Skip to content
Monday 29 June 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Wahala everywia, me sef wan go vacation

The FrontierThe FrontierOctober 5, 2024 3003 Minutes read0

Dis rain wey don come now for Lagos, shey no be wahala e bring come so?

Rain don dey fall teletele everywia for Naija since dis year show face, na only Lagos been remain.

Na now wey be say dry season suppose show face, na im rain don begin fall for Lagos. And e come be say cold don dey ground already, rain come join di cold. No be die be dat?

Yesterday morning, as all of us jus land for our garage wey dey near Ikeja under bridge, na im ogbonge rain begin fall. E come be like say di rain wait make all our union member dem arrive. Di rain fall ti-ti-ti-ti, from 7 O’clock am in di morning, e no gree stop till around 3 O’clock pm in di afternoon. And wen e do like say e wan stop, small time e go start again. Na so everybody jus siddon for garage, nobody gree put im taxi for road. Put your motor for Lagos road ke wen rain dey fall? If you try am, na im be say you, your taxi and passenger go jus see una sef for inside Lagos Lagoon.

As we siddon for garage inside dat rain and cold, our union member dem come dey take di ting wey go make dia body warm small. Trust Mutiu, e smoke Igbo like say tomorrow no dey. Our union chairman Jimoh and treasurer Idowu nko? Dose one buy hot Agbo from Jumoke till di Agbo finish patapata. Akpan, our social organiser dey one corner dey touch-touch di sisi wey run enter our garage as di rain begin fall. Emeka own be say, all di orisirisi satchet hot drink suffer for im hand, plus including cigar. No ask me wetin me I use shock mysef for dat ogbonge cold becos I no go tell you. Oyibo dey talk am say dat one na trade secret.

Na so everybody eye come red for garage dat yesterday as di rain dey fall. For evening time wen di rain come down small, everybody begin find im way.

I no get chance to branch Madam Shine buka dat evening to go take My Usual and from dia, see Sikiratu. I know say my Siki Babe go don wait for me tire. But I no fit go dia becos all di road don block after di rain. I jus dey find how I go reach my house for Abule Egba inside dat babanla Go-slow.

I manage reach house around 10 O’clock pm in di night. Tori Olorun!

As I jus park my guonguoro for compound, I lock all di four door and enter house. My wife Bose and our two woman pikin dem – Bisi and Funke – don already dey sleep. Everybody jus use heavy wrapper cover body inside dat cold.

Me, I no even comot my clothe, na so I jump inside bed wia Bose lie down dey sleep.

I use wrapper cover my body, cold still dey catch me. I use blanket, na di same ten and ten pence. I no come know wetin I go do again.

I turn body face Bose my wife. I touch am small, Bose no shake body. I use wan leg put for im body, Bose no jus move. I come carry im wrapper up, to use di wrapper cover di two both of us. My broda, come see as my wife use full force push me trowey comot for bed. Na so I fall for ground yakata, nack my head for ground pppossaahh!!! I nearly faint.

(To be continued)

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994

Tags
everywiaOga MATvacationwahala
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Emirates bans pagers, walkie-talkies onboard after Lebanon blasts
next post Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Matilda Showbiz

Nigeria’s Top 10 Songs with ITTY OKIM •Week 26

June 27, 20260
Gists

Food, music, as Jollof Fest returns to Lagos with new addition

June 27, 20260
Gists

Afrobeats star Rema sets Mawazine Festival stage on fire after World Cup opening ceremony moment

June 27, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Crime

JUST IN: Vigilante groups rescue some kidnapped NECO students in Borno

June 29, 20260
Crime

JUST IN: Lagos bus conductor arrested for stabbing officer over traffic offence

June 29, 20260
Business & Economy

Nigerian businesses still struggling three years after Tinubu’s reforms – Employers

June 29, 20260
Crime

REVEALED: Terrorists picked all students in classrooms during school kidnap today – Police

June 29, 20260
Arts & Culture

Black Witness: Exposing maltreatment of girl-child through artistic illustrations

June 29, 20260
News

Governor Otu has compressed six years development into three – Commissioner

June 29, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

JUST IN: Vigilante groups rescue some kidnapped NECO students in Borno

June 29, 2026

JUST IN: Lagos bus conductor arrested for stabbing officer over traffic offence

June 29, 2026

Nigerian businesses still struggling three years after Tinubu’s reforms – Employers

June 29, 2026

REVEALED: Terrorists picked all students in classrooms during school kidnap today – Police

June 29, 2026

Black Witness: Exposing maltreatment of girl-child through artistic illustrations

June 29, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

JUST IN: Vigilante groups rescue some kidnapped NECO students in Borno

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Again, Trump fined $10,000 for violating gag order

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Hours after Atiku’s visit, Ganduje leads APC leaders to Buhari •PHOTOS

April 12, 2025
3

RED ALERT: 7 states at risk of heavy flooding – Agency

September 6, 2024
4

Tinubu reconstitutes Electricity Regulatory Commission board, names new chairman

December 18, 2025
5

Gridlock: Motorists lament as FG closes Lagos bridge for repairs

April 2, 2025
6

4 years after #EndSARS, police abuses still rampant – Amnesty International

October 20, 2024
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

National Assembly to amend 161 areas in 1999 constitution – Deputy Speaker Kalu

November 21, 2024
3

Okpebholo absent as South-South governors meet in Bayelsa

January 28, 2025
4

Labour Party has 3 factions in Lagos – Electoral Commission

May 16, 2025
5

Only 1.16% of underage UTME candidates show exceptional ability — JAMB

May 5, 2025
6

Shadow Govt: Utomi reacts to court ruling

September 30, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Nnamdi Kanu’s Global Defence Consortium lists 16 fatal infractions, demands his immediate release

September 24, 2025

Hajj: Date announced for intending pilgrims in Abuja to ensure payment

September 29, 2025

Cristiano Ronaldo gets engaged to Georgina Rodriguez after 8 years of dating

August 12, 2025

NIN: Activist drags Telcos, NCC to court, seeks N10billion damages

March 5, 2024
Top posts

Categories

  • News4697
  • Politics4332
  • Crime4117
  • International2859
  • Sports2357
  • Business & Economy2191
  • Headlines2130
  • Education1305
  • Matilda Showbiz936
  • Health829
  • Entertainment770
  • Africa521
  • Religion469
  • Environment336
  • Special267
  • Info Tech230
  • Arts & Culture228
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today185
  • Interview180
  • Opinion150
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade123
  • Advert30
  • World Cup 202625
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Trends17
  • Local News5

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact