Skip to content
Friday 25 September 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

See me, see wahala dis new year

The FrontierThe FrontierJanuary 13, 2024 3922 Minutes read0

Di kind wahala wey man pikin dey see for dis our taxi driver work everyday, I don dey tink dis new year weda or wedant make I stop di work.

But di ting be say, if I say make I no do taxi driver work again, na wetin I go come dey do as I don dagba finish?

Since 1965 wen I run comot for my village for Ogbomoso come Lagos, I first be mecho apprentice, after dat, na taxi driver work I dey do till today.

Na di work I do take marry my wife, Bose, den we come born our two woman pikin dem – Bisi and Funke. Na di work I dey do get money to pay house rent for dat Baba Braimoh face-me-I-face-you house wey we dey live for Abule Egba.

Na di work I dey do wey I dey take feed my family, take care of dem and pay my two pikin school fees. Shey na now I go come change work?

Wetin my mouth see yesterday morning, my eye no fit talk am.

I comot for house, put my guonguoro for road dat early morning say make I begin drive go our garage wey dey near Ikeja under bridge, as I jus reach Pen Cinema, na im one sisi stop me. E say make I go drop am for Ogba. I tell am how much e go pay, e gree. I say make e enter. Di sisi enter front seat. Na so we begin dey go.

Di sisi open im hand bag, bring out mirror, eye pencil, lips stick, comb. Na so e begin paint im face dat early morning. I sure say na man house wey e go do night shift, e from come so.

Di next ting be say, e carry im blouse up, di two paw paw wey dey im chest show, di ting jus point like say e wan enter my eye. E say e forgot im bra for wia e go sleep. I do like say I no hear am.

Small time, e use style touch my kini. I ask am wetin be dat, e say make I no vex, say na mistake.

Small time again, e carry im mini skirt up, e look me to know weda I see wetin e do. E no know say I use corner eye dey look am.

E come carry im mini skirt up patapata make I see say e no wear dross. Tori Olorun!

Na dat time I come talk am for my mind say I don enter wahala for ashewo hand dis morning.

Di next ting be say, e hold my shokoto, pull di shokoto rope, bring out my kini. As e bend down to put my kini for mouth, na im I match break fiaaaam!

(To be continued)

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT is the longest running Pidgin column in Nigerian Media, since 1994.

Tags
meOga MATseewahala
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM
next post ROMANCE GONE SOUR: My husband hit me with dangerous objects, sent me packing because our one-year marriage is childless
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Matilda Showbiz

My wife Bose don dey play me 419

September 19, 20260
Gists

2Baba at 51: Music icon drops ‘Mental’ with Fave, celebrates birthday this weekend

September 19, 20260
Gists

Reality TV star Phyna, Nollywood actress Nkechi Blessing to clash in celebrity boxing match

September 19, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
News

Come back home and invest — Foreign Affairs minister woos Diaspora Nigerians

September 25, 20260
Politics

2027: Court nullifies former minister Pantami’s governorship ticket, orders fresh PDP primary

September 25, 20260
News

Peter Obi finally opens up on debt he allegedly left behind in Anambra

September 25, 20260
Business & Economy

Nigeria’s education system not matching job demands – Group

September 25, 20260
Politics

AI abuse, weak institutions heighten credibility fears ahead of 2027 elections

September 25, 20260
News

October 1: FG assures citizens of safety amid concerns about rising poverty

September 25, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Come back home and invest — Foreign Affairs minister woos Diaspora Nigerians

September 25, 2026

2027: Court nullifies former minister Pantami’s governorship ticket, orders fresh PDP primary

September 25, 2026

Peter Obi finally opens up on debt he allegedly left behind in Anambra

September 25, 2026

Nigeria’s education system not matching job demands – Group

September 25, 2026

AI abuse, weak institutions heighten credibility fears ahead of 2027 elections

September 25, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Come back home and invest — Foreign Affairs minister woos Diaspora Nigerians

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Swiss probe Google dropping search choice on Android phones

July 14, 2026
3

Elon Musk’s SpaceX acquires spectrum licenses for $17 billion

September 8, 2025
4

Cameroon President Paul Biya returns after 73 days away

August 21, 2026
5

CSOs to EFCC: Make your findings on suspended minister Betta Edu public

October 11, 2024
6

UEFA clear Manchester clubs, Nice and Girona to play in Europe

July 5, 2024
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

JUST IN: EFCC political agenda exposed – Kogi govt raises alarm

February 6, 2024
3

JUST IN: Two federal lawmakers dump APC, move to PRP, ADC

June 3, 2026
4

Senate President Akpabio hails Anaba on re-election as Nigerian Guild of Editors President

July 1, 2025
5

Enugu monarch, Ooni disagree over Southern Traditional Rulers’ Council

February 18, 2026
6

Actress Uche Montana denies allegations linking her to Regina Daniels’ drugs controversy

November 10, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

2024 UTME result slips available for printing — JAMB

July 22, 2024

Senate uncovers $300 billion crude losses, moves to name culprits

November 6, 2025

REVEALED: How 26-year-old lady survivor played dead to evade being killed by Jos attackers

April 4, 2026

Why registration of new parties is delayed – INEC

September 5, 2025
Top posts

Categories

  • News5066
  • Politics4761
  • Crime4548
  • International3152
  • Sports2548
  • Business & Economy2340
  • Headlines2252
  • Education1425
  • Matilda Showbiz1025
  • Health917
  • Entertainment852
  • Africa607
  • Religion491
  • Environment383
  • Special278
  • Info Tech255
  • Arts & Culture240
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today222
  • Interview194
  • Opinion156
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade135
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends23
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact