Skip to content
Monday 2 February 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

I no get time for Lagos sisi dem dis New Year

The FrontierThe FrontierJanuary 3, 2026 442 Minutes read0

Una kukuma remember say, as Keresimesi near last year, na so all dose Lagos sisi dem dey come dey rush me make I do Keresimesi for dem.

I talk am for my mind say shiooo! Shey, na me dem born for Keresimesi?

My broda, na so I took off o, I no show face again for our garage since dat Keresimesi. I know say dem go don go find me tire. For wia! Me wey don go pack my guonguoro for our house for Abule Egba!

Na yesterday wey be second day for dis New Year I say make I show face again for our garage since dat Keresimesi.

All our union member dem happy to meet again since last year. But some never come back sha. Emeka, Akpan and Mutiu still dey for dia village, I no know wetin dey hold dem, weda or wedan’t dem no see money pay transport come back Lagos, even after Baba don talk say e go pay half of dia transport money for dem.

But we wey remain for Lagos happy to meet again, no be small. Our union Chairman Jimoh, our Treasurer Idowu and me Oga MAT wey be Akowe, our own na no leave, no transfer. Na we be di real original Lagosians!

Na so di three both of us come dey pray for oursef dat yesterday for garage. Everybody come dey talk im New Year re…reso…resolu…resolut… Abeg, una know wetin I wan talk, make I no come bite my tongue becos of oyibo. Wetin I mean na New Year swear.

Jimoh say e no go marry anoder wife join di 8 wey e get already.

Idowu say e no go nack any sisi again dis year, as e be say any sisi wey e jus meet once must carry belle and born twins, and na so e don get pikin every corner for Lagos.

My own swear be say, dis year o, if any sisi like make e turn im head upside down, na only my wife Bose, di mama of my two woman pikin dem – Bisi and Funke – I know. Any order woman na fake.

Wen I swear like dat, Jimoh and Idowu begin laugh. I ask dem wetin make dem laugh, na im Idowu ask me if I no wan Sikiratu again.

If you see di kind eye wey I take look Idowu, hmm, if small pikin see my face dat time, e must to get confulsion.

I know say all of dem for dat our garage don dey eye my Sikiratu, dem dey pray make me and my Siki Babe no dey again so dat dem go rush am. But Eledumare no go answer dat dia wicked prayer. Helep me say Amin!

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
Lagos sisi demNew YearOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: TUMO WETO, by Mavo
next post ROMANCE GONE SOUR: My wife threatens to kill me for failing to satisfy her in bed
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Veteran actor Jide Kosoko speaks on his new traditional title Oloja-elect of Lagos

January 31, 20260
Gossips

Reactions as popular marriage and relationship counsellor, Pastor Kingsley Okonkwo gets tattoo

January 31, 20260
Gists

5 things to look out for at 2026 Grammys tomorrow

January 31, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
EyeCare with Dr Priscilia Imade

EyeCare with Dr Priscilia Imade: Danger of screens to the eyes

February 2, 20260
Health

Health workers’ strike grounds hospitals

February 2, 20260
Headlines

Travels: Presidency spends N34 billion on foreign exchange in two years

February 2, 20260
News

Oil-rich Eba Island tears Ogun, Ondo apart

February 2, 20260
Sports

South Africa replaces Morocco as host of Women’s Africa Cup of Nations 2026

February 2, 20260
Entertainment

Grammys Awards 2026: Nigeria misses out as South African singer Tyla claims another win

February 2, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

EyeCare with Dr Priscilia Imade: Danger of screens to the eyes

February 2, 2026

Health workers’ strike grounds hospitals

February 2, 2026

Travels: Presidency spends N34 billion on foreign exchange in two years

February 2, 2026

Oil-rich Eba Island tears Ogun, Ondo apart

February 2, 2026

South Africa replaces Morocco as host of Women’s Africa Cup of Nations 2026

February 2, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

EyeCare with Dr Priscilia Imade: Danger of screens to the eyes

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Again, Trump fined $10,000 for violating gag order

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Rivers emergency rule: Pro-democracy coalition urges ECOWAS action

March 24, 2025
3

Japa: Canada cancels 10-year multiple entry visas, tightens rules for entry

November 9, 2024
4

Pirated copies of Babangida autobiography hit social media, WhatsApp groups

February 21, 2025
5

Organised Labour submits N615,000 minimum wage demand in fresh proposal

April 14, 2024
6

Technical issue shuts out Facebook, Instagram, WhatsApp users

December 12, 2024
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

REVEALED: How FG, 8 states splashed N100.6 billion on 2024 hajj pilgrims •FULL LIST

July 2, 2024
3

Multiple taxation crippling Nigerian businesses — Experts

November 20, 2024
4

Defection: Court urged to declare Senator Nwoko’s seat vacant

February 24, 2025
5

Lawmakers walk out of meeting with Governor Radda over phone ban

July 17, 2024
6

BREAKING: Court declares Rivers N800billion 2024 budget illegal

January 22, 2024

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

BEWARE: Touts selling vehicle number plates in Abuja – FCT traffic service raises alarm

April 17, 2025

JUNE 12: Seven things you didn’t know about MKO Abiola and the 1993 election

June 6, 2025

3,180 police officers deployed for safe Christmas in Abuja

December 23, 2024

New Orleans truck-ramming attack being investigated as terrorism – FBI

January 1, 2025
Top posts

Categories

  • News4159
  • Politics3511
  • Crime3434
  • International2343
  • Sports1995
  • Business & Economy1928
  • Headlines1917
  • Education1123
  • Matilda Showbiz796
  • Health700
  • Entertainment645
  • Africa385
  • Religion384
  • Environment290
  • Special247
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Arts & Culture203
  • Info Tech188
  • Interview160
  • Inside Akwa Ibom Today144
  • Opinion132
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade102
  • Advert30
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Trends11
  • Local News4

© 2025 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact