Skip to content
Monday 14 September 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Oga MAT: I no get time for Lagos sisi dem dis new year

The FrontierThe FrontierJanuary 6, 2024 4114 Minutes read0

Una kukuma remember say, as Keresimasi near last year, na so all dose Lagos sisi dem dey come dey rush me make I do Keresimasi for dem.

Even all di sisi wey no dey greet me for our street for Abule Egba, if dem see me dat time, dem go first smile, den dobale, and begin greet me, “Daddy Bisi, good morning sir. Well don sir. Shey work dey go on fine sir? Happy Keresimasi and merry New Year in advance sir.”

For our garage nko? Abosede come, di mobile buka girl wey dey carry Ewa Agoyin for head waka come sell for our garage wey dey near Ikeja under bridge. I tink say na market Abosede come sell o, I no know say e come tell me make I no forgot am for Keresimasi.

Jumoke, wey dey bring Monkeytail come sell for our union member dem like Mutiu, come ask me for di ting wey I go give am for Keresimasi.

Aisha wey dey come sell hot Agbo for our garage, also do di same ting.

Di one wey shock me pass na wen I don go drop my passenger for Idumota around 12 O’clock pm in di afternoon, come back say make I rest small for garage, na im one woman waka enter garage.

Wen I look di woman ti-ti-ti-ti, I see say na Madam Shine, di woman wey get di joint wey Sikiratu dey work and wey I dey go take My Usual for evening after work. But since wey Sikiratu travel go village for dat odun, I no go Madam Shine buka. Na anoder joint I dey go nack My Usual before I begin go house.

I ask Madam Shine wetin happen wey make am come our garage for di first time. Di woman say e jus say make e come greet me.

Madam Shine begin ask me why e no see me since. I tell am say na work. E say na lie. E say na becos Sikiratu travel go village to do Keresimasi with im one-eye mama. Di next ting be say, Madam Shine ask me wetin I go take do Keresimasi for am.

I talk am for my mind say shiooo! Shey, na me dem born for Keresimasi?

My broda, na so I took off o, I no show face again for our garage since dat Keresimasi. I know say dem go don go find me tire. For wia! Me wey don go pack my guonguoro for our house for Abule Egba!

Na yesterday I say make I show face again for our garage since dat Keresimasi.

All our union member dem happy to meet again since last year. But some never come back sha. Emeka, Akpan and Mutiu still dey for dia village, I no know wetin dey hold dem, weda dem no see money pay transport come back Lagos, even after Baba don talk say e go pay half of dia transport money for dem.

But we wey remain for Lagos happy to meet again, no be small. Our union Chairman Jimoh, our Treasurer Idowu and me Oga MAT wey be Akowe, our own na no leave, no transfer. Na we be di original Lagosians!

Na so di three both of us come dey pray for oursef dat yesterday for garage. Everybody come dey talk im new year re…reso…resolu…resolut… Abeg, una know wetin I wan talk, make I no come bite my tongue becos of oyibo. Wetin I mean na new year swear.

Jimoh say e no go marry anoder wife join di 8 wey e get. Idowu say e no go nack any sisi again dis year, as e be say any sisi wey e jus meet small must carry belle and born twins, and na so e don get pikin every corner for Lagos.

My own swear be say, dis year o, if any sisi like make e turn im head upside down, na only my wife Bose, di mama of my two woman pikin dem – Bisi and Funke – I know. Any order woman na fake like all dose university and Prof dem cerfiticate.

Wen I swear like dat, Jimoh and Idowu begin laugh. I ask dem wetin make dem laugh, na im Idowu ask me weda or wedant I no wan Sikiratu again.

If you see di kind eye wey I take look Idowu, hmm, if small pikin see my face dat time, e must to get confulsion.

I know say all of dem for dat our garage don dey target Sikiratu, dem dey pray make me and my Siki Babe no dey again so dat dem go rush am. But Eledumare no go answer dat dia wicked prayer. Helep me say Amin!

Make we jam again on Saturday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT is the longest running Pidgin column in Nigerian media, since 1994.

Tags
LagosnewOga MATsisitimeyear
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Hot lyrics: OLUCHI, by Carterefe ft. Berri Tiga & Skiibii
next post ROMANCE GONE SOUR: I discovered that my husband has 4 other children after we got married
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Matilda Showbiz

Vacancy: Part-time wife wanted. Na urgent!

September 12, 20260
Matilda Showbiz

ROMANCE GONE SOUR: A co-landlord confessed to me that he had been sleeping with my wife who had told him I was dead

September 12, 20260
Gists

Sensuous American singer and actress Lady Gaga welcomes first child with fiancé

September 12, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Politics

Actor-turned-politician Desmond Elliot under fire for kneeling to beg Tinubu’s chief of staff Gbajabiamila for forgiveness •VIDEO

September 14, 20260
Crime

TRAGIC: Many travellers killed as gunmen open fire on passenger bus

September 14, 20260
Business & Economy

Cost of living crisis in Nigeria deepens as fuel prices hit record highs

September 14, 20260
Politics

Labour Party disowns sacked member Arabambi, denies link to Peter Obi credentials suit

September 14, 20260
Business & Economy

JUST IN: Dangote Refinery opens N2.15 trillion IPO, offers Nigerians stake in plant

September 14, 20260
Politics

2027 elections: ADC, NDC fail to field candidates in all Senate, House of Reps seats

September 14, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Actor-turned-politician Desmond Elliot under fire for kneeling to beg Tinubu’s chief of staff Gbajabiamila for forgiveness •VIDEO

September 14, 2026

TRAGIC: Many travellers killed as gunmen open fire on passenger bus

September 14, 2026

Cost of living crisis in Nigeria deepens as fuel prices hit record highs

September 14, 2026

Labour Party disowns sacked member Arabambi, denies link to Peter Obi credentials suit

September 14, 2026

JUST IN: Dangote Refinery opens N2.15 trillion IPO, offers Nigerians stake in plant

September 14, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

Actor-turned-politician Desmond Elliot under fire for kneeling to beg Tinubu’s chief of staff Gbajabiamila for forgiveness •VIDEO

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Trump agrees to small reduction in Philippine tariffs

July 23, 2025
3

18 senior Army officers retire after 35 years of service

March 27, 2026
4

US suspends immigrant visa processing for Nigeria, others

January 14, 2026
5

Vinicius scores as Real Madrid beat Benfica to reach Champions League last 16

February 26, 2026
6

Trump calls for jailing of Chicago mayor, Illinois governor

October 8, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

Lagos extends rail service time for ‘The Experience 2025’

December 4, 2025
3

Psquare: Peter Okoye celebrates twin brother on 43rd birthday amid online feud

November 18, 2024
4

I wanted to be a pilot before acting found me — Popular comedian Saka

September 12, 2026
5

TRAGEDY: 5 children suffocate inside abandoned car •Bodies found after 5 hours

April 22, 2024
6

REVEALED: Real reason my marriage packed up – Nollywood A-list actor, Jim Iyke

October 28, 2023

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Nigerian non-oil export in the hand of foreigners – Exporters lament

December 16, 2023

JUST IN: Police begin full enforcement of tinted glass permit nationwide

October 1, 2025

Planned nationwide protest: Presidency, Peter Obi trade words

July 21, 2024

Epistles of Anthony Kila: BettaGate: A mirror beyond Betta Edu

January 12, 2024
Top posts

Categories

  • News5023
  • Politics4697
  • Crime4496
  • International3114
  • Sports2520
  • Business & Economy2315
  • Headlines2244
  • Education1407
  • Matilda Showbiz1016
  • Health904
  • Entertainment835
  • Africa600
  • Religion486
  • Environment377
  • Special278
  • Info Tech249
  • Arts & Culture240
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today213
  • Interview191
  • Opinion154
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade134
  • World Cup 202695
  • Advert36
  • Trends23
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Local News5
  • The Surge2

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact