Skip to content
Sunday 25 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Iran war don bring new sense come our garage

The FrontierThe FrontierApril 11, 2026 1472 Minutes read0

If dis our Naija no kill man pikin, man pikin go kill Naija.

Everyting don turn upside down for our contry. Light no dey as national grid dey collapse per second, per second. Money no dey, food no dey. And di one wey worry me pass na petrol. To buy petrol now na like gold.

Today, dem go say Dangote don reduce petrol price, tomorrow dem go say Dangote don increase petrol price.

SDP Poster Layout

And now, dem don kukuma put di hole petrol matter for Iran war head. Dem say na Strait of Hormuz or wetin dem call am sef, no allow petrol reach Naija again. See me, see troublem o, wetin concern Iran with Naija?

And without petrol, na im be say we taxi driver no get work again be dat. Shey, na pure water we go dey use drive our taxi?

Everyday, na so we go siddon for our garage wey dey near Ikeja Under Bridge, from morning till night, no passenger go show face. People no get money to enter taxi again. Tori Olorun!

Na so I siddon yesterday for garage dey tink ti-ti-ti-ti. 12 O’clock pm in di afternoon don nack, no passenger. 1 O’clock, 2 O’clock, di same ting. Kilode?

I talk am for my mind say, if I close for evening begin go our house for Abule Egba, wetin my family go chop? And na weekend we dey.

Na im I quick, quick, use my head do arithmetic. I enter my guonguoro, drive am go di order side of di under bridge wey danfo dem dey load passenger go Maryland. Na so I stop, come out, open all my door down. Agbero dem for bus stop come dey hail me, “Oga MAT wetin happen o! Why you comot for taxi park come join danfo dem for bus stop? Twale!!!”

I ask dem weda dem no see as Naija be now. I say passenger dem no dey near our garage again from morning till night. I tell di agbero dem to begin load my guonguoro, di same money wey danfo dey collect to Maryland. I give di four both of dem N1000.

Before I open eye sef, my guonguoro don full – two passenger for front, five for backseat. Dem even ask weda make dem put passenger for inside boot or on top of my guonguoro roof. Olorun Oba o!

I don carry my passenger dem dey go be dat. One passenger drop for Police College, one drop for Ikeja Country Club junction, two drop for Abule bus stop, one drop for Leventis. And as dem dey drop, na so I dey carry anoder passenger like danfo.

Everybody come down for Maryland. Na so I turn my guonguoro face Ikeja, begin call passenger dem again.

My broda, as I reach our garage, my pocket don full. I jus use style begin go Madam Shine buka to take My Usual before I go house.

Man pikin no go come peme for dis Naija becos of petrol say or petrol no say. Iran war don bring new sense. Cunny man peme, cunny man bury am.

I know say if I tell our union member dem dis new sense, all of dem go begin dey do di same ting. But no be now I go tell dem, make dem no takeover di new sense from me.

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

 

Tags
garageIran warnew sense
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Continued terrorist attacks on innocent citizens threaten Nigeria’s stability – Former Vice President Atiku warns
next post ROMANCE GONE SOUR: I landed in hospital after my wife grabbed, pulled my scrotum during a fight
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Abuja Afrojazz Festival targets global opportunities for Nigerian musicians

October 24, 20260
Gists

Fela lives on in Kwara as state celebrates his life, legacies

October 24, 20260
Gists

BBNaija should take a break, re-strategise — Reality TV star Tacha

October 24, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

ARISE Projects Impact

February 9, 20250
Interview

My wife died chasing nine-month retirement benefits – Retiree

October 25, 20260
Politics

ADC mocks APC over rented crowds, empty seats at Kaduna rally

October 25, 20260
International

Trump votes early in Florida for US midterm elections

October 25, 20260
Business & Economy

Shoprite set to open neighbourhood stores after shutdown

October 25, 20260
Health

Infertility: Experts seek comprehensive law on IVF, surrogacy, egg donation

October 25, 20260
Politics

Opposition parties slam APC’s Kaduna rally, accuse Tinubu of recycling promises

October 25, 20260
Load more

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

My wife died chasing nine-month retirement benefits – Retiree

October 25, 2026

ADC mocks APC over rented crowds, empty seats at Kaduna rally

October 25, 2026

Trump votes early in Florida for US midterm elections

October 25, 2026

Shoprite set to open neighbourhood stores after shutdown

October 25, 2026

Infertility: Experts seek comprehensive law on IVF, surrogacy, egg donation

October 25, 2026

ARISE Projects Impact

0 Comments

My wife died chasing nine-month retirement benefits – Retiree

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

I remain SDP chairman, says Gabam

October 24, 2025
3

Nigeria moving backwards under Tinubu, says former Governor El-Rufai

April 16, 2025
4

Cameroon election: Opposition leader, Bakary, makes early gains in President Biya’s strongholds

October 13, 2025
5

Governor declares 3-day mourning for late Ondo SSG

January 6, 2025
6

NNPC trucks storm Dangote Refinery to commence lifting of petrol

September 15, 2024
Popular
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

Nigeria is bleeding – Governor Fintiri tells Tinubu

January 31, 2025
3

High fuel prices: Trade Union Congress proposes production subsidy for Dangote Refinery, others

May 9, 2026
4

Suspended Senator Ningi to Akpabio: Neither you nor me can control the can of worms I’ve opened

March 14, 2024
5

JUST IN: Tinubu decorates Disu as acting IGP at Presidential Villa

February 25, 2026
6

#AnambraDecide2025: Voting yet to start in Nnewi LG community, voters stranded

November 8, 2025

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

Badejo appointed new LASU Vice Chancellor

September 10, 2026

ATM usage drops as POS agents handle N223 trillion

June 23, 2025

2027: Governor Makinde’s campaign mocks Tinubu’s team as ‘coalition of failed politicians’

October 14, 2026

2027: Tinubu will have nothing less than 65% of total votes cast — House of Reps member Jibrin •VIDEO

September 17, 2026
Top posts

Categories

  • News5182
  • Politics4905
  • Crime4657
  • International3253
  • Sports2613
  • Business & Economy2388
  • Headlines2298
  • Education1456
  • Matilda Showbiz1062
  • Health968
  • Entertainment894
  • Africa621
  • Religion504
  • Environment405
  • Special279
  • Info Tech268
  • Arts & Culture245
  • Inside Akwa Ibom Today236
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview200
  • Opinion159
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade138
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact