…Continued from last week’s episode
As I jus drive enter our garage, I see say everybody complete. I look time, e remain 20 minute make 4 nack.
Small time, I see one pelenge man enter garage, go meet our union chairman Jimoh.
Jimoh say make all of us come, say our union exco member for state chapter don come. Na im all our union member dem come siddon for di meeting.
I see say Jimoh no tell me wey be Akowe to siddon for high table for di meeting, e no tell Idowu wey be Treasurer, and Akpan wey be Social Organiser. Na only im and di pelenge man dey for high table.
Di next ting be say, Jimoh introduce di pelenge man. E say di man na former ex-officio for state chapter of our union, say e don retire.
Jimoh no introduce we wey be exco for our own branch, e no also tell us di pelenge man name. All of us jus dey look oursef, nobody talk.
Jimoh talk say di pelenge man get special message wey e bring come for us.
Na so di pelenge man jump up. E clear im troat. E come resemble person wey never chop since last week.
Di pelenge man come greet us good morning. I look time, 4.30 o’clock pm in di evening don nack. I talk am for my mind say today na today. Idowu, our union treasurer, nearly laugh out.
(To be continued)
Make we jam again next week.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.


