Skip to content
Thursday 29 October 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

My pikin wan marry oyibo

The FrontierThe FrontierAugust 15, 2026 913 Minutes read0

Replay

I dey always talk am say, na Funke tear eye pass di two woman pikin dem wey my wife Bose born for me. Di senior sister Bisi na gentle pikin but im sister Funke na inwi. Im gragra two much.

Na so Funke begin dey follow one Fulani herdsman like dat wey dey carry cow waka for all di street and bush for our area Abule Egba. Na im senior sister report am to me. Wen I ask Funke wetin im and di Aboki get in comon, e tell me say, “Nothing, he is just a friend, Daddy.”

SDP Poster Layout

A friend with Fulani herdsman? Dis my second woman pikin no go kill me o. Tori Olorun!

We never talk dat one finish, on Monday dis week, Funke say e wan bring man wey e wan marry come show me and im Mama. I ask am weda e don reach to marry wen be say im senior sister dey plan to enter uniservity.

Funke tell me say na im sister own be dat, say e ready to marry, and na oyibo e wan marry.

Ehn? Oyibo? For wia my pikin see oyibo wey e wan marry?

But make I no lie, di ting sweet me for mind gan say my pikin wan marry oyibo. I come talk am for my mind say, so, me sef go begin dey count my money in dollar. Olorun Oba o!

| ask Funke which day e wan bring di oyibo come house make we see am. E say Friday (wey be yesterday). I say no troublem, say I go give im Mama money make e use cook better point-and-kill and I go buy correct wine to take welcome our oyibo son in-law.

Yesterday, I no go work, I park my guonguoro for our compound for Abule Egba. I no just reach our garage wey dey near Ikeja Under Bridge. All of us dey wait for oyibo to come.

I look time, 11 O’clock a.m. in di morning don nack. I ask Funke weda im oyibo husband no go come again. Funke tell me say oyibo dey come for road, say e don nearly reach our house sef.

Small time I hear okada sound pruumm, pruumm, pruumm for outside. Funke run come tell me say im oyibo husband-to-be don land. I tell am make e bring am inside quick quick, make e no allow my oyibo son in-law wait for outside for too long.

Wen Funke bring oyibo inside, my broda, I shock, I nearly faint!

I ask Wasiu wey we dey call oyibo for garage wetin e dey find for my house. Wasiu say na im wan marry my second woman pikin Funke. I ask am, you? E say yes nah. Tori Olorun!

See me see wahala o. So, my pikin don look all di man dem wey dey for dis world finish, na Wasiu e wan marry. Afin wey im eye be half past four. Afin wey be agbero wey dey load passenger motor for lpodo. Afin wey to smoke igbo upandan be im own, na im my pikin wan marry?

As I rush enter room, before I come out, Afin don disappear. E know wetin I want bring come. I for use my sharp matchet cut dat im red head comot dat yesterday. Aswe! Oyibo ko, Oyingbo market ni.

Make we jam again next Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994*

 

 

Tags
marryMy pikinOga MAToyibo
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot Lyrics: ICE CREAM, By Mavo
next post ROMANCE GONE SOUR: My wife was disowned by our children for using nose ring, ankle chain, doing TikTok with her lover
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Gists

Abuja Afrojazz Festival targets global opportunities for Nigerian musicians

October 24, 20260
Gists

Fela lives on in Kwara as state celebrates his life, legacies

October 24, 20260
Gists

BBNaija should take a break, re-strategise — Reality TV star Tacha

October 24, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

ARISE Projects Impact

February 9, 20250
Info Tech

Poor network: Reps threaten arrest warrants for telecom CEOs

October 28, 20260
Politics

NDC alleges harassment, destruction of campaign materials in Edo

October 28, 20260
Politics

APC releases supplementary list for Tinubu’s 2027 campaign council

October 28, 20260
Politics

We’ll rig those who rig 2027 elections – Peter Obi

October 28, 20260
News

Work on Lagos-Calabar Coastal Highway grounded as 600 workers go on strike

October 28, 20260
Education

University admission: House of Reps seeks more time for candidates as deadline nears

October 28, 20260
Load more

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

Poor network: Reps threaten arrest warrants for telecom CEOs

October 28, 2026

NDC alleges harassment, destruction of campaign materials in Edo

October 28, 2026

APC releases supplementary list for Tinubu’s 2027 campaign council

October 28, 2026

We’ll rig those who rig 2027 elections – Peter Obi

October 28, 2026

Work on Lagos-Calabar Coastal Highway grounded as 600 workers go on strike

October 28, 2026

ARISE Projects Impact

0 Comments

Poor network: Reps threaten arrest warrants for telecom CEOs

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

Meet astronauts stranded in space until 2025 •PHOTOS

September 18, 2024
3

Arsenal face revamped Man United, Liverpool battle Bournemouth •FULL EPL FIXTURES

August 15, 2025
4

Gunmen hijack train conveying 450 passengers •155 rescued

March 12, 2025
5

Another batch of Nigerians to be evacuated from South Africa next week – Association

August 22, 2026
6

Alleged coup plot: Activist Sowore, wives of detained military officers protest in Abuja

March 6, 2026
Popular
1

ARISE Projects Impact

February 9, 2025
2

Hardship: Lagos PDP guber candidate Jandor knocks Tinubu

March 11, 2024
3

I’m pleased with my shouting match with Senator Nwebonyi – Former Minister Ezekwesili

March 26, 2025
4

Judiciary should not determine winners of elections – Falana

October 28, 2023
5

Iheanacho scores late penalty as Celtic go top

September 15, 2025
6

2027: We have no partnership deal with APC — Labour Party

November 22, 2024

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

ARISE Projects Impact

February 9, 2025

Money laundering charges against Bobrisky were dropped lawfully – EFCC

October 1, 2024

Lagos silent on school probe months after teacher sodomised pupil

December 27, 2024

War without end: Senate President Akpabio sues Senator Natasha for ₦200 billion over sexual harassment

December 6, 2025

Nigeria’s defence chief, Musa signs MoU on security cooperation with Nigerien counterpart

August 29, 2024
Top posts

Categories

  • News5198
  • Politics4925
  • Crime4671
  • International3262
  • Sports2622
  • Business & Economy2394
  • Headlines2301
  • Education1459
  • Matilda Showbiz1062
  • Health975
  • Entertainment898
  • Africa623
  • Religion504
  • Environment408
  • Special279
  • Info Tech270
  • Arts & Culture245
  • Inside Akwa Ibom Today239
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Interview200
  • Opinion159
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade139
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends25
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge4

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact