Skip to content
Monday 26 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Di kind cold wey dey now na wa

The FrontierThe FrontierAugust 23, 2025 1623 Minutes read0

•Replay

Dis cold wey dey for Naija now get as e be. Di tin carry weight, no be small. Even di cold wey dem dey talk say e dey for Oyibo contry, na small pikin for dis Naija cold wey dey now.

Wen di cold begin blow last month, people talk say e go disappear wen rain fall.

SDP Poster Layout

Last week, rain fall for Lagos ti-ti-ti-ti, sote all di road for Lagos turn to emergency lagoon, still, di cold no shake body up till dis time wey I dey nack una dis tori so.

Di order day, I hear one Agege market woman talk say dis cold na wintch bring am. I say na wa for Naija people o. Everyting wey happen na wintch cause am. But if na for Oyiboland, dem for find one fine woman name give di cold. Dem fit call am Katrina or Elizabeth.

Anyway sha, na we Lagos taxi driver suffer dis cold matter pass. Di cold dey show us di Good, di Bad and di OBJ…sorry…na and di Ugly I wan talk o. (Make dis my mouth no put me for wahala one day. Help me say Amin!).

Di good ting be say, now, me and my wife Bose don dey like 5 and 6.

Wen I don close work for night, go reach our house wey dey for Abule Egba, wen I chop finish, enter bed, Bose go use style lef our two woman pikin dem – Bisi and Funke – for parlour, come meet me for bedroom. Na so Bose go fold im body like say e dey inside ice water. E go tell me say cold don finish am. I go lock door, draw am enter bed, use heavy blanket cover di too both of us. Na so me and Bose go gum our body togeder – bie bie to bie bie – under di blanket. Before you say Jack, we don start bend-bend sleep be dat.

Dat time I go talk am for my mind say, see my wife wey no dey let me near am for bed teletele before dis cold come.

To say we never dagba, Bose for don carry belle and born pikin by next year, and I for name di pikin Tutu.

Na im make I talk say dis cold na Good ting for me, and na im make I no wan make di cold go.

I no dey branch for Madam Shine buka again wen I close work for evening since wen dis cold start. After all, wetin dey for Sokoto dey for shokoto trouser.

But di Bad and di Ugly side be say, na we wey dey do taxi driver work dey suffer for dis cold hand pass.

Una kukuma know say people no dey baf again. If you see anybody wear suit and heavy clothe waka for road, check am well well, you go discover say di person jus wear di big clothe make cold no enter im body.

Na so inside my guonguoro dey choke now becos passenger dem no dey baf, na so so perfume dem dey pour for body – from head to toe – and na so inside di guonguoro go come choke gan.

Di order day, two passenger dem – one sisi and one bobo like dat – come meet me for our garage wey dey near Ikeja under bridge. Di two both of dem wear heavy suit plus tie take cover body make people tink say na one big meeting like dat dem dey go. Dem say make I carry dem for drop go Mafoluku. I tell dem my price, dem gree. I say make dem enter. I open ignition, start engine, put am for gear one and move.

We no even climb dat flyover for railway line near Ikeja Council wen I begin cough pussy cat. I cough sote I nearly drive go jam electric pole. Olorun maje!

Na di kind wicked perfume wey dis bobo and sisi pour for dia body as dem no baf dat morning becos of cold, na im been wan finish me so o.

Tank Eledumare say, I still manage drive dem go reach Mafoluku and collect my money. Olorun Oba o!

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
colddey nowDi kindna waOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM •Week 34
next post Hot Lyrics: LAYE MI, by Bnxn
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Abuja Afrojazz Festival targets global opportunities for Nigerian musicians

October 24, 20260
Gists

Fela lives on in Kwara as state celebrates his life, legacies

October 24, 20260
Gists

BBNaija should take a break, re-strategise — Reality TV star Tacha

October 24, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

ARISE Projects Impact

February 9, 20250
Entertainment

How Nigerians can apply for frontline music producer Don Jazzy’s 2027 tech scholarship

October 26, 20260
Crime

Man remanded for allegedly impersonating Kwankwasiyya praise singer

October 26, 20260
Crime

Insecurity: Stakeholders urge state assemblies to fast-track state police legislation

October 26, 20260
Politics

2027: APC accuses ADC of owing staff over one year’s salaries

October 26, 20260
Crime

FBI arrests nine in Nigeria over cyber crime, seizes 53 electronic devices

October 26, 20260
Sports

Man Utd crisis deepens as Carrick faces axe

October 26, 20260
Load more

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

How Nigerians can apply for frontline music producer Don Jazzy’s 2027 tech scholarship

October 26, 2026

Man remanded for allegedly impersonating Kwankwasiyya praise singer

October 26, 2026

Insecurity: Stakeholders urge state assemblies to fast-track state police legislation

October 26, 2026

2027: APC accuses ADC of owing staff over one year’s salaries

October 26, 2026

FBI arrests nine in Nigeria over cyber crime, seizes 53 electronic devices

October 26, 2026

ARISE Projects Impact

0 Comments

How Nigerians can apply for frontline music producer Don Jazzy’s 2027 tech scholarship

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

INEC to conduct mock accreditation using upgraded BVAS in Anambra

October 19, 2025
3

FG floats National Health Fellows Programme for youths in all 774 LGAs, calls for application

January 21, 2025
4

Shakira, Burna Boy release official 2026 FIFA World Cup song ‘Dai Dai’

May 15, 2026
5

Actress Regina Daniels insists on maiden name amid marital crisis with Senator Nwoko

March 10, 2025
6

Rivers Assembly fire: We’re under pressure to implicate Governor Fubara’s chief of staff – Acquitted persons

April 7, 2025
Popular
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

REVEALED: Real reasons we plotted coup against Tinubu — Colonel Ma’aji

August 11, 2026
3

Ghana Supreme Court upholds anti-LGBTQ bill

December 18, 2024
4

Weather forecast: ‎NiMet predicts 3-day dust haze, sunshine

January 3, 2026
5

Rumpus over relocation of federal agencies to Lagos

January 23, 2024
6

Naira falls in parallel market

May 12, 2026

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

‘Suspicious’ men arriving Lagos in viral video: Police react •VIDEO

May 16, 2025

497 stranded Nigerians repatriated from Niger Republic

May 24, 2026

Man Utd on right track despite 13th Premier League defeat, says Dalot

April 2, 2025

ECOWAS cash-strapped before Nigeria paid ₦85 billion, $54 million levy — Official

December 16, 2024
Top posts

Categories

  • News5185
  • Politics4910
  • Crime4663
  • International3256
  • Sports2618
  • Business & Economy2390
  • Headlines2298
  • Education1456
  • Matilda Showbiz1062
  • Health971
  • Entertainment895
  • Africa622
  • Religion504
  • Environment406
  • Special279
  • Info Tech268
  • Arts & Culture245
  • Inside Akwa Ibom Today237
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview200
  • Opinion159
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade139
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact