Skip to content
Friday 10 July 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Wahala everywia, me sef wan go vacation (2)

The FrontierThe FrontierOctober 12, 2024 3082 Minutes read0

…Continued from last edition

As Bose push me dat night comot for bed make I nack my head for ground pppossaahh!!!, e no stop dia o.

Bose come begin dey shout dat night. Notin wey my wife no tell me. Bose curse me like say I tief im ting. E say I don dagba finish, I no wan respect mysef. E say shebi e don dey tell me say make I go marry anoder wife as e be say I no fit control mysef. E say since I don begin dey do kini, wetin I don take am do if no be dis two woman pikin wey we born, wen be say my mate dem na nimonaire, dem buy big big motor and build fine fine house for Lekki and VGC, and even for Banana Island. E say my own I dey here dey disturb am every night for dis Baba Briamoh face-me-I-face-you house wey we be tenant sef. Tori Olorun!

Shame catch me, no be small. Even tief wey dem catch wey tief person ting sef no shame like me.

Di next ting be say, I hear “Chisos! My eye o!! I don blind o!!!”

Na so me and Bose rush enter parlour. We come see say our two woman pikin dem – Bisi and Funke – dey fight. Funke land one dirty slap for im senior sister eye, na so Bisi come begin shout dat night.

My wife come knock Funke for head, e begin curse Funke why e dey fight im senior sister every time. E ask Funke why e no dey respect im sister, weda e no know say na Bisi senior am.

Na dat time Funke begin face im Mama. E ask im Mama why e go knock im head. E say weda im Papa dey knock im head every night wey e dey fight im Papa. E ask im Mama weda e tink say dem no dey hear as e dey curse dia Papa for midnight. E ask im Mama why e no dey respect im Papa, weda e no know say im Papa pay bride price for im head. E say every night na war for inside bedroom.

Dat time, no body fit talk pim. Everybody mouth gum patapata.

Na so I stand for dia like Standard Bank. My body come dey shake like Shakespeare. Bose jus use style go back to bedroom. Bisi lie down, cover body to begin sleep again. Funke go lie down for chair.

I come talk am for my mind say, as my house don turn to war front like Israel and Iran so, wen morning show face small, I go jus disappear. Me sef go go for vacation. Wia I go travel go do my own vacation, I no go tell anybody. If I like, I go travel from one town to anoder, from one state to anoder, from one contry to anoder, e no concern anybody.

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
everywiaOga MATvacation (2)wahala
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: MARHABA, by Kizz Daniel
next post ROMANCE GONE SOUR: My wife had baby for her lover while still married to me
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Matilda Showbiz

Weda or wedan’t dem like am, na my turn be dis

July 4, 20260
Matilda Showbiz

Players with most goals at 2026 World Cup so far •FULL LIST

July 4, 20260
Gists

I enjoy watching Rema, Burna Boy perform, says US Envoy Keith Heffern

July 4, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
International

Iran buries slain former supreme leader Khamenei in hometown

July 10, 20260
Headlines

REVEALED: Real reason jet landed on Asaba construction road — Investigation Bureau

July 10, 20260
World Cup 2026

World Cup ticket prices crash after Ronaldo, USA exit

July 10, 20260
Education

EXPOSED: Female student allegedly forced into sex-for-grades by HOD

July 10, 20260
Crime

JUST IN: New bride killed as soldiers exchange gunfire with Boko Haram terrorists in Maiduguri

July 10, 20260
Politics

PDP, civil societies, reject pension allowance for former lawmakers

July 10, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Iran buries slain former supreme leader Khamenei in hometown

July 10, 2026

REVEALED: Real reason jet landed on Asaba construction road — Investigation Bureau

July 10, 2026

World Cup ticket prices crash after Ronaldo, USA exit

July 10, 2026

EXPOSED: Female student allegedly forced into sex-for-grades by HOD

July 10, 2026

JUST IN: New bride killed as soldiers exchange gunfire with Boko Haram terrorists in Maiduguri

July 10, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Iran buries slain former supreme leader Khamenei in hometown

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Again, Trump fined $10,000 for violating gag order

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Domestic equities market suffers 2nd weekly loss, investors reprice risks

August 25, 2025
3

Edo guber: Fresh crisis rocks APC as aspirant drags INEC to court

March 11, 2024
4

If I’m collecting N250,000 from anybody I won’t be in that place again – Lagos underbridge landlord counters state govt

May 6, 2024
5

BREAKING: Supreme Court affirms Alex Otti as Abia governor

January 12, 2024
6

Senate confirms Agbaje as new National Pension Commission chairman

November 11, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

NDLEA files forfeiture case against Pretty Mike’s nightclub over drug party

October 29, 2025
3

National Assembly postpones resumption

September 12, 2024
4

I’m not desperate to be president – Peter Obi

March 6, 2024
5

Top 10 countries in Africa where workers earn highest salaries

October 1, 2024
6

Tinubu moves school feeding programme to Ministry of Education

December 21, 2023

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Ekpoma protests: Governor Okpebholo bows to pressure, approves release of arrested students

January 14, 2026

PDP rift to be resolved soon, says Board of Trustees member

November 18, 2025

Why military can’t come back to power in Nigeria – Former military head of state, General Abdulsalami

January 31, 2025

We did not approve sale of Shell assets — Regulatory Commission

September 13, 2024
Top posts

Categories

  • News4744
  • Politics4376
  • Crime4175
  • International2896
  • Sports2362
  • Business & Economy2205
  • Headlines2140
  • Education1321
  • Matilda Showbiz944
  • Health841
  • Entertainment774
  • Africa542
  • Religion471
  • Environment352
  • Special267
  • Info Tech234
  • Arts & Culture230
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today191
  • Interview181
  • Opinion150
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade124
  • World Cup 202660
  • Advert31
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Trends19
  • Local News5

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact