Skip to content
Saturday 24 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

I don dey use my guonguoro like danfo for dis new year

The FrontierThe FrontierJanuary 18, 2025 2742 Minutes read0

If dis our Naija no kill man pikin, man pikin go kill Naija. I swear!

Everyting don turn upside down for our contry. Light no dey as national grid dey collapse every minute. Money no dey, food no dey. And di one wey worry me pass na petrol. To buy petrol now na like gold. Today dem go tell us say petrol price don come down, tomorrow dem go say petrol price don go up again. Petrol and Naira now na Taiwo and Kehinde – twins. Na so di two both of dem jus dey go upandan. Tori Olorun!

And without petrol, na im be say we taxi driver no get work again be dat.

SDP Poster Layout

Everyday, na so we go siddon for our garage wey dey near Ikeja Under Bridge, from morning till night, no passenger go show face. People no get money to enter taxi again. Olorun Oba o!

Na so I siddon yesterday for garage dey tink ti-ti-ti-ti. 12 O’clock pm in di afternoon don nack, no passenger. 1 O’clock, 2 O’clock, di same ting. Kilode?

I talk am for my mind say, if I close for evening begin go our house for Abule Egba, wetin my family go chop? And na weekend we dey so.

Na im I quick, quick use my head do aritmetic. I enter my guonguoro, drive am go di order side of di road wey danfo dem dey load passenger go Maryland. Na so I stop, come out, open all my door down. Agbero dem for di bus stop come dey hail me, “Oga MAT wetin happen for dis new year o! Why you comot for taxi park come join danfo dem for bus stop? Twale Baba!!!”

I ask dem weda dem no see as Naija dey now. I say passenger dem no dey come near our garage again from morning till night. I tell Dem to begin load my guonguoro, di same money wey danfo dey collect go Maryland. I give di four both of dem 1k. Agbero dem head scata patapata.

Before I open eye sef, my guonguoro don full – two passenger for front, five for backseat. Dem even ask me weda make dem put anoder passenger for inside boot.

I don carry my passenger dem dey go be dat.

As we dey go, one passenger drop for Police College, one drop for Ikeja Country Club junction, two drop for Abule bus stop, one drop for Leventis bus stop. And as dem dey drop, na so I dey carry anoder passenger like danfo.

Everybody come down for Maryland. Na so I turn my guonguoro face Ikeja, begin load passenger dem again.

My broda, as I reach our garage, my pocket don full. I jus use style dey go Madam Shine buka to take My Usual before I begin go house.

Man pikin no go come peme for Naija for dis new year.

Helep me say Amin!

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
danfoguonguoroNew YearOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: PIECE OF MY HEART, by Wizkid ft Brent Faiyaz
next post Timaya’s relationship with Black American TV star Brooke Bailey hots up
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

REVEALED: Two movie roles that pushed me out of my comfort zone — Actress Etinosa

October 17, 20260
Matilda Showbiz

Neto double gives Chelsea win over Everton; marred by Martinez injury

October 17, 20260
Gists

Walk away if marriage isn’t working — Nollywood actress Uche Ogbodo

October 17, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

ARISE Projects Impact

February 9, 20250
Business & Economy

Nigeria’s poultry farmers demand urgent action over rising costs, feed shortages

October 23, 20260
Politics

Tinubu to inaugurate 81km Abuja-Kaduna Highway at APC campaign flag-off tomorrow

October 23, 20260
Crime

Gunmen attack NDC candidate’s convoy, kill one, injure three

October 23, 20260
Politics

Tinubu’s 90-day relief plan a scam to bait voters ahead 2027 elections — ADC Presidential Campaign Council

October 23, 20260
Crime

Building storing bottles for fake alcohol uncovered in Lagos

October 23, 20260
Crime

Four Police officers detained over viral harassment video in Lagos

October 23, 20260
Load more

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

Nigeria’s poultry farmers demand urgent action over rising costs, feed shortages

October 23, 2026

Tinubu to inaugurate 81km Abuja-Kaduna Highway at APC campaign flag-off tomorrow

October 23, 2026

Gunmen attack NDC candidate’s convoy, kill one, injure three

October 23, 2026

Tinubu’s 90-day relief plan a scam to bait voters ahead 2027 elections — ADC Presidential Campaign Council

October 23, 2026

Building storing bottles for fake alcohol uncovered in Lagos

October 23, 2026

ARISE Projects Impact

0 Comments

Nigeria’s poultry farmers demand urgent action over rising costs, feed shortages

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

Imported used vehicles to undergo testing, certification before entering Nigeria

December 22, 2025
3

Expel Wike, Ortom from PDP – Former Governor Lamido tells party leadership

August 10, 2025
4

Eminent citizens, CSOs flay president, governors’ use of public funds for private trips

February 8, 2024
5

BREAKING: Prof Amupitan emerges new INEC chairman

October 9, 2025
6

Comedian AY confirms EFCC invitation for spraying Naira, foreign currencies

May 7, 2025
Popular
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

Suspended Senator Natasha set to resume duty – Lawyer

September 8, 2025
3

We can feel your support – Governor Fubara appreciates Rivers people

March 7, 2025
4

Languishing Chelsea crash against Wolves, Hojlund sparks Man Utd’s win

February 4, 2024
5

Rich countries harvest 20,000 Nigerian health workers

July 25, 2026
6

Nollywood diva Rukky Sanda’s glamorous lifestyle •PHOTOS

March 14, 2026

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

2027 elections: INEC unveils mock presidential election plan

July 17, 2026

Immigration, labour reforms in Saudi Arabia: Reps urge FG to rescue stranded Nigerians

May 22, 2025

BREAKING: FG relocates FAAN headquarters back to Lagos

January 18, 2024

Declare state of emergency on security – PFN tells Tinubu

February 9, 2024
Top posts

Categories

  • News5179
  • Politics4897
  • Crime4654
  • International3248
  • Sports2609
  • Business & Economy2387
  • Headlines2297
  • Education1456
  • Matilda Showbiz1054
  • Health964
  • Entertainment893
  • Africa621
  • Religion504
  • Environment405
  • Special279
  • Info Tech268
  • Arts & Culture245
  • Inside Akwa Ibom Today236
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview198
  • Opinion159
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade138
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact