Skip to content
Saturday 4 July 2026
  • Home
  • Advertise with us
  • Contact
The Frontier
Click to read
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Headlines
  • Education
  • Health
  • Business & Economy
  • Sports
  • More
    • International
    • Religion
    • Entertainment
    • Info Tech
    • Matilda Showbiz
      • Gists
      • Music
      • Gossips
      • Oga MAT
      • Romance
    • Arts & Culture
    • Environment
    • Opinion
    • Features
    • Epistles of Anthony Kila
    • EyeCare with Dr Priscilia Imade
The Frontier
  • News
  • Crime
  • Politics
  • Religion
  • Headlines
  • Education
  • International
  • Business & Economy
  • Entertainment
  • Sports
  • Arts & Culture
  • Environment
  • Health
  • Matilda Showbiz
    • Gists
    • Music
    • Gossips
    • Oga MAT
    • Romance
  • Opinion
  • Epistles of Anthony Kila
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade
  • Info Tech
  • Interview
The Frontier
Click to read
Matilda Showbiz
Matilda ShowbizOga MAT

Bose don give me permission to marry anoder wife

The FrontierThe FrontierJuly 20, 2024 3372 Minutes read0

Di kind cold wey dey now, if all dis sisi and bobo dem no take time, Naija go reach 2 billion people after nine months.

No be sisi and bobo dem alone, even husband and wife dem dey inside.

Now, to stand up for bed for morning, put my guonguoro for road, na wahala. To baf cold water sef, dat one na no go area. Di kind hot water wey I dey take baf now go even comot feather for fowl body patapata.

For night, wen I close for our garage, I go branch for Madam Shine buka, take My Usual, plus Point-and-Kill, before I begin go our house wey dey for Abule Egba.

Di cold for night na im even wicked pass morning own. E dey be like say person dey for obodo oyibo, wen be say ordinary Cotonu sef man never cross enter before.

Na so cold nearly finish me for night yesterday wen I reach house. I see say everybody don sleep, cover dia body patapata.

My wife Bose dey for bed inside room. My two woman pikin dem – Bisi and Funke – sleep for parlour as usual.

Na so I jump enter bed. I touch Bose small, I see say e don sleep go. And di kind cold wey hammer me dat night na helele.

Bose face wall, I shift my body near am, na so my kini jus tanda like Standard Bank. Tori Olorun!

I touch Bose again, e no shake body. I talk am for my mind say today na today. I touch am again, Bose move body small. I touch am again, na dat time e ask me wetin dey happen, and na with sleep eye e take ask me o.

I tell my wife say cold dey catch me, say I wan make e cover me. Bose ask me weda na im be blanket. E say if cold dey catch me, make I go find wrapper cover my body. My broda, I weak.

I come shake Bose well well, I tell am say e must cover me, say na im be di only wife wey I get.

Bose tell me say abeg make I no disturb am again, make I let am sleep or e go comot for bed go lie down for ground. Olorun Oba o!

And true true, wen I touch Bose again, na so e jump comot go carry mat, put for ground and lie down. So, my wife no wan make we do bend-bend sleep again. Ewo!

(To be continued)

Make we jam again next Saturday.

Tank you,

Tank you very much,

And tank you very very much indeed.

*Created by Sunny Okim, Oga MAT (Day-to-day experiences of a Lagos taxi driver) is the longest running Pidgin column in Nigeria’s media, since 1994.

Tags
BosedongivemarryOga MATpermissionwife
FacebookTwitterWhatsAppLinkedInEmailLink
Previous post Emmy Awards 2024: Nominees in key categories •FULL LIST
next post Dangote rejects claims of monopoly, substandard products at refinery
Related posts
  • Related posts
  • More from author
Matilda Showbiz

Nigeria’s Top 10 Songs with ITTY OKIM •Week 26

June 27, 20260
Gists

Food, music, as Jollof Fest returns to Lagos with new addition

June 27, 20260
Gists

Afrobeats star Rema sets Mawazine Festival stage on fire after World Cup opening ceremony moment

June 27, 20260
Load more
Read also
Inside Akwa Ibom Today

inside the Hill top newspaper

February 9, 20250
Business & Economy

FG inaugurates new Board of Bank of Agriculture

July 4, 20260
Crime

Hidden side of youth whose brutal killing caused tension in Osun

July 4, 20260
Arts & Culture

Oba Of Benin receives 18 repatriated artefacts from Switzerland

July 4, 20260
Politics

IGP Disu meets with Governor Adeleke, stakeholders ahead of Osun governorship election

July 4, 20260
Environment

Gully erosion destroys homes, displaces families in Anambra

July 4, 20260
World Cup 2026

Egypt beat Australia, become second African country to reach World Cup last 16

July 4, 20260
Load more

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

FG inaugurates new Board of Bank of Agriculture

July 4, 2026

Hidden side of youth whose brutal killing caused tension in Osun

July 4, 2026

Oba Of Benin receives 18 repatriated artefacts from Switzerland

July 4, 2026

IGP Disu meets with Governor Adeleke, stakeholders ahead of Osun governorship election

July 4, 2026

Gully erosion destroys homes, displaces families in Anambra

July 4, 2026

inside the Hill top newspaper

0 Comments

FG inaugurates new Board of Bank of Agriculture

0 Comments

5 burnt to death scooping fuel from fallen tanker

0 Comments

Naira slumps further as dollar scarcity bites harder

0 Comments

BREAKING: Appeal Court sacks Senate Minority Leader, orders election rerun

0 Comments

Again, Trump fined $10,000 for violating gag order

0 Comments

Follow us

FacebookLike our page
InstagramFollow us
YoutubeSubscribe to our channel
WhatsappContact us
Latest news
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

EFCC knows how to get ex-Gov Yahaya Bello if it wants to – Bwala

April 19, 2024
3

Senator Goje scolds Senate President Akpabio, warns against unparliamentary behaviour

December 2, 2025
4

NERC transfers full electricity regulatory oversight to 4 states

January 14, 2025
5

FG names 15 terrorism financiers, BDCs, plans sanctions

March 20, 2024
6

Ogun govt shuts firms over workers’ death, injuries

March 6, 2025
Popular
1

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025
2

I’ll put fire in state of any governor that interferes with Rivers PDP — Former Gov Wike threatens

September 1, 2024
3

Illegal fuel depot discovered in Lagos, 5 suspects nabbed

April 4, 2024
4

Tesla to recall nearly 219,000 US vehicles

May 6, 2026
5

2 men nabbed for raping, impregnating 14-year-old girl

March 24, 2024
6

Oil marketers to Tinubu: Complete Port Harcourt refinery to combat fuel scarcity

May 1, 2024

About The Frontier

The Frontier is Nigeria’s leading online newspaper. It is published by Okims Media Links Limited headed by Sunny Okim, a veteran journalist who is widely known as The Grandmaster, fondly called so by colleagues and friends for being Nigeria’s pioneer movie journalist.

Most viewed

inside the Hill top newspaper

February 9, 2025

Man disappears after bathing girlfriend with acid

November 25, 2025

London Mayor Khan wins historic third term

May 5, 2024

Tinubu declares 7 days of mourning for ex-President Buhari

July 14, 2025

SHOCKING: Hardship driving Nigerians crazy as Lagos psychiatric hospital admissions rise by 100%

December 21, 2023
Top posts

Categories

  • News4711
  • Politics4353
  • Crime4143
  • International2872
  • Sports2359
  • Business & Economy2198
  • Headlines2135
  • Education1317
  • Matilda Showbiz936
  • Health833
  • Entertainment772
  • Africa530
  • Religion469
  • Environment342
  • Special267
  • Info Tech231
  • Arts & Culture230
  • Hunger protests in Nigeria224
  • Inside Akwa Ibom Today191
  • Interview180
  • Opinion150
  • EyeCare with Dr Priscilia Imade123
  • World Cup 202639
  • Advert31
  • Epistles of Anthony Kila19
  • Trends18
  • Local News5

© 2026 The Frontier, Published by Okims Media Links Limited.

designed by winnet services

  • Home
  • Advertise with us
  • Contact