Skip to content
Sunday 26 July 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

I wan begin do dry fasting

The FrontierThe FrontierJuly 13, 2024 2062 Minutes read0

Replay 

Di kind orisirisi tings wey man pikin dey see for dis our taxi driver work, person no fit talk am finish.

Di order day, trailer nearly push me, my guonguoro and my passenger inside Lagos Lagoon. Helep me say Olorun maje!

Na so I carry one madam like dat for drop go Balogun market. We take Alapere, pass Oworonshoki, den climb IBB Bridge.

We never reach half di bridge wen I hear pppoooaasrrrhhh!!! My front tyre don burst be dat. Na so my steering begin carry me go left, right and center of the bridge, on top speed o. Tori Olorun!

Una kukuma know as plenty motor dey fly for dat bridge. My passenger shout. E begin speak in tongues. I say madam calm down, na ordinary tyre burst, no be anoder ting. Di madam no hear me, na so e dey hala prayer, e come dey shout say, “Driver stop! Stop!! Stop!!! I no mind am. I jus manage until di guonguoro slow down and stop. I clear am comot for road, park for sidewalk.

Di madam come dey rush to open di door of di back seat wey e siddon, di door no gree open. I tell am make e take am easy, say I go come down and open di door for am.

I open my driver door, but my broda, to come down come be wahala. Na so I come dey struggle to come down, na lie. My belle no gree me. Na so my belle hook for steering wheel. Come see as plenty motor jus dey fly pass us sote one trailer nearly hit us for bank. Olorun Oba o!

Las las, I manage come down, turn go open door for di madam make e come down make I change di tyre.

Wen I finish, I carry di madam go drop for Balogun market.

Wen I dey come back for road, I talk am for mind say I must do somtin about dis my belle wey don come out so like woman wey get belle.

My wife Bose na im first tell me last week say my belle don too big. All our union member dem for our garage wey dey near Ikeja under bridge, don tell me di same ting. Everybody don talk am.

I no come know weda na My Usual wey I dey nack for Madam Shine buka every night wen I close, plus point-and-kill and nkwobi, na im come shoot my belle out for dis Emilokan time wey everybody dey shout “Ebi n pa mi o!”

I don decide say, from tomorrow I go begin do dry fasting. Na di only ting wey go force my big belle inside be dat, make di son of man no come peme before im time.

Make we jam again next week.

Tank you,

Tank you very much,

And tank you very very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
begindryfastingOga MATwan
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post ROMANCE GONE SOUR: My husband denied me sex for more than a year, I can’t bear it any longer
next post Hot Lyrics: BENIN BOYS, by Rema ft. Shallipopi
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Why I never wanted to be linked to my late grandpa Obafemi Awolowo when I went for BBNaija  —  Seyi

July 25, 20260
Gists

Pal Akalonu: Man who shaped Nigeria music; produced Christy Essien, Oriental Brothers, others

July 25, 20260
Gists

I left public eye to build my brands — Nollywood actress Tayo Sobola

July 25, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Health

Lassa fever death toll hits 229 as fresh infections rise

July 26, 20260
Sports

Arsenal eye Vinicius Jr as Real Madrid push for Diomande — Reports

July 26, 20260
Politics

Voter registration: INEC ends exercise today as opposition demands extension

July 26, 20260
Sports

BREAKING: Anthony Joshua wins first match after December deadly accident in Nigeria

July 26, 20260
International

Nigeria’s envoy to India assumes duty, targets stronger trade, investment ties

July 26, 20260
News

New NURTW chairman in Osun counters Governor Adeleke’s directive, resumes motor park activities

July 26, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Lassa fever death toll hits 229 as fresh infections rise

July 26, 2026

Arsenal eye Vinicius Jr as Real Madrid push for Diomande — Reports

July 26, 2026

Voter registration: INEC ends exercise today as opposition demands extension

July 26, 2026

BREAKING: Anthony Joshua wins first match after December deadly accident in Nigeria

July 26, 2026

Nigeria’s envoy to India assumes duty, targets stronger trade, investment ties

July 26, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Lassa fever death toll hits 229 as fresh infections rise

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Again, Trump fined $10,000 for violating gag order

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Buhari, Tinubu never prepared for governance — Bishop Kukah

November 25, 2024
3

Heathrow unveils £49 billion expansion plan for third runway

August 1, 2025
4

Me sef don move

June 7, 2025
5

Peter Obi visits former President Obasanjo, Ladoja in SouthWest shuttle

September 15, 2025
6

Thousands throng Abuja, Lagos parks for Tinubu’s reduced fares

December 25, 2024
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Southern Kaduna Christian leaders declare 2-day fast over Kajuru kidnapping

January 22, 2026
3

Alleged sexual harassment: Women set to protest in support of Senate President Akpabio at UN House tomorrow

March 13, 2025
4

My sister died after doctor forgot scissors in her stomach – Sibling

April 25, 2026
5

IMF warns Nigeria’s declining GDP per capita signals shrinking prosperity

February 10, 2025
6

Bayern-Union match postponed due to heavy snowfall

December 2, 2023

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Arabic teacher jailed 21 years for attempted sexual assault of minor

January 15, 2025

FIFA ranking: Top 10 African countries •FULL LIST

November 30, 2023

Directors of aviation agencies sacked hours after CEOs’ removal

December 14, 2023

Israeli air strikes hit Yemen airport, power stations

May 6, 2025
Top posts

Categories

  • News4810
  • Politics4429
  • Crime4279
  • International2959
  • Sports2381
  • Business & Economy2230
  • Headlines2179
  • Education1336
  • Matilda Showbiz967
  • Health851
  • Entertainment779
  • Africa555
  • Religion475
  • Environment356
  • Special271
  • Info Tech236
  • Arts & Culture234
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today196
  • Interview183
  • Opinion150
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade126
  • World Cup 202694
  • Advert32
  • Trends20
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact