Skip to content
Tuesday 13 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

I wan begin do dry fasting

The FrontierThe FrontierOctober 10, 2026 282 Minutes read0

Di kind orisirisi tings wey man pikin dey see for dis our taxi driver work, person no fit talk am finish.

Di order day, trailer nearly push me, my guonguoro and my passenger inside Lagos Lagoon. Helep me say Olorun maje!

Na so I carry one madam like dat for drop go Balogun market. We take Alapere, pass Oworonshoki, den climb IBB Bridge.

SDP Poster Layout

We never reach half di bridge wen I hear pppoooaasrrrhhh!!! Na so my steering begin carry me go left, right and center of the bridge, on top speed o. My front tyre don burst be dat. Tori Olorun!

Una kukuma know as plenty motor dey fly for dat bridge. My passenger shout. E begin speak in tongues. E come dey shout Fire! Fire!! Fire!!!

I say madam calm down, na ordinary tyre burst, no be anoder ting. Di madam no hear me o, na so e dey hala prayer, e come dey shout say, “Driver stop! Stop!! Stop!!! I no mind am. I jus manage until di guonguoro slow down and stop. I clear am comot for road, park for sidewalk.

Di madam come dey rush to open di door of di back seat wey e siddon, di door no gree open. I tell am make e take am easy, say I go come down and open di door for am.

I open my driver door, but my broda, to come down come be wahala.

Na so I come dey struggle to come down, na lie. My belle no gree me. Na so my belle hook for steering wheel. Come see as plenty motor jus dey fly pass us sote one trailer nearly hit us for back. Olorun Oba o!

Las las, I manage come down, turn go open door for di madam make e come down make I change di tyre.

When I change tyre finish, I carry di madam go drop for Balogun market.

Wen I dey come back for road, I talk am for my mind say I must do somtin about dis my belle wey don big like woman wey get 8 month belle.

My wife Bose na im first tell me last week say my belle don too big. All our union member dem for our garage wey dey near Ikeja Under Bridge, don dey tell me di same ting. Everybody don talk am.

I no come know weda or wedan’t na My Usual wey I dey nack for Madam Shine buka every night wen I close, plus Point-and-Kill and Nkwobi, na di three both of dem come shoot my belle out for dis Emilokan time wey everybody dey shout “Ebi n pa mi o!”

I don decide say, from tomorrow I go begin do dry fasting. Na di only ting wey go force my big belle inside be dat, make di son of man no come peme before im time.

But di ting be say, as I no dey go church or mosque, I no come know which kind fasting I go do from tomorrow – weda na for our house wey dey for Abule Egba, or for our garage, abi na for road as I dey drive passenger dey go.

But somehow, dia must be dry fasting for dis my belle to go inside. Shey, no be so?

Make we jam again next Saturday.

Tank you,

Tank you very much,

And tank you very very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994

Tags
dry fastingOga MAT
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Nigeria’s Top 10 Songs with ITTY OKIM •Week 41
next post Felabration 2026: Former Femi Kuti backup singer and dancer Emee Freda returns to Shrine with new artistic identity
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gossips

My wife knew I dated actresses, yet didn’t fight them – Yoruba actor Yinka Quadri

October 10, 20260
Gists

Fame hasn’t changed my sense of humour — Nigeria’s songbird Ugoccie

October 10, 20260
Gists

Felabration 2026: Former Femi Kuti backup singer and dancer Emee Freda returns to Shrine with new artistic identity

October 10, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Environment

Military plane crash: Residents lament foul odour, fear disease outbreak as body parts float on community river

October 13, 20260
Headlines

How to check your name, home address on Nigeria’s new postcode system

October 13, 20260
Business & Economy

13% derivation not enough for oil-producing states – Former President Obasanjo

October 13, 20260
Health

Lassa fever spreads across 119 LGAs as death toll hits 268 in 24 states

October 13, 20260
Education

JUST IN: Two Nigerian universities sanctioned over honorary degrees

October 13, 20260
Crime

Alleged defamation: Labour Party Lagos governorship candidate demands dignified justice as court adjourns musician Rolex Dee’s case

October 13, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Military plane crash: Residents lament foul odour, fear disease outbreak as body parts float on community river

October 13, 2026

How to check your name, home address on Nigeria’s new postcode system

October 13, 2026

13% derivation not enough for oil-producing states – Former President Obasanjo

October 13, 2026

Lassa fever spreads across 119 LGAs as death toll hits 268 in 24 states

October 13, 2026

JUST IN: Two Nigerian universities sanctioned over honorary degrees

October 13, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Military plane crash: Residents lament foul odour, fear disease outbreak as body parts float on community river

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Alleged ₦1.3 billion fraud: EFCC arraigns P-Square’s ex-Manager Jude Okoye

February 26, 2025
3

Lagos seals church, hotels, businesses over noise pollution, other violations

September 23, 2026
4

Tinubu jets out to France, UK on vacation

September 4, 2025
5

Nigeria failing because someone transferred Lagos template to Abuja – Dele Momodu

July 23, 2024
6

Universities approved to run law programmes in Nigeria •FULL LIST

March 13, 2026
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Governor Zulum, minister, others in Chad to repatriate 7,790 refugees

February 6, 2025
3

Atiku to Tinubu: Declare emergency on security •Says attacks on schools may cripple education, national development

June 11, 2026
4

2027 elections: Youthful activist, Abayomi Mighty eyes presidential ticket in ADC, targets January 2026 declaration

December 24, 2025
5

Ramadan: Muslims warned against online immorality, neglect of Zakat

February 12, 2026
6

Autonomy: Senate asks state, local govts to comply with Supreme Court judgement

October 9, 2024

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

JAPA: 6 tips for Nigerians to boost their chances of securing US visa

April 15, 2024

Governor Alia distances self from Peter Obi’s visit to Benue

April 14, 2025

2024 budget: Questions over 25% capital component performance

January 11, 2025

Reps probe Customs over smuggling, brutality allegations

December 11, 2024
Top posts

Categories

  • News5140
  • Politics4841
  • Crime4604
  • International3211
  • Sports2583
  • Business & Economy2373
  • Headlines2283
  • Education1447
  • Matilda Showbiz1047
  • Health938
  • Entertainment882
  • Africa615
  • Religion498
  • Environment398
  • Special279
  • Info Tech261
  • Arts & Culture243
  • Inside Akwa Ibom Today231
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview196
  • Opinion158
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade137
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact