Skip to content
Monday 31 August 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

I no dey for Keresimesi day, I don travel

The FrontierThe FrontierDecember 20, 2025 1142 Minutes read0

Dem dey talk am say body no be wood. And na true talk.

You sef check am nah. Everyday di son of man dey for Lagos road 24/7, dey carry passenger dem upadan.

And na orisirisi tings I dey see for road – di good, di bad, and di OBJ (sorry, abeg no vex. I been wan say “…and di ugly”, but my tongue come sleep. If na lie I talk, make I baf naked for bafroom. Make una helep me wake up dis my tongue before e land me for wahala.

As I been dey talk am tele tele before my tongue sleep, I dey see orisirisi tings for Lagos road in di curse (Olorunmaje) of dis my taxi driver work.

Shey na amu robber dem we go talk? Abi na all dis Lagos sisi dem wey go enter my guonguoro for night but begin dey find anoder ting becos dem no wan pay? Dem go tell you say dem wan pay in kind instead of in cash. And dem ready to do anyting for you to park for roadside and do dem kini sharp sharp inside di guonguoro. Tori Olorun!

Gbomo gbomo and Area Boy dem nko? All di orisirisi uniform people sef dey dia o, and dem kukuma plenty – Soja o, Olopa o, Road Safety o, Maja Maja o, LASMA o, Council o – all of dem dey lay ambush for road.

Even VIO dem dey dia. Dose one na wintch, dem no dey leave person rarara. If you like, make everyting complete for your motor, dem must still find somtin to take catch you. No be wintch be dat? I tank Eledumare say dis gofment don ban dem for road. Make dem siddon for dia office with dia wintch.

My broda, e no easy at all, at all. Na im make I dey always tank Eledumare any time I reach house every day.

And na im make I don decide say, for Keresimesi day gan gan, I no go jus show face for our garage wey dey near Ikeja under bridge. And I no go dey for my house for Abule Egba. No ask me wia I go dey. Di only ting I fit tell you small for now be say, Sikiratu don already di short time wia di two both of us go dey for Keresimesi day.

But dis ting wey I tell you so na secret o, na confidential matter between me and you. Abeg, no let my wife Bose, and my two woman pikin dem – Bisi and Funke – hear am o. Promise?

I go still nack una di tori how me and Sikiratu take waka.

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
Keresimesi dayOga MATtravel
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Iran executes man accused of spying for Israel
next post ROMANCE GONE SOUR: My sister-in-law told my husband I’m carrying another man’s pregnancy
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Interview

I’ll live forever through my music — Prolific singer and producer Pheelz

August 29, 20260
Gists

Funke Akindele is kind, generous despite strict nature – Nollywood actress Ronke Oshodi-Oke

August 29, 20260
Gists

BBNaija Season 11: Your peace call not convincing – Nomy tells Tram

August 29, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Sports

BREAKING: Messi retires from international football, says ‘Nothing more to give’

August 31, 20260
News

TRAGEDY: Three sisters drown as boat capsises in dam

August 31, 20260
Politics

Opposition Summit: We’ll support any candidate who emerges – Former Governor Donald Duke

August 31, 20260
Education

Varsity lecturer, students, caught in exams fraud

August 31, 20260
Education

Students demand clear answers over kidnapped Youth Corps members

August 31, 20260
News

2027: Police, Military, other agencies commence election security training

August 31, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

BREAKING: Messi retires from international football, says ‘Nothing more to give’

August 31, 2026

TRAGEDY: Three sisters drown as boat capsises in dam

August 31, 2026

Opposition Summit: We’ll support any candidate who emerges – Former Governor Donald Duke

August 31, 2026

Varsity lecturer, students, caught in exams fraud

August 31, 2026

Students demand clear answers over kidnapped Youth Corps members

August 31, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

BREAKING: Messi retires from international football, says ‘Nothing more to give’

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Chelsea ready to sell Armando Broja amid Fulham and Wolves transfer battle

January 29, 2024
3

Freight forwarders write Tinubu as cartels sell e-call up code for N400,000

May 13, 2025
4

Spanish Mayor bans DR Congo pre-World Cup friendly match due to Ebola fears

June 3, 2026
5

Nigerian workers slam IMF for fuel subsidy removal denial

October 28, 2024
6

Israel to ban 37 NGOs in Gaza

January 1, 2026
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Peter Obi’s private visit to APC chieftain sparks 2027 political speculation

November 27, 2024
3

Wanted cultist terrorising Bayelsa business owners, residents nabbed

August 20, 2024
4

Late naturalised Nigerian, Roomans’ Will: Court asks parties to maintain status quo

January 28, 2025
5

Tinubu writes Senate, seeks confirmation of ministerial nominees

October 24, 2024
6

Again, Police summon NLC President Ajaero to Force Headquarters

August 30, 2024

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Epistles of Anthony Kila: Sirika, drowning wings and the rest of us

February 9, 2024

LCCI elects Leye Kupoluyi as President, Chairman of Council

December 5, 2025

TRAGEDY: 5 worshippers die after church feast

September 30, 2024

Defection: PDP prays court to sack lawmaker

May 26, 2025
Top posts

Categories

  • News4972
  • Politics4633
  • Crime4442
  • International3072
  • Sports2482
  • Business & Economy2286
  • Headlines2232
  • Education1384
  • Matilda Showbiz999
  • Health886
  • Entertainment822
  • Africa587
  • Religion486
  • Environment373
  • Special277
  • Info Tech247
  • Arts & Culture240
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today206
  • Interview188
  • Opinion154
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade132
  • World Cup 202695
  • Advert34
  • Trends23
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact