Anyting wey person see for dis world make e take am say na so Eledumare wan make e happen. Yes nah.
Person fit dey down today, tomorrow sometin go happen wey go make di person position change, di person go upgrade. Na after later di person go come know say, if dat ting, wey im tink say na bad ting teletele, no been happen, di person for remain for one place.
Di order day, I go drop one passenger like dat for Apapa Wharf, wen I come back for our garage wey dey near Ikeja under bridge, na im my head begin nack pom pom pom, like say dem use hammer nack am.
I look time, na 2 O’clock pm in di afternoon. Na im I say make I go house go rest small, say no be only me dey find money for Lagos. And body no be wood.
Quick, quick, I enter my guonguoro, begin face Abule Egba wey I dey live with my family.
My wife Bose and my two woman pikin dem – Bisi and Funke – shock wen dem see me for house by dat time. Me wey be say, everyday, 10 O’clock pm in di night, I never reach house.
I jus tell my family say e get as my body dey do me dat afternoon, say I come house make I rest small.
I go baf, den chop di food wey my wife give me, and enter bed stret.
My broda, I no even close my second eye wen I begin hear one shout like dat for loudspeaker for inside dat our compound.
(To be continued)
Make we jam again next Saturday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.


