Skip to content
Saturday 23 May 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

A-B-R-A-C-A-D-A-B-R-A!

The FrontierThe FrontierMay 23, 2026 112 Minutes read0

Noting wey man pikin no go use im ear see and use im mouth hear for dis Lagos wey we dey so. Tori Olorun!

E get sometins wey you go see, small time di ting go disappear, and you go tink say you see am for dream. But na lie, no be for dream you see am, na korokoro you see am.

I remember wen we dey for night school for my village for Ogbomoso before I run come Lagos in 1965 wen I dey for Standard 5 (no ask me why I run, you know), our teacher been dey call dat kind ting “Abracadabra”, “America Wonder” or “Di more you look, di less you see”.

My broda, dis week wey wan finish so, I see plenty Abracadabra, no be small.

On Monday, na so some people come our garage wey dey near Ikeja Under Bridge. Dem say dem wan charter my guonguoro for di hole week. Dem say dem wan do primary election on Wednesday, Thursday and yesterday wey be Friday.

Dem say dem go use dia party poster, take cover di body of my guonguoro, den I go dey go anywia dem send me to go carry dia member dem and order tings. I say no wahala.

I tell dem say my guonguoro don become official motor of dia party be dat, for di hole week. I tell dem say dat one na money o. Dem say money no be troublem for dia party, say dem be di ruling party, make I just tell dem how much I go collect.

I tell dem my price, dem gree. Na so dem bring out mint Naira cash from dia Ghana-Must-Go bag, pay me papapa. My broda, I shock.

Well sha, wetin be my own? Shey, no be money make me dey do dis taxi driver work?

Dem say make I give dem receipt. As I wan write di receipt, one of dem tell me di amount wey I go write. Na four times di money wey dem pay me o. Olorun Oba o!

I come talk am for my mind say, no wonder our Oga Patapata just dey take loan for oyibo hand per second per second. Abeg na so I hear o, no be me talk am o.

Na so I write di receipt give dem kia kia.

Before day break sef on dat Wednesday, I don comot for my house wey dey for Abule Egba, drive go di party secretariat. Work don start be dat.

(To be continued)

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
A-B-R-A-C-A-D-A-B-R-A!Oga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post HAPPENING NOW: Blackout hits Abuja, Embassies affected
next post Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM •Week 21
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

I feel like shutting my Instagram account – Nollywood actor Kunle Remi

May 23, 20260
Gists

Afrobeats star Tiwa Savage, others attend ‘Call of My Life’ movie screening

May 23, 20260
Gists

My teeth are always closed during shooting of kissing scenes — Actress Sophia Chisom

May 23, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Inside Akwa Ibom Today

INSIDE AKWA IBOM TODAY: Gov Eno applauds Tinubu, APC over enhanced grassroots integration

May 23, 20260
Africa

BREAKING: 10 African countries at risk as Ebola spreads — Africa CDC •FULL LIST

May 23, 20260
Gists

I feel like shutting my Instagram account – Nollywood actor Kunle Remi

May 23, 20260
Gists

Afrobeats star Tiwa Savage, others attend ‘Call of My Life’ movie screening

May 23, 20260
Gists

My teeth are always closed during shooting of kissing scenes — Actress Sophia Chisom

May 23, 20260
Matilda Showbiz

ROMANCE GONE SOUR: My husband abandoned me on our wedding night to attend political meeting, I want our marriage dissolved

May 23, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

INSIDE AKWA IBOM TODAY: Gov Eno applauds Tinubu, APC over enhanced grassroots integration

May 23, 2026

BREAKING: 10 African countries at risk as Ebola spreads — Africa CDC •FULL LIST

May 23, 2026

I feel like shutting my Instagram account – Nollywood actor Kunle Remi

May 23, 2026

Afrobeats star Tiwa Savage, others attend ‘Call of My Life’ movie screening

May 23, 2026

My teeth are always closed during shooting of kissing scenes — Actress Sophia Chisom

May 23, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

INSIDE AKWA IBOM TODAY: Gov Eno applauds Tinubu, APC over enhanced grassroots integration

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Again, Trump fined $10,000 for violating gag order

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Hunger protests: 4 teenagers, bride-to-be killed

August 7, 2024
3

Skit maker, Zfancy, granted bail after arrest over disturbing pranks

July 11, 2024
4

Family loses 23 members as many killed in fresh Benue attack

June 16, 2025
5

Court convicts ex-National Health Insurance Scheme boss for violating cash transaction law

July 25, 2025
6

Japa: It’s hard abroad but I’m doing better than my peers in Nigeria – Dr. Olayiwola

December 17, 2024
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Senate gives Kyari, NUPRC boss 24 hours to appear for budget defense

December 6, 2023
3

Former Governor El-Rufai’s ally, Amadu Sule docked in ₦311 billion money laundering suit

January 13, 2026
4

Senator Gbenga Daniel raises alarm as Governor Abiodun threatens demolition of property

August 9, 2025
5

Israel ground forces raid Central Gaza as war enters 21st day

October 27, 2023
6

Defamation: Court orders SERAP to pay DSS officials N100 million

May 5, 2026

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Port Harcourt refinery kick-off postponed 6th time

August 14, 2024

Alleged forgery: Court grants human rights lawyer Ozekhome, one other ₦10 million bail each

February 27, 2026

Varsity lecturers threaten fresh strike, says FG has destroyed trust on 2009 agreement

August 21, 2025

JUST IN: Nigeria’s Pinnick loses re-election into FIFA Council

March 12, 2025
Top posts

Categories

  • News4561
  • Politics4128
  • Crime3909
  • International2751
  • Sports2274
  • Business & Economy2121
  • Headlines2076
  • Education1263
  • Matilda Showbiz899
  • Health805
  • Entertainment740
  • Africa472
  • Religion450
  • Environment320
  • Special262
  • Arts & Culture227
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Info Tech220
  • Interview177
  • Inside Akwa Ibom Today173
  • Opinion145
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade117
  • Advert30
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Trends16
  • Local News4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact