…continued from last Saturday’s edition
I turn go left for bed, turn go right, turn go forward and turn go back, dem still dey shout for loudspeaker.
Na im I jump up, go wia di noise dey come from. I see say our landlord, Baba Briamoh, don start mosque for di compound. And e come be say na near my room window gan gan, e fix di loudspeaker. Olorun Oba o!
Di next ting I hear dem begin dey sing chorus for di next compound. Di loudspeaker wey dem use pass Baba Briamoh mosque own sef. Tori Olorun!
Wen I ask, dem tell me say di landlord of dat house don rent one room to one Aladura church. So, time don reach for dia evening program.
See me see wahala o. Di rest wey I say make I come rest for house, I no know say Baba Briamoh and im nebor don bring mosque and church come jam di face-me-I-face-you house wey I dey live. Come hear di kind noise wey dem make dat evening. Olorun Oba o!
Na im make I don decide say, from today, I go dey save money small small till e reach wey I go take am rent anoder house for anoder area for dis new year wey dey come so.
Me sef don tire for dis Baba Briamoh face-me-I-face-you house wey I don dey live before I marry Bose, den come born our two woman pikin dem – Bisi and Funke. Shey dem swear for me?
And di ting be say, our new house no fit be face-me-I-face-you like dis one wey we dey live now. I must upgrade dis coming New Year, lagbara Olorun.
Helep me say Amin!
Make we jam again next Saturday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.


