Skip to content
Sunday 13 September 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Me sef don move

The FrontierThe FrontierJune 7, 2025 2353 Minutes read0

Di kind work wey I do for dis Sallah, I never do am since I start dis my Lagos taxi driver work.

Come see as I dey carry family dem go mosque like water. If I drop one family, anoder family go stop me make I carry dem. No do, no do, I go don carry like 20 family dem go mosque for different place for Ikeja and outside dat yesterday.

And as dem go pray finish, na so I begin carry anoder set of family dem dey go drop for dia house, one by one. E come be like say all of dem jus dey wait for me.

My broder make I no lie, my pocket full gan. But na my guonguoro suffer am becos say, dose woman passenger dem na orisirisi nyansh dem carry. Some of dem big pass Dunlop elite sef, sote wen dem enter my guonguoro, my guonguoro go nearly faint. But, shebi na money I dey find.

Na im make I quick close dat yesterday, go our house wey dey for Abule Egba. My wife Bose, and my two woman pikin dem – Bisi and Funke – shock as I come back house before 7 O’clock pm in di evening.

I jus pack my guonguoro, enter house, open my shokoto trouser pocket, bring out money give Bose say make e take go buy tings for market come cook better Efo riro soup and Poundo with Bokoto for di family, say after all na holiday all of us dey.

As I say make I run go wee wee for bafroom, come see long queue. E come be like say na all di tenant dem for Baba Braimoh face-me-I-face-you house wan enter bafroom di same time. Una kukuma know say, na public holiday, so everybody complete for house.

I no fit join di queue, I jus face one corner like dat near di bafroom wey dey for outside di main house, bring out my kini and wee wee. After all, I no be woman.

I go back to our room, siddon for chair to rest small make Bose come back come cook make I eat night food, di only ting wey dey for my mind dat time na make I move…

Ahmed jus drive im long truck enter our compound. As e clear di truck and park for one corner, I tell my family oya o, make we begin pack all our load put for di truck. Say we must move.

My second woman pikin, Funke wey im mouth dey always sharp, ask me say “Daddy, move go wia?”

I tell am say we dey go new house, say I don tire for dis Baba Braimoh face-me-I-face-you house wey I don dey live with dia Mama even before dem born. I come tell Funke say, if e no wan move with me, no wahala, but na im be say e no wan be my pikin again.

Na so we pack everyting put for di truck. I carry my family for my guonguoro and tell Ahmed to drive im truck follow me for back.

We drive enter our new house, mehnnn, come see fine house!

Di ting be like Palace – 3-bedroom flat, 4 toilet/bafroom for inside house, tiles everywhere!

I come talk am for my mind say, so na me and my family go now live for dis kind Palace? No more Baba Braimoh face-me-I-face-you house wahala. No more queue to wee wee, shit or baf. No more general kitchen, etc etc. Olorun Oba o!…

Na dat time I hear person tap me for shoulder say, “Baba Bisi, Baba Bisi, why you siddon for chair dey sleep? Wake up, I don come back from market since. I don cook di Efo riro soup and Poundo with Bokoto finish. Wake up and chop.”

So, all dis my move na for dream. Tori Olorun!

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
Me sef don moveOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: PRESSURE, by Seyi Vibez
next post ROMANCE GONE SOUR: My wife poisoned my food, attempted to kill me ‘cos I planned to marry another wife
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Matilda Showbiz

Vacancy: Part-time wife wanted. Na urgent!

September 12, 20260
Matilda Showbiz

ROMANCE GONE SOUR: A co-landlord confessed to me that he had been sleeping with my wife who had told him I was dead

September 12, 20260
Gists

Sensuous American singer and actress Lady Gaga welcomes first child with fiancé

September 12, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Interview

My three children died mysteriously inside Nigerian Army barracks — Father

September 13, 20260
Crime

RED ALERT: Terrorists plot deadly attacks on worship centres, markets

September 13, 20260
Politics

Tinubu, Atiku, Obi can’t take Nigeria to the next level — SDP presidential candidate Adebayo

September 13, 20260
Entertainment

Celebrity boxing: Speed Darlington, Carter Efe set for October 1 showdown

September 13, 20260
Crime

EXPOSED: Inside baby stealing factory where dismembered body parts of children are sold to ritualists

September 13, 20260
Politics

Akpabio, Abbas, Barau, Kalu, 4,860 others jostle for 469 National Assembly seats

September 13, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

My three children died mysteriously inside Nigerian Army barracks — Father

September 13, 2026

RED ALERT: Terrorists plot deadly attacks on worship centres, markets

September 13, 2026

Tinubu, Atiku, Obi can’t take Nigeria to the next level — SDP presidential candidate Adebayo

September 13, 2026

Celebrity boxing: Speed Darlington, Carter Efe set for October 1 showdown

September 13, 2026

EXPOSED: Inside baby stealing factory where dismembered body parts of children are sold to ritualists

September 13, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

My three children died mysteriously inside Nigerian Army barracks — Father

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

TRAGEDY: Gunmen kill National Open University of Nigeria Bursar

September 7, 2026
3

Trade Union Congress rejects health ministry’s ‘No Work, No Pay’ policy

January 14, 2026
4

Hairstyles for the hot weather

December 7, 2024
5

Fuji singer Obesere survives life-threatening surgery

August 31, 2024
6

Biafra veteran: War is not something anyone should pray for

July 6, 2024
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

75-year-old Kogi monarch’s sister, granddaughter burnt to death

January 5, 2024
3

New tax laws take effect from January 1, 2026 – Revenue Service boss Adedeji

June 26, 2025
4

Hamas launches appeal against UK ban

April 10, 2025
5

Nigeria’s Top 10 Songs, with ITTY OKIM •Week 23

June 6, 2026
6

107 private varsities in Nigeria under investigation •FULL LIST

January 10, 2024

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Former Archbishop of Canterbury Justin Welby to deliver lecture at ABU Zaria

January 19, 2026

Why community policing in Nigeria is a scam – Prof

January 3, 2025

Eid-el-Fitr: Police issue safety advisory

March 18, 2026

2027: Why former President Jonathan can’t run

August 24, 2024
Top posts

Categories

  • News5021
  • Politics4691
  • Crime4493
  • International3114
  • Sports2517
  • Business & Economy2313
  • Headlines2244
  • Education1406
  • Matilda Showbiz1016
  • Health902
  • Entertainment835
  • Africa598
  • Religion486
  • Environment376
  • Special278
  • Info Tech249
  • Arts & Culture240
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today212
  • Interview191
  • Opinion154
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade133
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends23
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge2

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact