Skip to content
Tuesday 13 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Brand new second-hand guonguoro for sale

The FrontierThe FrontierSeptember 7, 2024 3112 Minutes read0

As tings come be now, na im be say all of us wey dey for Naija no know wia we dey go again.

Na so I carry one bobo like dat dis week go drop for Gbagada Estate. As we comot for our garage wey dey near Ikeja under bridge, we no even reach Alausa wen di bobo begin shout for back seat wey e siddon. Afraid catch me, I think say weda im village people don find am reach my guonguoro. If to say I no be ogbonge taxi driver wey hand strong gan, I for go jam electric pole for dat road. Olorun maje!

I match break fiaaam! I clear for dat Secretariat road and park. I turn back and ask di bobo wetin happen. Instead make di bobo answer me, e jus dey shout dey go, “Na wetin we do dis Baba o! Shey, dis Baba come kill everybody for Naija finish? Tori Olorun!”

SDP Poster Layout

I come dey beg di bobo make e calm down tell me wetin happen. I ask am which Baba wan kill Naija people finish and how.

Na dat time di bobo tell me say e jus read for news inside im phone say gofmen don increase petrol price to N900 for one litre. Olorun Oba o!

Me sef come begin shout my own. Di bobo sef no fit control me again. Na so di two both of us come begin dey cry like two small pikin dem. And na so we come dey tell oursef “sorry, sorry, no cry again, e don do. God dey. We no go peme lai lai”.

I come open my ignition, start di engine again, put am for gear one and begin dey go small, small till I go drop di bobo for Gbagada Estate.

As I begin dey come back, I jus dey talk am for my mind say, wia we dey go for dis Naija?

Petrol no even cost like dis, na so, so hungry people dey hungry, sote Naija people come put am for song say “Ebi n pa wa oooo!”.

And true, true, since dat Tuesday dis week, Ebi don pa plenty people.

Di petrol sef, nobody dey see am buy. If you get lucky see any petrol station wey use style open, di money wey dem go call for you, no be person go tell you make you carry your motor for head comot for dia.

Since den, I don park my guonguoro for our compound wey dey Abule Egba. I write am put for on top say “For Sale”. If na to sell Pure Water to take feed my family, I ready to sell am. Wetin be say person get taxi, no petrol to take drive am? No be juju be dat?

Abeg, if you know person wey wan buy brand new Naija second-hand guonguoro, tell am say I dey. No be tokunbo o. I go give you somtin inside di money wen di person pay.

Make we jam again next week Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

 

Tags
Brand newfor saleguonguoroOga MATsecond-hand
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post After Ronaldo, Jude Bellingham launches own YouTube channel
next post ROMANCE GONE SOUR: My husband chases me around our neighbourhood with cutlass after smoking Indian hemp
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gossips

My wife knew I dated actresses, yet didn’t fight them – Yoruba actor Yinka Quadri

October 10, 20260
Gists

Fame hasn’t changed my sense of humour — Nigeria’s songbird Ugoccie

October 10, 20260
Gists

Felabration 2026: Former Femi Kuti backup singer and dancer Emee Freda returns to Shrine with new artistic identity

October 10, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
News

Child soldier: US blacklists Nigeria, threatens to cut military aid

October 13, 20260
Business & Economy

17.9 million Nigerians fall into poverty in three years – Report

October 13, 20260
Crime

Kidnapped couple begs for rescue from captivity •Abductors demand N300 million ransom

October 13, 20260
Business & Economy

Anxiety as crude oil hits $106, raises fuel price despite 30-day discount by FG

October 13, 20260
News

Youth Corps member killed, several injured as speeding truck rams into multiple vehicles

October 13, 20260
Entertainment

I wish I had my father’s brain – DJ Cuppy, daughter of billionaire businessman Femi Otedola

October 13, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Child soldier: US blacklists Nigeria, threatens to cut military aid

October 13, 2026

17.9 million Nigerians fall into poverty in three years – Report

October 13, 2026

Kidnapped couple begs for rescue from captivity •Abductors demand N300 million ransom

October 13, 2026

Anxiety as crude oil hits $106, raises fuel price despite 30-day discount by FG

October 13, 2026

Youth Corps member killed, several injured as speeding truck rams into multiple vehicles

October 13, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Child soldier: US blacklists Nigeria, threatens to cut military aid

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

World Cup qualifier: Osimhen, others arrive Super Eagles camp ahead crunch Rwanda game

March 17, 2025
3

Anger over fatal Minneapolis shooting fuels US protests

January 11, 2026
4

Trade wars intensify as US tariffs on Canada, Mexico, China take force

March 4, 2025
5

Edo guber: Resist APC’s plot to smuggle unaccredited agents – PDP tells INEC

August 30, 2024
6

IT’S FAKE NEWS: Tinubu didn’t award national honour to activist Aisha Yesufu – Presidency

June 14, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Nigerian sets world record after reading out loud for 215 hours

August 28, 2024
3

Supreme Court judgement: Abure kicks as Obi, Otti, stakeholders affirm Labour Party Caretaker Committee

April 9, 2025
4

Chibok parents mourn former President Buhari, want urgent action to bring back 87 missing girls

July 22, 2025
5

Governor warns parents against pressuring fresh graduates

December 14, 2025
6

BEWARE: Former flight attendants caution travellers on risky in-flight meals, drinks

September 6, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

JUST IN: NECO releases 2026 SSCE results, 58.67% secures five credits

September 24, 2026

Discordant tunes over Tinubu’s plan to deploy Forest Guards to curb kidnapping

January 20, 2024

155 killed in Tanzania as heavy rains lash East Africa

April 25, 2024

Drug trafficking: 3 Nigerians held in India with ₦801million narcotics

July 8, 2025
Top posts

Categories

  • News5137
  • Politics4837
  • Crime4601
  • International3210
  • Sports2582
  • Business & Economy2372
  • Headlines2281
  • Education1446
  • Matilda Showbiz1047
  • Health937
  • Entertainment880
  • Africa615
  • Religion497
  • Environment396
  • Special279
  • Info Tech261
  • Arts & Culture243
  • Inside Akwa Ibom Today231
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview196
  • Opinion158
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade137
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact