Skip to content
Wednesday 7 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Scratch my back, I scratch your back

The FrontierThe FrontierNovember 29, 2025 1422 Minutes read0

Na only for Naija wey sisi dem don turn to kalokalo. Just tell any Lagos sisi say I like you, you don enter im trap be dat, especially as Keresimesi don dey near so.

First, di sisi go tell you say “Honey, I dey hungry, I never chop since morning”.

Wen you settle dat one, di next ting na, “Sweetie, my Mama dey sick for village, I wan send money to am as I no get t/fare”.

After dat one, you go hear, “My love, I wan do my hair”, or “Sugar, I wan buy G-string dross”.

Di ogbenge one now be say, di sisi go stop to call you for one full day. Den, e go use anoder number wey you no know, call you.

If you answer di call, di sisi go talk say, “My sweetheart na me o. I use my uncle phone to tell you say my phone don spoil, di man wey wan repair am say make I bring 20k, and I no get dat kind money.”

Dat is, if di sisi no tell you say dem don tief im phone make you buy new one for am be dat o.

Na so you go spend till your pocket leak finish like person put water for basket. Dat one na introduction. No be say una don do kini yet o, and if you come do kini nko? Na im be say you don carry babanla gbese for your head be dat. Olorun Oba o!

Yesterday morning, na so I siddon for house, I no go our garage wey dey near Ikeja under bridge, as I no get enough money to use buy petrol put for my guonguoro take do my work. And e come be say petrol scarce well well dat yesterday morning. If taxi driver no get petrol, shey na water e go use drive im taxi?

Small time, I dey for inside my parlour see two Soja motor drive enter our compound wey I dey live with my family for Abule Egba. Five Soja wey carry gun jump down, come near and begin ask person for outside, “Na here Oga MAT dey live?” Di person say yes, and point for my door.

I talk am for my mind say my own don finish today. Abi dis khaki boys dem don scatter town like Guinea-Bissau?

Na so hot piss begin worry me, I nearly piss for inside my shokoto trouser but I manage hold am.

Di next ting be say, two Soja dem come knock for my door. And na only me dey house dat time. My wife Bose and my two woman pikin dem – Bisi and Funke – don go dia church for morning service.

I first tink weda make I run hide for under my bed for inside room, and na so all my body come begin shake like Shakespeare.

But I talk am for my mind say one day man must peme, and sometin must kill a man. I use boldface take open di front door.

One Soja ask me weda na me be Oga MAT. I say yes, na di name everybody dey call me, but my real name na Olufemi, di son of Pa Olukayode Olugbemiro of my village wey dey for Ogbomoso.

Di Soja dem say make I follow dem outside.

(To be continued)

Make we jam again next week.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
my backOga MATScratch
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: LALALA, by Young John and Rema
next post ROMANCE GONE SOUR: I cheated on my husband because he neglected, starved me
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Life beyond cameras: Yusuf, Bells and Chimsom reflect on growth, truth and survival in the BBNaija house

October 3, 20260
Gists

How we went into trance while filming — Actress Yetunde Barnabas

October 3, 20260
Gists

Meet Top 10 richest women in the world

October 3, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Health

19-year-old survives emergency brain surgery

October 7, 20260
Crime

Traditional ruler shot dead during colleague’s burial

October 7, 20260
Politics

I won 2023 presidential election but there’s no evidence, says Peter Obi

October 7, 20260
Business & Economy

FG opens bid for 40 oil blocks, mandates full disclosure of beneficial owners by bidders

October 7, 20260
News

Senior lawyer to FG: Don’t turn Lagos-Calabar Coastal Highway into inland road •Demands transparency

October 7, 20260
Health

EBOLA: FG moves to block importation into Nigeria as Kenya confirms case

October 7, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

19-year-old survives emergency brain surgery

October 7, 2026

Traditional ruler shot dead during colleague’s burial

October 7, 2026

I won 2023 presidential election but there’s no evidence, says Peter Obi

October 7, 2026

FG opens bid for 40 oil blocks, mandates full disclosure of beneficial owners by bidders

October 7, 2026

Senior lawyer to FG: Don’t turn Lagos-Calabar Coastal Highway into inland road •Demands transparency

October 7, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

19-year-old survives emergency brain surgery

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Argungu Festival shines with spectacular Kabanci water display •PHOTOS

February 14, 2026
3

Senator Natasha to Tinubu: Take decisive action to avert Rivers crisis

October 8, 2024
4

Imo Assembly suspends 4 members over plot to impeach Speaker

July 2, 2024
5

How BSc, HND, ND holders can apply for FG’s six-month teacher certification

September 8, 2026
6

Oba of Benin announces funeral rites for mother 49 years after death

February 10, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

New crude streams add 12m barrels to Nigeria’s output

June 13, 2026
3

Nigerian journalists demand FCT minister Wike’s apology over ‘threat’ against Channels TV presenter Okinbaloye

April 7, 2026
4

The South-East Polytechnic with 30 students

May 20, 2025
5

Gunmen kill varsity professor, abduct 2

April 22, 2024
6

ADC slams Governor Abiodun over ‘outrageous’ appointment of 1,200 political aides

September 13, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Attend to gunshot victims without police clearance – FG orders hospitals nationwide

December 7, 2024

Pandemonium as Police tear-gas Lagos residents protesting demolitions, eviction •VIDEO

January 28, 2026

Restoring faith in the Judiciary: The case against Benue chief judge, Maurice Ikpambese, By Joseph Aku

February 24, 2025

Backlash after Thailand frees 85-year-old drug trafficker

August 18, 2026
Top posts

Categories

  • News5110
  • Politics4813
  • Crime4587
  • International3192
  • Sports2572
  • Business & Economy2359
  • Headlines2273
  • Education1442
  • Matilda Showbiz1040
  • Health927
  • Entertainment873
  • Africa614
  • Religion495
  • Environment394
  • Special279
  • Info Tech258
  • Arts & Culture243
  • Inside Akwa Ibom Today228
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview195
  • Opinion158
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade136
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact