Skip to content
Wednesday 24 June 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Keresimasi don come, all Lagos sisi dem don dey show face

The FrontierThe FrontierDecember 14, 2024 2683 Minutes read0

Every year by dis time, na so so Lagos sisi dem man pikin go dey see left, right and center. And all of dem wan make you do Keresimasi for dem.

Even all dose sisi dem wey no dey greet me for our street for Abule Egba, now if dem see me, dem go first smile, den dobale, and begin greet me, “Daddy Bisi, good morning sir. Well don sir. Shey work dey go on fine sir? Happy Keresimasi and Mary New Year in advance sir.” Olorun Oba o!

I don tire for all dis kind greeting sef every day. Dis na sisi dem wey no dey look my side rarara before o.

Di order day, Abosede come, di mobile buka girl wey dey carry Ewa Agoyin for head waka come sell for our garage wey dey near Ikeja under bridge. I tink say na market e come sell, I no know say e come tell me make I no forgot am dis Keresimasi.

Na so Jumoke, wey dey bring Monkeytail come sell for our union member dem like Mutiu, come ask me for di ting wey I go give am dis Keresimasi. Aisha wey dey come sell hot Agbo for our garage, also do di same ting yesterday. I say shiooo! Shey, na me dem born for Keresimasi?

Di one wey shock me pass na yesterday wen I don go drop my passenger for Idumota around 12 O’clock pm in di afternoon, come back say make I rest small for garage, na im one woman waka enter garage.

Wen I look di woman ti-ti-ti-ti, I see say na Madam Shine, di woman wey get di joint wey Sikiratu dey work and wey I dey go take My Usual for evening after work everyday. But since last week wey Sikiratu travel go village for dis odun wey dey come so, I no go Madam Shine buka. Na anoder joint I dey go nack My Usual before I begin go house.

I ask Madam Shine wetin happen wey make am come our garage for di first time. Di agaracha woman say e jus say make e come greet me.

Madam Shine begin ask me why e no see me since last week. I tell am say na work. E say na lie. E say na becos Sikiratu travel go see im one-eye mama for village.

E say make I dey come, say as e be say na im get di joint, e go treat me well. E say e go take care of me till January wey Sikiratu go come back.

I ask am wen I come, shebi na me go still pay for everyting I drink and chop, like point-and-kill. E say yes, plus including wetin im sef go drink and chop, like Cowtail peppersoup. Tori Olorun!

See Madam Shine wey dey finish like 6 Shine Shine Bobo, e no go even be am like say e drink anyting o!

I come ask am say, wen I come, wetin im sef go give me. E say we go jus siddon dey nack tori like broda and sister, drink and chop. Dat’s all. I ask am wetin again. E say noting, say e don swear teletele say e no go ever do kini with im customer. But we fit jus siddon togeder dey nack tori, drink and chop, den wen time reach, I go my house go meet my family.

Na dat time I tell Madam Shine say I hear, say I go dey come everyday even as my Siki Babe don travel.

Na so Madam Shine tank me well well, and begin dey go.

I come talk am for my mind say, so dis old cargo don see mumu. Emi ko.

Me sef don swear teletele say I no fit be ATM for any woman lai lai, especially for dis our Emilokan time.

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

 

 

Tags
comedonKeresimasiOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post We own many landed properties in Igboland – Yoruba, Hausa resident in SouthEast reveal
next post Funke Akindele, Falz heat up movie premiere with sizzling kiss
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Popular Ghanaian actor Van Vicker bags First Class Law degree

June 20, 20260
Gists

Mistreated wives will show you ‘shege’ in old age – Veteran actor Chiwetalu Agu warns men

June 20, 20260
Gists

I would be unemployed without music, says Afrobeats singer Ayra Starr

June 20, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Crime

How we’ll prevent governors from abusing state police — Senate

June 24, 20260
Headlines

BREAKING: Senate passes state police bill, empowers governors to appoint commissioners

June 24, 20260
Crime

Bandits gun down Chief Imam, abduct married women in Sokoto

June 24, 20260
Crime

HORROR: How gunmen killed my pregnant sister inside labour room – Survivor narrates

June 24, 20260
Religion

The Salvation Army, Ebute-Metta Corps set to unveil four milestones in Lagos

June 24, 20260
Education

Varsity lecturer loses professorial rank over alleged breach of regulations

June 24, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

How we’ll prevent governors from abusing state police — Senate

June 24, 2026

BREAKING: Senate passes state police bill, empowers governors to appoint commissioners

June 24, 2026

Bandits gun down Chief Imam, abduct married women in Sokoto

June 24, 2026

HORROR: How gunmen killed my pregnant sister inside labour room – Survivor narrates

June 24, 2026

The Salvation Army, Ebute-Metta Corps set to unveil four milestones in Lagos

June 24, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

How we’ll prevent governors from abusing state police — Senate

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Again, Trump fined $10,000 for violating gag order

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Thousands face life-threatening ailments from lead poisoning

January 7, 2025
3

INEC issues certificates of return to August 16 by-election winners

August 22, 2025
4

Tough times as accommodation seekers groan under rent hikes

September 30, 2025
5

Liverpool dominate West Ham to reach League Cup semis

December 21, 2023
6

BREAKING: FG opens Lagos-Calabar coastal highway

December 12, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Resident doctors demand N25,000 quarterly allowance

February 4, 2024
3

BREAKING: Popular musician gunned down by police officer

October 26, 2024
4

Star actress Funke Akindele releases new song ‘Everybody Loves Christmas’ featuring Falz, Waje, Dbanj, others •VIDEO

December 4, 2024
5

EFCC arrests 120 suspected fraudsters, seizes 26 vehicles in Lagos

May 19, 2025
6

NAFDAC renews crackdown on counterfeit drugs

July 21, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Algeria wants to hire Jose Peseiro as next manager

February 16, 2024

Jigawa tanker explosion: Death toll hits 181, another 80 in critical condition in hospital

October 22, 2024

Eid-el-Kabir: Share sacrificial meat with vulnerable persons — Governor Aliyu tells Muslims

May 27, 2026

ARREST: Nothing must happen to NLC President Ajaero – CSOs warn Gov Uzodinma •Call on Atiku, Obi, Kwakwanso, others to save Nigeria’s democracy

November 1, 2023
Top posts

Categories

  • News4684
  • Politics4313
  • Crime4087
  • International2839
  • Sports2354
  • Business & Economy2181
  • Headlines2123
  • Education1300
  • Matilda Showbiz929
  • Health828
  • Entertainment763
  • Africa518
  • Religion469
  • Environment332
  • Special267
  • Info Tech229
  • Arts & Culture227
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today181
  • Interview179
  • Opinion150
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade122
  • Advert30
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Trends17
  • World Cup 202612
  • Local News5

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact