Skip to content
Friday 2 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

I don tire, I dey go back to my village

The FrontierThe FrontierOctober 18, 2025 1953 Minutes read0

Updated

Di way dis our Naija be now, everybody don get sense by force. Since wen Emilokan carry price of petrol hang for up, we wey dey do taxi driver work don hear nwi.

If na only petrol, e for good small sef, but spare parts nko? Even to service motor na helele.

Na im make I dey always hold my guonguoro like egg make e no just drop for ground. If di ting spoil, dat one mecho dem go take me do ntanta.

I tank Eledumare for di passenger wey I carry yesterday. Di bobo come our garage wey dey near Ikeja under bridge, e say make I carry am for drop go Apapa Wharf. I tell am my price, e say no troublem, say make I just carry am dey go kia kia, say e dey for hurry.

Na so we begin dey go. As we dey go, di bobo dey make call, dey tell person say make e no comot for Wharf, say e dey road and e go reach Wharf in 10 minutes.

Dat time we never even pass Police College for Ikeja o. Tori Olorun!

I talk am for my mind say shioooor, some people sabi lie no be small. I say dis man name go be Linus or Lai sombori. Even if na aeroplane e take, how e go reach Apapa Wharf in 10 minutes wen e never comot for Ikeja? Olorun Oba ooo!

Na as we dey go for road, di man come talk say e dey rush go meet somebody wey dey wait for am for inside Apapa Wharf to sell empty container for am, say di man don dey wait for am tipe tipe and di man say e no fit wait again as time don dey go.

E say e no wan miss dat empty container, say e wan use am do house becos im landlord give am quit notice make e comot dis month end. E say e don tire to pay house rent to Lagos landlord dem, so e wan use di empty container do house wey e go stay with im family.

E also talk am say di water wey e dey buy for Aboki hand everyday don even pass di house rent becos im landlord no dey gree pump water for borehole, even wen e dey collect money from all di tenant dem every month to take pump water.

I ask am weda dem dey use empty container do house. Di bobo say make I siddon dia, say wen e finish to design di empty container turn am to flat, nobody go know say na empty container e take do house.

As we reach Wharf, di bobo pay me and begin run inside Wharf. I revise my guonguoro, begin dey go back.

I come begin dey tink wetin dat my passenger talk. If I fit use empty container do flat, why I still dey pay house rent for Baba Braimoh face-me-I-face-you house wey I dey live with my family for Abule Egba? And na every year Baba Braimoh dey increase di rent money.

If I tell una di kind money wey I dey pay Baba Braimoh for di small room and parlour wey we dey stay, you no go believe lai lai.

Na im I come talk say, I don tire to pay all dis Lagos landlord dem money for house rent wey dem dey increase anytime dem turn body. If I buy empty container carry go my village for Ogbomoso, go design am and turn am to flat like dat my passenger, sebi I don get my own house be dat. And I go dey for dia with my family dey do my taxi driver work, as landlord, abi na containerlord.

Anyway sha, weda na landlord or na containerlord, lord na lord.

Abi, how you see am?

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
I don tiremy villageOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post ROMANCE GONE SOUR: My wife ridicules me ’cos I fail to perform in bed
next post Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM •Week 42
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Matilda Showbiz

I don become married bachelor. Tori Olorun!

September 26, 20260
Gists

Africa Magic airs documentary celebrating late veteran actor Olu Jacobs’ legacy

September 26, 20260
Gists

Celebrity boxing against BBNaija star Phyna: Nollywood actress Nkechi Blessing spits fire, brimstone

September 26, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Sports

Team manager Tuchel open to picking players outside Premier League for England

October 2, 20260
Education

University of Ibadan remains Nigeria’s best in new research ranking — Report

October 2, 20260
International

Schools shut as violent protest breaks out in France

October 2, 20260
Crime

Boko Haram terrorists gun down farmers in Borno

October 2, 20260
Arts & Culture

Kano Durbar: Emir Sanusi, Bayero risk arrest for breach of peace

October 2, 20260
News

Edo governor’s aide, social media commentator clash over state govt criticisms

October 2, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Team manager Tuchel open to picking players outside Premier League for England

October 2, 2026

University of Ibadan remains Nigeria’s best in new research ranking — Report

October 2, 2026

Schools shut as violent protest breaks out in France

October 2, 2026

Boko Haram terrorists gun down farmers in Borno

October 2, 2026

Kano Durbar: Emir Sanusi, Bayero risk arrest for breach of peace

October 2, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Team manager Tuchel open to picking players outside Premier League for England

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Lagos govt shuts Lord’s Chosen Church, Mountain of Fire, others over noise pollution •FULL LIST

December 17, 2024
3

Nigeria’s rising external debt service raises red flags, say analysts

August 6, 2025
4

Increasing rate of poverty, hunger in Nigeria worrisome — CAN, JNI

March 7, 2024
5

Hope for cancer patients: AstraZeneca partners health ministry to commission molecular testing in Nigeria

July 31, 2024
6

Apapa gridlock returns as E-call-up system collapses •Operators accuse NPA of racketeering

October 27, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Series of earthquakes rattle Ethiopia, triggering evacuations

January 5, 2025
3

Defence chief urges communities to protect pipelines

July 16, 2025
4

Osun Decides: Why today’s election is about more than who is Governor

August 15, 2026
5

Senator to Tinubu: Nigerians suffering, let the middle class breathe

October 21, 2024
6

Senate considers increasing Supreme Court judges to 30

June 14, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Ramadan: Sultan asks Muslims in Nigeria to look for new moon tomorrow

February 27, 2025

Telecom tariff increase: TUC threatens nationwide strike

February 7, 2025

Conveyor belt vehicle hits Air Peace aircraft at Lagos airport, disrupts flight operations

July 15, 2026

Osun governorship election: INEC seeks media support against vote buying

June 30, 2026
Top posts

Categories

  • News5091
  • Politics4797
  • Crime4573
  • International3176
  • Sports2564
  • Business & Economy2355
  • Headlines2264
  • Education1436
  • Matilda Showbiz1032
  • Health923
  • Entertainment867
  • Africa613
  • Religion493
  • Environment392
  • Special279
  • Info Tech258
  • Arts & Culture243
  • Inside Akwa Ibom Today226
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview194
  • Opinion157
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade136
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends24
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact