Skip to content
Saturday 21 November 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Scratch my back, I scratch your back

The FrontierThe FrontierNovember 21, 2026 303 Minutes read0

Na only for Naija wey sisi dem don turn to kalokalo. Just tell any Lagos sisi say I like you, you don enter im trap be dat, especially as Keresimesi don dey near so.

First, di sisi go tell you say “Honey, I dey hungry, I never chop since morning, and I don broke”.

Wen you settle dat one, di next ting na, “Sweetie, my Mama dey sick for village, I wan send money to am as I no get t/fare”.

SDP Poster Layout

After dat one, you go hear, “My love, I wan do my hair”, or, “Sugar, I wan buy G-string dross”.

Di ogbenge one now be say, di sisi go stop to call you for one full day. Den, e go use anoder number wey you no know, call you.

If you answer di call, di sisi go talk say, “Babe, na me o. I use my uncle phone to tell you say my phone don spoil, di man wey wan repair am say make I bring 20k, and I no get dat kind money.”

Dat is, if di sisi no tell you say dem don tief im phone make you buy new one for am be dat o. Tori Olorun!

Na so you go spend till your pocket leak finish like person put water for basket. Dat one na introduction. No be say una don do kini yet o, and if you come do kini nko? Na im be say you don carry babanla gbese for your head be dat. Olorun Oba o!

Yesterday morning, na so I siddon for house, I no go our garage wey dey near Ikeja under bridge, as I no get enough money to use buy petrol put for my guonguoro take do my work.

And e come be say petrol price don too dat yesterday morning.

Una kukuma know say petrol price for dis Emilokan time na helele.

But if taxi driver no fit buy petrol, shey na water e go use drive im taxi?

Small time, I dey for inside my parlour see two Soja motor drive enter our compound wey I dey live with my family for Abule Egba. Five Soja wey carry gun jump down, come near and begin ask person for outside, “Na here Oga MAT dey live?” Di person say yes, and point for my door.

I talk am for my mind say my own don finish today. Abi dis khaki boys dem don scatter town?

Na so hot piss begin worry me, I nearly piss for inside my shokoto trouser but I manage hold am.

Di next ting be say, two Soja dem come knock for my door. And na only me dey house dat time. My wife Bose and my two woman pikin dem – Bisi and Funke – don go dia church for morning service.

I first tink weda or wedan’t make I run go  hide for under my bed for inside room, and na so all my body come begin shake like Shakespeare.

But I talk am for my mind say, one day man must peme, and sometin must kill a man. I use boldface take open di front door.

One Soja ask me weda na me be Oga MAT. I say yes, na di name everybody dey call me, but my real name na Olufemi, di son of Pa Olukayode Olugbemiro of my village wey dey for Ogbomoso.

Di Soja dem say make I follow dem outside.

(To be continued)

Make we jam again next week.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

 

Tags
Oga MATScratch
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post ROMANCE GONE SOUR: My husband has become a wreck due to drinking, gambling, womanising
next post I could have had three private jets if I yielded to temptation – Popular Gospel singer Frank Edwards
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Excitement as music stars Wizkid, Rema team up for ‘Feel Alright’

November 21, 20260
Gists

Davido and Chioma: The love story continues

November 21, 20260
Gists

I could have had three private jets if I yielded to temptation – Popular Gospel singer Frank Edwards

November 21, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

ARISE Projects Impact

February 9, 20250
Gists

Excitement as music stars Wizkid, Rema team up for ‘Feel Alright’

November 21, 20260
Gists

Davido and Chioma: The love story continues

November 21, 20260
Gists

I could have had three private jets if I yielded to temptation – Popular Gospel singer Frank Edwards

November 21, 20260
Matilda Showbiz

ROMANCE GONE SOUR: My husband has become a wreck due to drinking, gambling, womanising

November 21, 20260
Matilda Showbiz

Hot Lyrics: VELVET by Rema

November 21, 20260
Matilda Showbiz

Nigeria’s Top 10 Songs with ITTY OKIM •Week 46

November 21, 20260
Load more

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

Excitement as music stars Wizkid, Rema team up for ‘Feel Alright’

November 21, 2026

Davido and Chioma: The love story continues

November 21, 2026

I could have had three private jets if I yielded to temptation – Popular Gospel singer Frank Edwards

November 21, 2026

Scratch my back, I scratch your back

November 21, 2026

ROMANCE GONE SOUR: My husband has become a wreck due to drinking, gambling, womanising

November 21, 2026

ARISE Projects Impact

0 Comments

Excitement as music stars Wizkid, Rema team up for ‘Feel Alright’

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

2027: FCT minister Wike’s N10 million promise to councillors who win Wards for Tinubu contravenes Electoral Act – Lawyer

November 11, 2026
3

More trouble for Nigerians as CBN raises Customs duty exchange rate to N1, 356.883/$

February 3, 2024
4

Unsafe food kills 53,000 Nigerians annually – FG warns

June 8, 2026
5

Lagos suspends BRT lane enforcement on Eko Bridge, Odo-Iya-Alaro axis

July 3, 2025
6

Hospital destroys over 1,000kg expired, fake drugs

January 2, 2025
Popular
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

TRAGEDY: 3 feared dead as container truck falls on tricycle

January 7, 2025
3

2027 elections: ADC is no match for APC – National chairman Yilwatda boasts

February 4, 2026
4

PDP crisis deepens in Benue as pro Ortom/Suswam groups suspend working committee members

August 6, 2024
5

Engage youths, provide social services to curb substance abuse – Don urges govt

August 11, 2025
6

Prolific Nigerian singer Eedris Abdulkareem throws weight behind Governor Otti

August 7, 2026

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

Trump defends block on foreign students at Harvard

May 26, 2025

Compelling our children to sing the colonial anthem is cruel — Co-author of Nigeria’s discarded national anthem, Sota Omoigui

June 22, 2024

JUST IN: Gospel singer Timileyin Ajayi pleads not guilty to youth corper Salome Adaidu’s murder

January 27, 2025

FG inaugurates new Board of Bank of Agriculture

July 4, 2026
Top posts

Categories

  • News5260
  • Politics5090
  • Crime4760
  • International3345
  • Sports2685
  • Business & Economy2433
  • Headlines2318
  • Education1487
  • Matilda Showbiz1086
  • Health996
  • Entertainment921
  • Africa636
  • Religion513
  • Environment418
  • Special279
  • Info Tech278
  • Inside Akwa Ibom Today249
  • Arts & Culture248
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview205
  • Opinion162
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade142
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact