do like say I too concentrate for steering, like say I no hear anyting wey dem dey talk.

Di yellow sisi say e been dey carry hot Agbo for head dey waka everywia dey sell teletele, but one day, e come siddon dey tink weda na Agbo e go dey sell all im life. E say weda na di chechere money wey e dey get e go take do beta ting for life. E say na im e come stop to dey sell Agbo. E say now, everyday, e go jus buy recharge card, take call all di bobo dem wey im know. E go tell dem say e dey hungry, e never chop since morning. E go do like say di hungry dey worry am well well.

SDP Poster Layout

If e call like 10 bobo, no how no how, dem go wire 5k to im account each. Dat na 50k for one day o. Anoder day e go call anoder 10, and so on and so on. Check how much e dey make every month.

Di second sisi come dey talk im own. E say im own trap for bobo dem na banger. E say na everyday im Mama dey die – Mama wey don peme since wen di sisi be 2 year old o.

E come talk say, everyday, e go call bobo dem one by one, begin cry and tell dem say e receive message from village say im Mama jus peme and e wan travel.

E say na di bobo dem go dey beg am make e no cry, dem go begin wire money to am. Some go wire 20k, some 50k, some 100k sef. Dat one na only for one day o.

Anoder day e go call anoder set of bobo dem. Check di money e dey make every month.

And wen two months don pass, e go begin call dem again say burial don reach. Na so money go dey drop again like rain.

Wen we reach Balogun market, dem come down for car park. I look time, 10 O’clock am in di morning don nack. Na so I wait ti-ti-ti-ti until 2 O’clock pm in di afternoon nack wen Aboki dem carry all di tings wey di two sisi buy for market come.

My broder, if you see di orisirisi tings wey dis two sisi buy, governor wife sef no fit buy am. Dis na sisi dem wey no dey do any work o, only to set trap for bobo dem.

I open my guonguoro boot, dem put all di load. Di load wey no fit enter boot, dem put am for seat inside.

As I dey drive dem back to Ikeja, I jus dey talk am for mind say make Eledumare save man pikin dem for dis Lagos.

Helep me say Amin!

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
(2)bangerLagosOga MATsisi
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Two women, three men shot dead in South Africa bar
next post Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM •Week 29
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Abuja Afrojazz Festival targets global opportunities for Nigerian musicians

October 24, 20260
Gists

Fela lives on in Kwara as state celebrates his life, legacies

October 24, 20260
Gists

BBNaija should take a break, re-strategise — Reality TV star Tacha

October 24, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

ARISE Projects Impact

February 9, 20250
Sports

Super Eagles striker Victor Osimhen welcomes second child with Cameroonian-German girlfriend

October 30, 20260
Sports

Everton beat Newcastle 3-1 to reach League Cup quarter-finals

October 30, 20260
Business & Economy

Seven modular refineries to begin operations in 2027

October 30, 20260
Politics

BREAKING: INEC delists some initially cleared candidates for 2027 elections

October 30, 20260
Crime

National Assembly targets December for state police law as 30 states back reform

October 30, 20260
Education

Lawmakers clash over one-year tuition waiver for federal students

October 30, 20260
Load more

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

Super Eagles striker Victor Osimhen welcomes second child with Cameroonian-German girlfriend

October 30, 2026

Everton beat Newcastle 3-1 to reach League Cup quarter-finals

October 30, 2026

Seven modular refineries to begin operations in 2027

October 30, 2026

BREAKING: INEC delists some initially cleared candidates for 2027 elections

October 30, 2026

National Assembly targets December for state police law as 30 states back reform

October 30, 2026

ARISE Projects Impact

0 Comments

Super Eagles striker Victor Osimhen welcomes second child with Cameroonian-German girlfriend

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

2024 budget: Tinubu may present Supplementary bill — Finance Minister

December 11, 2023
3

Customs, soldiers brutalise residents over video recording

December 3, 2024
4

BREAKING: No survivors as helicopter carrying tourists crashes

August 19, 2026
5

Dessers on target as Nigeria beat Ghana in Unity Cup

May 29, 2025
6

DIA gets court order to detain policeman, 19 others for terrorism

August 28, 2024
Popular
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

Hunger protest: Group reveals take-off points in Ogun, asks Governor Abiodun to provide buses

July 31, 2024
3

Quit South West forests now or die – Gani Adams, Yoruba leaders warn Boko Haram, ISWAP terrorists

January 26, 2025
4

JUST IN: Jigawa governor loses mother

December 25, 2024
5

Late Army chief Lagbaja did not enjoy life outside military – Family head

November 12, 2024
6

Nigerians issued 300,000 UK visas in recent years — High commissioner

December 9, 2024

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

INEC yet to receive 2027 election funds few days to deadline •Delay might affect preparation – Commission

June 26, 2026

CAF, NewWorld TV sign broadcast deal ahead of AFCON 2024

December 26, 2023

INSIDE AKWA IBOM TODAY: Let the poor breathe! By Umo Eno

September 16, 2025

Major shakeup in the Army imminent following Lagbaja’s death •Top Generals for redeployment

November 7, 2024
Top posts

Categories

  • News5202
  • Politics4941
  • Crime4676
  • International3267
  • Sports2627
  • Business & Economy2398
  • Headlines2303
  • Education1462
  • Matilda Showbiz1062
  • Health975
  • Entertainment898
  • Africa624
  • Religion505
  • Environment408
  • Special279
  • Info Tech271
  • Arts & Culture245
  • Inside Akwa Ibom Today239
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview200
  • Opinion160
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade139
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact