Skip to content
Thursday 29 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

My wife Bose don dey play me 419

The FrontierThe FrontierSeptember 19, 2026 1293 Minutes read0

Shey una still remember di tori wey I nack una di order day wey I say “Part-time wife wanted. Na urgent”?

My broda, I tink say wen I chop finish, I go clean mouth and nobody go know wetin happen. Na im make I no tell una say di tori get part 2.

But I no know say Bose my wife wey be mother of my two woman pikin dem – Bisi and Funke – don join 419 a.k.a. Yahoo Yahoo. Di only ting be say Bose 419 no be to take chop money from oyibo, im own 419 na to take am do monitoring spirit everywia I go.

SDP Poster Layout

Make I talk true, dat part-time wife vacancy advert hit, no be small. If I tell una di number of sisi dem wey call me for my torchlight chinko phone dat very day gan gan, hmmm, una no go believe.

Dat day, my phone jus dey ring ti-ti-ti-ti sote my battery peme. And na so l jus dey charge am for inside my guonguoro charger as I dey drive passenger dem for road. Tori Olorun!

Di ting be say, I come stop to carry passenger wen 12 o’clock pm in di afternoon nack. I go pay for one short-time for Agege. Wen any sisi call me, I go give am di address make e come meet me for screening for dat place.

Na so Lagos sisi dem jus dey come, and na so l dey screen dem one by one.

Before one hour pass, I don screen like 20 sisi dem. Olorun Oba o!

Na only one sisi I allow to come inside di room at a time. Di order ones go wait outside till I finish with one.

Na only to screen with my eye I do o. If I do any order ting join am for inside dat short-time room, make I baf naked for bafroom.

During di screening, I come jam one sisi among dem wey get everyting I wan for im body as my part-time wife. Im name na Kemi.

Kemi pass all di test wey | been list out for di

vacancy advert dat day:

•Sisi wey no pass 25

•Di two pawpaw for im chest must to tanda

paparapa like Standard Bank.

•Im Boys quarter must shoot out for angle

360 degree like Israel bomb

•No be short and no be tall

Must sabi deal gan with alagba like me for bed well well.

Quick, quick, I give Kemi our house address for Abule Egba. I tell am make e resume work as my part-time wife di next morning wey be Sunday. I don plan am say I no go work dat Sunday, I go dey for house to welcome Kemi my part-time wife for one month before Bose come back from Ondo wey e say e go attend im sister pikin graduation, den from dia, e go stay with im alagba Mama for one month.

Dat Saturday evening, I branch Madam Shine buka to go take My Usual and celebrate my part-time wife wey go resume in di morning.

My mind sweet gan. I jus dey tink make night come and make day break quick quick.

As I drive go reach house dat night, I park my guonguoro, carry my bag to enter house…

Na so my wife Bose jus come open di front door for me. I nearly faint. Egba mi o!

I ask Bose weda e no travel go Ondo again?

Na so my wife tell me say e no go anywia, say e jus wan try me. I shock! I no fit move one step for wia | tanda.

Shey dat one no be 419?

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
419My wife BoseOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post 2Baba at 51: Music icon drops ‘Mental’ with Fave, celebrates birthday this weekend
next post Raphinha hat-trick fires Barca to win at Sevilla
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Abuja Afrojazz Festival targets global opportunities for Nigerian musicians

October 24, 20260
Gists

Fela lives on in Kwara as state celebrates his life, legacies

October 24, 20260
Gists

BBNaija should take a break, re-strategise — Reality TV star Tacha

October 24, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

ARISE Projects Impact

February 9, 20250
Opinion

Tinubu’s $21.7 billion borrowing plan: Finance minister Oyedele’s defence raises questions that cannot be answered, By Paul Ibe

October 29, 20260
Education

Minister tasks Provosts of Colleges of Education on better results under dual mandate policy

October 29, 20260
Africa

African faith leaders demand reparations from Gates Foundation over rising hunger

October 29, 20260
Politics

Omitted names: Tension, suspense as INEC decides on Pantami, Gwarzo, Adebutu, others today

October 29, 20260
Crime

Family petitions IGP over engineer’s missing corpse in Anambra hospital

October 29, 20260
Sports

EPL: Man Utd should sack coach Carrick, says former captain Neville

October 29, 20260
Load more

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

Tinubu’s $21.7 billion borrowing plan: Finance minister Oyedele’s defence raises questions that cannot be answered, By Paul Ibe

October 29, 2026

Minister tasks Provosts of Colleges of Education on better results under dual mandate policy

October 29, 2026

African faith leaders demand reparations from Gates Foundation over rising hunger

October 29, 2026

Omitted names: Tension, suspense as INEC decides on Pantami, Gwarzo, Adebutu, others today

October 29, 2026

Family petitions IGP over engineer’s missing corpse in Anambra hospital

October 29, 2026

ARISE Projects Impact

0 Comments

Tinubu’s $21.7 billion borrowing plan: Finance minister Oyedele’s defence raises questions that cannot be answered, By Paul Ibe

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

Teachers recruitment: Job seekers without teaching licence can apply — Oyo govt

July 4, 2024
3

Iran-Israel truce: Germany, China back ceasefire deal

June 24, 2025
4

How BSc, HND, ND holders can apply for FG’s six-month teacher certification

September 8, 2026
5

BREAKING: Embattled Pastor Chris Okafor escapes arrest, surrenders to police

January 7, 2026
6

France withdraws first contingent of soldiers from Chad

December 21, 2024
Popular
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

How I manage Davido’s wealth, limit his luxury spending – Sister

September 23, 2026
3

Nigerian Legion urges FG to establish ministry of veterans affairs

June 20, 2026
4

7 nabbed over illegal security services in Anambra

January 22, 2024
5

2027: I’m open to working with other candidates – Peter Obi

September 14, 2024
6

NCC raids bookshops in Lagos, seizes N20 million pirated books

November 1, 2024

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

Police invite politician over alleged firearm display

October 5, 2026

Chief Imam accused of witchcraft beaten to death

November 6, 2025

Varsity students clash with NDLEA, police

February 23, 2024

Australia announces 6-month renewal window for foreign skilled workers

June 27, 2024
Top posts

Categories

  • News5200
  • Politics4932
  • Crime4674
  • International3264
  • Sports2625
  • Business & Economy2395
  • Headlines2302
  • Education1460
  • Matilda Showbiz1062
  • Health975
  • Entertainment898
  • Africa624
  • Religion504
  • Environment408
  • Special279
  • Info Tech270
  • Arts & Culture245
  • Inside Akwa Ibom Today239
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview200
  • Opinion160
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade139
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact