Skip to content
Monday 26 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Me sef don move

The FrontierThe FrontierJune 7, 2025 2583 Minutes read0

Di kind work wey I do for dis Sallah, I never do am since I start dis my Lagos taxi driver work.

Come see as I dey carry family dem go mosque like water. If I drop one family, anoder family go stop me make I carry dem. No do, no do, I go don carry like 20 family dem go mosque for different place for Ikeja and outside dat yesterday.

And as dem go pray finish, na so I begin carry anoder set of family dem dey go drop for dia house, one by one. E come be like say all of dem jus dey wait for me.

SDP Poster Layout

My broder make I no lie, my pocket full gan. But na my guonguoro suffer am becos say, dose woman passenger dem na orisirisi nyansh dem carry. Some of dem big pass Dunlop elite sef, sote wen dem enter my guonguoro, my guonguoro go nearly faint. But, shebi na money I dey find.

Na im make I quick close dat yesterday, go our house wey dey for Abule Egba. My wife Bose, and my two woman pikin dem – Bisi and Funke – shock as I come back house before 7 O’clock pm in di evening.

I jus pack my guonguoro, enter house, open my shokoto trouser pocket, bring out money give Bose say make e take go buy tings for market come cook better Efo riro soup and Poundo with Bokoto for di family, say after all na holiday all of us dey.

As I say make I run go wee wee for bafroom, come see long queue. E come be like say na all di tenant dem for Baba Braimoh face-me-I-face-you house wan enter bafroom di same time. Una kukuma know say, na public holiday, so everybody complete for house.

I no fit join di queue, I jus face one corner like dat near di bafroom wey dey for outside di main house, bring out my kini and wee wee. After all, I no be woman.

I go back to our room, siddon for chair to rest small make Bose come back come cook make I eat night food, di only ting wey dey for my mind dat time na make I move…

Ahmed jus drive im long truck enter our compound. As e clear di truck and park for one corner, I tell my family oya o, make we begin pack all our load put for di truck. Say we must move.

My second woman pikin, Funke wey im mouth dey always sharp, ask me say “Daddy, move go wia?”

I tell am say we dey go new house, say I don tire for dis Baba Braimoh face-me-I-face-you house wey I don dey live with dia Mama even before dem born. I come tell Funke say, if e no wan move with me, no wahala, but na im be say e no wan be my pikin again.

Na so we pack everyting put for di truck. I carry my family for my guonguoro and tell Ahmed to drive im truck follow me for back.

We drive enter our new house, mehnnn, come see fine house!

Di ting be like Palace – 3-bedroom flat, 4 toilet/bafroom for inside house, tiles everywhere!

I come talk am for my mind say, so na me and my family go now live for dis kind Palace? No more Baba Braimoh face-me-I-face-you house wahala. No more queue to wee wee, shit or baf. No more general kitchen, etc etc. Olorun Oba o!…

Na dat time I hear person tap me for shoulder say, “Baba Bisi, Baba Bisi, why you siddon for chair dey sleep? Wake up, I don come back from market since. I don cook di Efo riro soup and Poundo with Bokoto finish. Wake up and chop.”

So, all dis my move na for dream. Tori Olorun!

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
Me sef don moveOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: PRESSURE, by Seyi Vibez
next post ROMANCE GONE SOUR: My wife poisoned my food, attempted to kill me ‘cos I planned to marry another wife
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Abuja Afrojazz Festival targets global opportunities for Nigerian musicians

October 24, 20260
Gists

Fela lives on in Kwara as state celebrates his life, legacies

October 24, 20260
Gists

BBNaija should take a break, re-strategise — Reality TV star Tacha

October 24, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

ARISE Projects Impact

February 9, 20250
Crime

Man remanded for allegedly impersonating Kwankwasiyya praise singer

October 26, 20260
Crime

Insecurity: Stakeholders urge state assemblies to fast-track state police legislation

October 26, 20260
Politics

2027: APC accuses ADC of owing staff over one year’s salaries

October 26, 20260
Crime

FBI arrests nine in Nigeria over cyber crime, seizes 53 electronic devices

October 26, 20260
Sports

Man Utd crisis deepens as Carrick faces axe

October 26, 20260
Crime

Ondo Assembly passes State Police bill

October 26, 20260
Load more

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

Man remanded for allegedly impersonating Kwankwasiyya praise singer

October 26, 2026

Insecurity: Stakeholders urge state assemblies to fast-track state police legislation

October 26, 2026

2027: APC accuses ADC of owing staff over one year’s salaries

October 26, 2026

FBI arrests nine in Nigeria over cyber crime, seizes 53 electronic devices

October 26, 2026

Man Utd crisis deepens as Carrick faces axe

October 26, 2026

ARISE Projects Impact

0 Comments

Man remanded for allegedly impersonating Kwankwasiyya praise singer

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

Native doctor with automatic pump-action guns in Police net

June 24, 2025
3

FG pays second tranche of wage award arrears to workers

August 8, 2025
4

Guinea doing everything to hold elections in December — PM

May 13, 2025
5

Ambrose Alli University Ekpoma debunks financial impropriety allegations

November 5, 2024
6

Former Governor El-Rufai is confused, says APC

August 4, 2025
Popular
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

INEC official abducted in Bayelsa, result sheets missing in boat accident

November 11, 2023
3

Tinubu decorates service chiefs with new ranks

October 30, 2025
4

Man Utd close in on free transfer

May 1, 2025
5

EFCC opposes ex-CBN Governor Emefiele’s quest for foreign medical trip

July 9, 2024
6

FBI arrests nine in Nigeria over cyber crime, seizes 53 electronic devices

October 26, 2026

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

Petrol price hits N1,350 as Dangote, marketers fight deepens

September 1, 2026

Many feared dead as 8-storey building collapses in Kenya

October 21, 2024

BREAKING: JAMB releases 2026 UTME mop-up results, begins candidate ranking

June 16, 2026

Adams named new US captain to 2030 World Cup

October 3, 2026
Top posts

Categories

  • News5185
  • Politics4910
  • Crime4663
  • International3256
  • Sports2618
  • Business & Economy2390
  • Headlines2298
  • Education1456
  • Matilda Showbiz1062
  • Health971
  • Entertainment894
  • Africa622
  • Religion504
  • Environment406
  • Special279
  • Info Tech268
  • Arts & Culture245
  • Inside Akwa Ibom Today237
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview200
  • Opinion159
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade139
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact