Skip to content
Thursday 12 June 2025
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Wahala everywia, me sef wan go vacation (2)

The FrontierThe FrontierOctober 12, 2024 1332 Minutes read0

…Continued from last edition

As Bose push me dat night comot for bed make I nack my head for ground pppossaahh!!!, e no stop dia o.

Bose come begin dey shout dat night. Notin wey my wife no tell me. Bose curse me like say I tief im ting. E say I don dagba finish, I no wan respect mysef. E say shebi e don dey tell me say make I go marry anoder wife as e be say I no fit control mysef. E say since I don begin dey do kini, wetin I don take am do if no be dis two woman pikin wey we born, wen be say my mate dem na nimonaire, dem buy big big motor and build fine fine house for Lekki and VGC, and even for Banana Island. E say my own I dey here dey disturb am every night for dis Baba Briamoh face-me-I-face-you house wey we be tenant sef. Tori Olorun!

Shame catch me, no be small. Even tief wey dem catch wey tief person ting sef no shame like me.

Di next ting be say, I hear “Chisos! My eye o!! I don blind o!!!”

Na so me and Bose rush enter parlour. We come see say our two woman pikin dem – Bisi and Funke – dey fight. Funke land one dirty slap for im senior sister eye, na so Bisi come begin shout dat night.

My wife come knock Funke for head, e begin curse Funke why e dey fight im senior sister every time. E ask Funke why e no dey respect im sister, weda e no know say na Bisi senior am.

Na dat time Funke begin face im Mama. E ask im Mama why e go knock im head. E say weda im Papa dey knock im head every night wey e dey fight im Papa. E ask im Mama weda e tink say dem no dey hear as e dey curse dia Papa for midnight. E ask im Mama why e no dey respect im Papa, weda e no know say im Papa pay bride price for im head. E say every night na war for inside bedroom.

Dat time, no body fit talk pim. Everybody mouth gum patapata.

Na so I stand for dia like Standard Bank. My body come dey shake like Shakespeare. Bose jus use style go back to bedroom. Bisi lie down, cover body to begin sleep again. Funke go lie down for chair.

I come talk am for my mind say, as my house don turn to war front like Israel and Iran so, wen morning show face small, I go jus disappear. Me sef go go for vacation. Wia I go travel go do my own vacation, I no go tell anybody. If I like, I go travel from one town to anoder, from one state to anoder, from one contry to anoder, e no concern anybody.

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
everywiaOga MATvacation (2)wahala
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: MARHABA, by Kizz Daniel
next post ROMANCE GONE SOUR: My wife had baby for her lover while still married to me
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

I spent a whopping $40,000 on a song that flopped, says Nigerian pop singer Bella Shmurda

June 7, 20250
Gists

A-list actress, Omotola Jalade-Ekeinde laments lack of structure in Nollywood

June 7, 20250
Gists

Dangers of marriages abroad exposed as Paschal Atuma’s ‘Imported Wives’ hit the screens

June 7, 20250
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
News

InDrive driver helps deliver pregnant woman of baby inside car

June 12, 20250
Business & Economy

Dangote retires as Dangote Sugar chairman after 20 years

June 12, 20250
Headlines

JUST IN: Journalists shut out of National Assembly gallery ahead of Tinubu’s address

June 12, 20250
Politics

Governors, Senators, Reps defecting to other parties are like herdsmen — Former national TV boss, Tonnie Iredia

June 12, 20250
News

Social media influencer, Dadiyata, missing for 6 years, is dead — Investigator

June 12, 20250
Sports

Poland coach resigns after Lewandowski boycott

June 12, 20250
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

InDrive driver helps deliver pregnant woman of baby inside car

June 12, 2025

Dangote retires as Dangote Sugar chairman after 20 years

June 12, 2025

JUST IN: Journalists shut out of National Assembly gallery ahead of Tinubu’s address

June 12, 2025

Governors, Senators, Reps defecting to other parties are like herdsmen — Former national TV boss, Tonnie Iredia

June 12, 2025

Social media influencer, Dadiyata, missing for 6 years, is dead — Investigator

June 12, 2025

inside the Hill top newspaper

0 Comments

InDrive driver helps deliver pregnant woman of baby inside car

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Again, Trump fined $10,000 for violating gag order

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Man carrying 4,000 tramadol pills nabbed at Lagos airport

April 29, 2024
3

Insecurity: Only duly profiled vehicles to ply Abuja from January – FCT Minister Wike

November 7, 2024
4

North Central APC stakeholders insist on chairmanship position

August 23, 2024
5

Inside Sani Abacha Stadium, a haven for forbidden drugs in Kano

July 6, 2024
6

BREAKING: Court declares Edo PDP governorship primary invalid

July 4, 2024
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Abuja barber who chose Wizkid over Davido yet to receive promised N2 million

May 6, 2024
3

BREAKING: I have heard you loud and clear – Tinubu tells protesters as protest enters Day 4

August 4, 2024
4

Grandma, son, 2 family members die after eating Amala

August 7, 2024
5

Benue Police Command gets DSP Udeme Edet as new image maker

May 31, 2025
6

Family accuses police of demanding tracking fee for 7-year-old kidnapped girl

December 26, 2024

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

SERAP threatens lawsuit against Wike over ultimatum to beggars in Abuja

October 23, 2024

Reconsider legitimate Nigerian graduates from Benin Republic, Togo – NANS tells FG

January 3, 2024

Invasion: NLC summons emergency NEC meeting tomorrow

August 9, 2024

2 injured as truck destroys pedestrian bridge in Lagos

December 8, 2023
Top posts

Categories

  • News2845
  • Crime2444
  • Politics2261
  • International1554
  • Business & Economy1513
  • Headlines1392
  • Sports1326
  • Education812
  • Matilda Showbiz551
  • Health480
  • Entertainment412
  • Religion311
  • Environment227
  • Hunger protests in Nigeria222
  • Special204
  • Africa175
  • Info Tech150
  • Arts & Culture139
  • Interview107
  • Opinion81
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade69
  • Inside Akwa Ibom Today66
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Advert16
  • Trends5
  • Local News4

© 2025 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact